Lagos

988 Results / Page 37 of 110

Background

Lagos

Wike PDP Committee Hold Lagos Congress, Pick New Leaders

By: Esther Ayoola Say like dis, di Nyesom Wike-led Pipos Democratic Party National Caretaker Committee don hold congress for Lagos State on March 17, 2026, to elect new state executive members. Di party’s National Deputy Secretary, Adedeji Doherty, say delegates from all 20 local government areas and 37 local council development areas join dis particular exercise for Lagos. According report dis dey come because di Court of Appeal cancelling di […]

todayMarch 18, 2026 19

Lagos

Govenor Sanwo Olu Promise To Take Fake Goods

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don promise say dem go improve on consumer protection because of plenty bad goods and services wey dey enter di Lagos market. Oga Govo, Babajide Sanwo-Olu tuk dis one yesterday for World Consumer Rights Day wey dem dey call “Safe Products, Confident Consumers.” E press tuk say pipo dey lose billions of naira every year from fake medicine, defective goods, and misleading adverts. Sanwo-Olu, […]

todayMarch 18, 2026 17

Lagos

Arewa Community For Lagos Beg Presido Tinubu To Con Settle APC Crisis For Lagos

Arewa Community, Lagos branch,  don wire sms give wi oga presido Bola Ahmed Tinubu  say make e con intervene over wetin dem call attempt to weaken di Northern Lagos branch structure inside All Progressives Congress ahead of di 2027 elections. Di petition, wey dia oga, Musa Saleh sign, say di Arewa Community structure for Lagos bin dey officially inaugurated for 2021 by President Tinubu. Say more than 200 members of […]

todayMarch 17, 2026 17

Lagos

Customs Seize 3,398 Cartons Of Codeine Syrup Worth N3.39bn For Apapa Port

Di Nigeria Customs Service Apapa Command say, dem don seize 3,398 cartons of codeine syrup wey smugglers hide inside household utensils for Apapa Port, Lagos, worth about N3.39 billion. According to di command tuk, tuk, Isa Sulaiman, di interception hapun on Sunday, after customs officers carry out quick follow-up operation. Sulaiman quote di Customs Area Controller, Emmanuel Oshoba, say di operation na success through joint work with di National Drug […]

todayMarch 17, 2026 11

Lagos

Deputy Governor Hamzat Tell Civil Servants To Learn Work Well

Lagos State Deputy Governor, Dr Obafemi Hamzat, don call on civil servants to show honesty, care, and professionalism. E tuk dis one on Monday for di 60th birthday and retirement thanksgiving service of Permanent Secretary for Office of Deputy Governor, Mobolaji Daba for Chapel of Christ the Light, Alausa-Ikeja. Hamzat say e important, make civil servants sabi dia work, responsibilities, system, protocols, and wetin e need to serve public well. […]

todayMarch 17, 2026 13

Lagos

Sanwo-Olu Launch $25m Fund To Carry 50,000 Out-Of-School Pikins Back To School

Lagos State  Govo, Babajide Sanwo-Olu don release $25 million, Lagos Education Access Fund to hellep enroll about 50,000 pikins wey no dey school enter formal education for di state. Baba govo make di announcement during di unveiling ceremony wey happen for Lagos House Marina. According to di Govo, di Lagos State gornment remain committed to make sure say every pikins for Lagos get access to free and quality basic education.

todayMarch 17, 2026 19

Lagos

LASEMA Give Lagos Records For Emergency Handling

By: Esther Ayoola Lagos State Emergency Management Agency don share update say, na 173 emergency mata na im don handle between January and February 2026. Permanent secretary, Dr Olufemi Damilola tuk dis one for statement on Sunday as im ma dey share detail of dia operations. Road traffic wahala, ni be di worse according to di permanent secretary, with 56 cases, 53 na normal crash, 3 na bus or car […]

todayMarch 16, 2026 13

Lagos

Senoir Lawyer Falana Drag Gorment Say Monthly Sanitation Dey Illegal

By: Esther Ayoola Human rights lawyer, Femi Falana (SAN), say Lagos State Gornment plan to bring back di monthly environmental sanitation wey go stop people movement for three hours on last Saturday of every month nor make brain at all. Inside news statement on Sunday, Falana say dis plan go cost Lagos wetin nor good and dat na military days doings be dat, an e no suppose dey for democratic […]

todayMarch 16, 2026 15

Lagos

Uber, Bolt, InDrive, Lagride Go On Strike For Lagos

Ride-hailing drivers for Lagos, under Di Union of App-Based Transporters of Nigeria, AUATON, Lagos chapter, say dem go do three-day strike from March 16 to 18. Public Relations Officer, Steven Iwindoye, explain dat, while fares for Uber, Bolt, InDrive, and Lagride never change, cost of living wan kill di living. For di period of di strike, drivers go log off dia apps, and passengers go find am hard to book […]

todayMarch 16, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds