Blog sidebar

Background

Sports

Ogunlende Say Grassroots Football Dey Open Door for Youth Success for Lagos

By Oluwatosin Ibrahim Lagos State Commissioner for Youth and Social Development, Mobolaji Ogunlende, on Friday for Lagos say grassroots football na di best way to discover talents, create jobs and develop communities through sports. Ogunlende praise di BDFA-RAK League, say di competition don grow from eight teams to over 40 clubs across Badagry Division because of continuous investment in youth development. Di commissioner also say di league don produce professional […]

todayAugust 7, 2026 40

OBODO NAIJA

Sanwo-Olu Say Lagos Need 40,000 Doctors And 40,000 Nurses

By Oluwatosin Ibrahim Lagos State Governor Babajide Sanwo-Olu on Thursday say for Eko Health Convention wey hold for Victoria Island, Lagos, say di state get shortage of 40,000 doctors and 40,000 nurses because di population dey grow fast. Sanwo-Olu also reveal say over 1.5 million residents don join di Ilera Eko health insurance scheme as government dey strengthen healthcare across Lagos. Di governor explain say Lagos need at least extra […]

todayAugust 7, 2026 14

Sports

Real Madrid Splash €140m To Sign Yan Diomande

By: Yusuf Abuh Real Madrid don complete di signing of 19-year-old Ivory Coast winger Yan Diomande from RB Leipzig for deal wey fit reach €140 million, and di youngster don sign seven-year contract. Di tin bin dey be like say village pipo dey follow am for back, last last, di transfer, na BBC Sport report on Thursday say Diomande  don become one of di most expensive players wey Real Madrid […]

todayAugust 7, 2026 21

obodo oyinbo

Trump Say Iran War Fit End Soon As Talks Continue Over Hormuz

By: Yusuf Abuh US Presido Donald Trump don say e believe di war with Iran go end “pretty soon”, say dem nor born Iran well to continue di fighting. US, Iran and Oman dey try  reach temporary agreement wey go allow ships return through di Strait of Hormuz, one important route for global oil supply. Like dis now, Iranian authorities don increase security measures across di country, especially for Tehran. […]

todayAugust 7, 2026 18

Lagos

FG, Lagos Join Forces To Fight Flood, Improve Water Supply

By: Yusuf Abuh Federal Gornment and Lagos State Gornment don renew dia collabo doings, dis time around say na  flooding dem wan rascal, to  improve water management and strengthen sanitation services for residents. Minister of Water Resources and Sanitation, Prof. Joseph Utsev, naim sorosoke dis mata as im ma go visit Lagos Govo, Babajide Sanwo-Olu, for Lagos on Thursday, where e promise more federal support for flood control and water […]

todayAugust 7, 2026 13

obodo oyinbo

Trump Deny US Weapon Shortage, Threaten Leakers with Jail

By: Esther Daniel US Presido Donald Trump on Thursday deny reports say America weapon stock don finish after military operations linked to Iran, insist say di kountry still get plenty munitions and factories dey produce more. Trump, for im Truth Social post, say fresh weapons dey continue arrive as needed and defence companies dey expand production across di United States. Di US Presido accuse people wey leak di reports of […]

todayAugust 6, 2026 17 2

Politics

Tinubu Order EFCC Make Dem Unfreeze Osun Gornment Account

By: Esther Daniel Oga presido Bola Tinubu on Thursday direct EFCC make dem immediately return to court and cancel di order wey freeze Osun State Gornment account, after di action cause public criticism ahead of di August 15 gofnorship election. Tinubu, through im spokesman Bayo Onanuga, say although EFCC get power to do investigations, di timing of di account freeze embarrass am because people fit see am as political interference. […]

todayAugust 6, 2026 21

south west

 Police Catch Woman Over N42m Visa Scam Wahala

By: Jolayemi Olajide   Ondo State Police don grab one 33-year-old woman, Adejoke Ayomide, over alleged visa scam wey make over 90 people lose N42.3 million. Police yarn say dem arrest di woman on Wednesday after victims report di matter through law firm wey represent dem and demand justice. According to police, di suspect dey pose as travel agent, promising people visa to Spain, Portugal and France but allegedly collect […]

todayAugust 6, 2026 13

Sport Yarns

Shooting Stars Striker Ayodele Set to Dump NPFL for Egypt Move

By: Jolayemi Olajide   Shooting Stars striker Ismail Ayodele dey close to leaving di Nigeria Premier Football League side after Egyptian club Modern Sports SC reach agreement to sign am. Reports say di player don agree personal terms with di Egyptian team and e go travel go Northern Africa to complete di final stages of di contract. Ayodele, wey play regularly for di Oluyole Warriors last season, score four goals […]

todayAugust 6, 2026 24

Sport Yarns

El-Kanemi Chairman Tell Players Make Dem Serious for New Season

By: Jolayemi Olajide El-Kanemi Warriors chairman, Alhaji Waziri Isa Mai Qatar, don charge players make dem show commitment and discipline as dem prepare for di 2026-27 football season. Waziri give dis advice during im address to di team, urging players make dem obey instructions from newly appointed coach, Emmanuel King. Di chairman say di new tactician get knowledge wey go help di players improve as dem prepare for Nigeria National […]

todayAugust 6, 2026 23

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds