Lagos

988 Results / Page 42 of 110

Background

Lagos

LSSTF, Police Airwing Start Sky Patrol To Tackle Crime For Lagos

By: Esther Ayoola Lagos State Security Trust Fund don begin touchlight area from air with ogbonge collabo with Nigeria Police Force Airwing Command to fight crime. For statement wey dem release on Monday to tori pipo, LSSTF Executive Secretary, Ayo Ogunsan, explain how dem wan take buy waka with di police. Ogunsan say dem go use helicopter patrol to gada security informate, and  respond fast to threats, say criminals nor […]

todayFebruary 24, 2026 30

Lagos

FAAN Rescue All 14 Fire Victims For Lagos Airport

By: Esther Ayoola Say nor be small Fire catch for Old Terminal of Murtala Muhammed International Airport for Lagos yesterday afternoon around 3:20pm. According to report, Federal Airports Authority of Nigeria, FAAN, and Lagos State Fire Service do beta rescue, save all 12 pipo wey di fire trap, and dem konfam say nobody die. FAAN oga Madam Olubunmi Kuku, later clear newsmen on di update, dat, dem don start investigation […]

todayFebruary 24, 2026 16

Lagos

LAWMA Arrange New Plans For Waste Management

By: Esther Ayoola Lagos Waste Management Authority don announce new way, wey dem wan take manage dirty for Apapa-Iganmu area, say na operation show your Payment Receipt. Dis dem disclose for statement signed by oga LAWMA, Muyiwa Gbadegesin, con post for   Lagos State Gornment’s official social media platforms on Monday say make all residents and business owners readi dia assigned Private Sector Participant waste operators. Oga LAWMA say, di exercise […]

todayFebruary 24, 2026 19

Lagos

Lagos Gorment Approve 13% BRT Fare Increase From March 2

By: Esther Ayoola Lagos State gornment don approve BRT bus fare increase by 13% say na Bus Reform Initiative schemes. LAMATA Head of Corporate Communication, Kolawole Ojelabi ni put dis for statement give tori pipo, say Govo Babajide Sanwo-Olu gree for di increase because bus operators dey complain money nor reach dem do anything. Ojelabi say, di new fares go start from Monday, March 2nd, 2026.

todayFebruary 24, 2026 22

Lagos

Cement Truck Crush LASTMA Officer, Two Okada Riders For Badagry

By: Esther Ayoola Tragedy hapun for Badagry Roundabout, Lagos on Monday, say one cement-loaded truck run LASTMA officer plus two okada riders, and all kpai on di spot. Eyewitness tuk say di truck dey rush anyhow, e lose control, and na so e scara area. Police and FRSC pipo rush to di scene, while traffic jam everywia. Divisional Police Officer of Badagry Police Station, CSP Folajimi Agosile, also konfamte dis […]

todayFebruary 24, 2026 13

Lagos

LAWMA Tell Traders, Residents Make Dem Use PSP Operators

By: Esther Ayoola Lagos Waste Management Authority (LAWMA) don begin serious clean-up along Lagos–Badagry Expressway. For inside statement wey dem wrap like moimoi share to tori pipo on Monday, LAWMA Managing Director, Muyiwa Gbadegesin, say na heavy-duty carriers, loaders and support teams dem dey use take dey clear di illegal dump sites like Alaba Rago. Oga Muyiwa, say di move na part of environmental sustainability and compliance drive wey go […]

todayFebruary 23, 2026 25

Lagos

Senator Abiru Ginger Lagos Youth To Put Body For Politics

By: Esther Ayoola Oga senator wey dey represent Lagos East Senatorial District, Tokunbo Abiru, don drop yarns, say Naija politics don change colour and dat na youths dey run di show now. E yarn dis one as keynote speaker for Eko Youth Parliamentary Summit wey shelle for Lateef Jakande Auditorium inside Lagos State House of Assembly premises for Alausa, Ikeja. Abiru ginger youths like motor battery, say make dem dey […]

todayFebruary 23, 2026 13

Lagos

Minister Of Works Share Update For Lagos–Calabar Coastal Highway

By: Esther Ayoola Wi oga Minister of Works, Senator Engr. David Umahi, don give Lagosians assurance say One part of di Lagos, Calabar Coastal Highway go ready for commissioning by May. Im yarn dis one on Saturday, when him go inspect di project untop di coastal road wey go link Lagos to South-South and South-East. Umahi say di progress, dey show di workings of wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu […]

todayFebruary 23, 2026 15

Lagos

Lagos Deputy Govo Hamzat Tell Muslims To Celebrate Ramadan With Kindness

By: Esther Ayoola Lagos State deputy govo, Obafemi Hamzat, don advise Muslims and Christians make dem use Ramadan period show empathy, kindness, and good neighbourliness. Im tuk dis one for Ramadan prayer wey United Muslim Council of Naija, Mushin branch, arrange for Ogba, Lagos. Hamzat yarn say Ramadan fit hellep Nigerians understand each other wella and make dem become responsible citizens. E sti remind pipo say true religion go only […]

todayFebruary 23, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds