Lagos

1138 Results / Page 39 of 127

Background

Lagos

Ambode Throw Weight for Hamzat as Lagos 2027 Candidate

Former Lagos Governor Akinwunmi Ambode don join APC leaders to support Deputy Governor Obafemi Hamzat as consensus candidate for 2027 election. Ambode tuk dis one for im news statement on Thursday, say Hamzat don show loyalty and hard work for di party for more than 20 years. E still praise di decision and say e believe say Hamzat get di power to carry di party for Lagos. Ambode also promise […]

todayMay 1, 2026 13

Lagos

Jandor Pull Out For Lagos Governorship Race

Di 2023 Pipos Democratic Party Lagos state governorship candidate, Dr Abdul-Azeez Adediran, AKA Jandor, don withdraw from Lagos 2027 governorship race. He tuk dis one on Thursday for news conference, say e dey follow President Bola Tinubu endorsement of Deputy Governor Obafemi Hamzat as APC consensus candidate. Jandor, wey be Lagos4Lagos Movement leader, explain say dem don earlier agree to support whoever party choose, so he decide to step down. […]

todayApril 30, 2026 19

Lagos

Lagos House Of Assembly Approve Di Nomination Of Remi Bello

Di Lagos State House of Assembly don approve di nomination of Mr Usman Oluwaremilekun Bello as member of di Lagos State House of Assembly Service Commission (LASSCOM). Dem confirm am for inside plenary on Tuesday after members of di house of assembly ask am questions while oda members tuk say Remi go show workings. Di speaker of di house of assembly put am to a voice vote and di ayes […]

todayApril 30, 2026 33

Lagos

Lagos Gornment Launch New Tech System For Sharp Emergency Response

Lagos State Government don launch one new digital platform wey dem call Lagos Emergency Responder Management System (LERMS), Dis new system go make all emergency agencies to join bodi and respond to emergencies anywhere gbege happen. For statement wey gornment release, dem talk say dem unveil am for Folarin Coker Staff Clinic Conference Hall for Alausa, Ikeja. For di launch, Commissioner for Special Duties and Inter-Governmental Relations, Gbenga Oyerinde, tuk […]

todayApril 30, 2026 23

Lagos

Lagos Police Gbab 118 Suspects, Bust Kidnappers, Cultists and Vandals for April Crackdown

By: Esther Ayoola Commissioner of police for lagos state don share im report card say police record major breakthrough for April 2026 through intelligence-led operations and coordinated raids across di state. Oga Fatai, yan dis one for state Police Command Headquarters, Ikeja, briefing tori pipo on Wednesday. Di commissioner say, di operatives arrest 118 suspects linked to armed robbery, kidnapping, cultism and vandalism, while dem also recover guns, drugs, telecom […]

todayApril 29, 2026 39

Lagos

Federal High Court Launch Digital System For Lagos Division

By: Esther Ayoola Federal High Court for Lagos Division don launch e-filing system wey go make court work go digital, instead of using paper. Untop yarnings with tori pipo for court on Tuesday, Chief Judge, John Tsoho explain di new system, say e go improve efficiency, transparency, and make access to justice easier. E also tuk say di change na something wey  pass due process and dat di old manual […]

todayApril 29, 2026 24

Lagos

Lagos Assembly Back Tinubu Second Term, Praise Subsidy Removal

By: Esther Ayoola Members of Lagos State House of Assembly like dis, don join hand dey back oga Presido, Bola Tinubu make he run for second term as Presido. Dem take di decision for Tuesday plenary afta Ladi Ajomale from Oshodi/Isolo Constituency II move di motion. Ajomale spread bodi explain di Tinubu administration important reforms, like student loan scheme, removal of fuel subsidy, and big infrastructure projects like Lagos Coastal […]

todayApril 29, 2026 17

Lagos

Lagos APC Big Men Pick Hamzat As Consensus Candidate For 2027 Governorship Race

By: Esther Ayoola One ogbonge group, wey call dem selves, Governance Advisory Council (GAC), wey be top advisory body of All Progressives Congress for Lagos State, like dis don join force endorse Dr. Kadri Obafemi Hamzat as dem consensus candidate for 2027 governorship election. Chairmo of GAC, Oluyole Olusi, naim convasate dis mata to tori pipo on Tuesday as Govo Babajide Sanwo Olu carry Hamzat go see dem Oluyole say, […]

todayApril 29, 2026 31

Lagos

Gas Truck Crash For Eko Bridge, Cause Emergency For LASEMA

Lagos State Gornment don activate emergency response after one gas truck accident for Eko Bridge, outward Apongbon. Di Gornment, through LASEMA spokesman Olawale Afolabi, konfamte dis mata on Tuesday. According to am, di askident hapun when di front tyre of di 10-tonne truck burst while e dey move. E explain say di truck wey carry about 10,090kg of cooking gas lose control, hit di road median and overturn. Di crash […]

todayApril 28, 2026 48

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds