Lagos

988 Results / Page 39 of 110

Background

Lagos

Lagos CP Tell Police Recruitment Team To Dey Fair

Lagos State Police Commissioner, Olohundare Jimoh, don wire beta call to im recruitment team say make dem dey open, with dia new recruit, ensure fairness and integrity. Jimoh talk dis one during meeting with di officials wey dey handle recruitment exercise for di police. Say di exercise na part of nationwide recruitment for 50,000 constables for Nigeria Police Force.

todayMarch 10, 2026 14

Lagos

How Eko Strike Force Recover 111 Guns for Lagos

Eko Strike Force say dem don recover not fewer than 111 different firearms from different parts of Lagos State within di last one year. Oga Commissioner of police, Olohundare Jimoh  ni dey conversate dis one, on Monday during di commissioning of di unit headquarters for Eko Strike Force for Soomolu. Di police boss say di unit sef go hellep  support di work of di Rapid Response Squad to rascal jaguda […]

todayMarch 10, 2026 19

Lagos

Deputy Govo, Hamzat Ginger Boys To Repent For Ramadan And Lent

Lagos State Deputy Govo, Dr. Kadri Obafemi Hamzat, don advise Nigerians make dem use Ramadan and Lent period to repent, reflect, and restore family values. E tuk am during di 19th Annual Ramadan Lecture for Idado, Ibeju-Lekki. Say, true peace na when person obey God and respect im neighbor. Hamzat press tuk say wahala for society, like insecurity and distrust, can only hapun when pipo fail to obey dia Qur’an, […]

todayMarch 10, 2026 11

Lagos

Lagos Fix Streetlights For Night Movement

By: Esther Ayoola Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, say like dis Lagos state gorment do dey install new streetlights and fix broken ones for major roads and highways to make security stand fit for beta night movement E put dis one for im Facebook page, say the work na part of the Light-Up Lagos project wey dey in progress. Di Government teams don do installation for different areas for both […]

todayMarch 9, 2026 18

Lagos

Omo Onile Demolish 50 Houses For Surulere, Lagos; Residents Cry Out

By: Esther Ayoola For Surulere, Lagos, say some suspected land grabbers wey pipo sabi as Omo Onile don demolish about 50 houses, making pipo homeless. Dat di jaguda boys just waka enter di community on Tuesday, 27 January 2026, dey demand between N15 million and N25 million from house owners. Say Pipo wey no fit pay, na dia houses dem don demolish. Founder and Chief Executive Officer of Oikus, Israel […]

todayMarch 9, 2026 15

Lagos

Woman Kpai, Six Wunjur For Gbagada Bus Askident

By: Esther Ayoola Say One woman kpai and six odas get serious wunjury inside one askident wey hapun for New Castle Bus Stop, inward Gbagada, along Oworonsoki-Apapa Expressway, Lagos. According to Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) tuk, tuk, Adebayo Taofiq, di askident hapun over di weekend. Say na one Volkswagen commercial bus lose control come crash against roadside culvert. Di hardness of the jamming na make di woman fly […]

todayMarch 9, 2026 14

Lagos

APC Jandor Drag Gorment To Tackle Poverty

By: Esther Ayoola APC governorship aspirant for Lagos, Olajide Adediran, wey pipo sabi as Jandor, don give promise say him go take care of poor pipo, if e win for 2027. E yarn dis one on Saturday as e dey yarn with journalists for di 8th Annual Ramadan Lecture wey hold for Ikeja. Jandor say gornment main work na to beta people life, and dat im go work hard to […]

todayMarch 9, 2026 15

Lagos

IGP Disu Give Order To Police To Stop Over Sabi Work

By: Esther Ayoola Inspector-General of Police, Tunji Disu don order make dem reduce di number of police tactical teams wey dey operate across Naija. Lagos State Police Commissioner, Olohundare Jimoh na im relate dis mata for Abuja when police commissioners gather for meeting with di Inspector-General of Police Tunji Disu. Say, di order na part of di reforms wey di Naija Police Force dey do to improve professionalism, accountability and […]

todayMarch 9, 2026 17

Lagos

NDLEA Gbab Former-Lagos Councillor With 40kg Skunk For Ibeju-Lekki

By: Esther Ayoola Naija Drug Law Enforcement Agency, NDLEA, operatives don go gbab one former councillor for Lagos State, Sadiq Olalekan, for drug mata. Tuk, tuk of NDLEA, Femi Babafemi, Say dem pick di 45-year-old man for im house for Ilado area of Ibeju-Lekki afta dem receive correct intelligence informate. According to di NDLEA tuk tuk person, when officers search di house, dem see about 40 kilograms of skunk wey […]

todayMarch 9, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds