Blog sidebar

Background

National

Former SGF, Lawal Pack Load Comot ADC, Say Wuruwuru Dey Di ADC Primary Election

By: Esther Ayoola Former Secretary to di Gornment of DI Federation, Babachir Lawal, don pack im load comot from DI African Democratic Congress (ADC) party. Lawal use his Facebook page on Monday take announce am on Monday say na Aringas naim package di election for di party presidential primary to favour former Vice President Atiku Abubakar. Im scata mouth say di election na pure "wash" because dem change di real […]

todayJune 2, 2026 13

National

Wike Knock Peter Obi, Call Am Jell Off Rice Leader

By: Esther Ayoola FCT Minister Nyesom Wike don criticize former Anambra Govo and former Labour Party presidential candidate, Peter Obi, say leadership need courage and quick decision-making, nor be to dey run from problem, be di way. Wike tuk dis one, while im dey react to how pipo dey see Obi leadership style for TV sit down tuk. According to di senior man minister, say Obi na food is ready […]

todayJune 2, 2026 9

National

Naija Gorment, WIPO Join Hand To Hellep Content Creators

By: Esther Ayoola Naija gornment and di World Intellectual Property Organisation (WIPO) don agree to join hand work together  to hellep creators see money for dia brain work. Vice President Kashim Shettima naim sama dis update for Abuja, when im receive di WIPO team for im office . WIPO Director-General, Daren Tang lead delegation go meet with Shettima and other big gornment officials inside Presidential Villa to settle dis agreement. […]

todayJune 2, 2026 12

south west

Oyo Police Arrest Pastor And Woman Over Fake Bandit Killing Tori

By: Esther Ayoola Oyo State Police Command on Monday for Ibadan arrest two suspects, one pastor and one woman, over acuusate say dem deliberately spread false information say bandits kill six people for Lamini Community, Ido Local Government Area. Police tuk, tuk, DSP Olayinka Ayanlade, naim dey convasate dis mata say di arrest hapun afta thorough investigation wey confirm say di viral WhatsApp voice note and social media post no […]

todayJune 2, 2026 10

south west

Ogun People Come Out Protest Oyo School Kidnap

By: Esther Ayoola Residents for Ogun State don come out for Abeokuta streets do wey nor go gree sake of insecurity and di kidnapping of 39 school children plus seven teachers for Ogbomoso, Oyo State. Di protesters, wey include youths and nursing mothers, carry placards dey demand make gornment act fast to rescue di victims and stop kidnapping, banditry and terrorism. Dem say na children wey nor commit any crime, […]

todayJune 2, 2026 9

Lagos

Kidnap Mata: Oyo Teachers Down Tools, Close Public Schools

By: Esther Ayoola Teachers for Oyo State public primary and secondary schools don begin strike from June 1, 2026, as Naija Union of Teachers (NUT) order all members make dem stop work. Di union say na sake of wetin jaguda boys do to teachers and pupils for oyo state naim make dem dey protest. NUT tuk say di mata don cause fear and panic among teachers and parents across di […]

todayJune 2, 2026 10

Lagos

Tinubu Hail Navy Boys As Dem Take Drive Papi Waters Wey Bi Ole Comot

By: Esther Ayoola Oga Presido Bola Tinubu don hailed di Nigerian Navy say dem carry beta muscle enter water, as dem look piracy eye-to-eye pull am comot and block di tap of crude oil thief-thief. Tinubu yarn dis beta words on Monday for Lagos during di International Fleet Review inside Eko Atlantic Waterfront, to mark di 70 years birthday of di Navy. Baba Seyi salute di navy boys say dia […]

todayJune 2, 2026 8

Lagos

Lagos Police Clear Air For One Ikorodu Video Wey Go Viral Say Na Old Gist

Lagos State Police Command don come out explain di Ikorodu viral video wey bin dey cause jogolo before say na old video. One viral video bin scata soical media dat some fulani men wan bin con kidnap pipo for Ikorodu, police arrest dem. However senior man police commissioner CP Tijani Fatai, explain di marras for Konfam radio on Monday evening dat di video na about 5 years ago and nor […]

todayJune 1, 2026 33

Health

Lagos, Hear Word! Stop Short Put, Dat Open Toilet Business AKA, Open Defecation

Di ancient elders talk say di person wey dey kahkah for road fit forget, but di person wey step on am go always remember. Today wetin we dey see na men, women and childresis dey spoil Lagos gutters and beaches with hot kahkah wey oyinbo dey call open defecation, say e don become heavy weight wey dey spoil our city face and threaten everybody health.   When people drop heavy […]

todayJune 1, 2026 18

obodo oyinbo

America, Iran Exchange Fire Again As Hormuz Tension Dey Rise

By : Jolayemi Olajide   Nor be small high tension wire for di middle east, dat  America and Iran dey test power again  around Strait of Hormuz over the weekend. Normally  di two both country agree ceasefire. According to US Central Command (wey dem call Centcom) dem do self defence  against Iranian military targets after Iran based on dem say dem say, go  shoot down one American drone for international […]

todayJune 1, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds