Lagos

1138 Results / Page 75 of 127

Background

Lagos

Overspeeding Motor Kill 9-Year-Old Pikin, Injure Four For Lekki

By: Esther Ayoola Unto matters for Lekki area, say one unkown driver go jam  five pikins  with im koropke, kabu kabu motor for Lekki, Lagos, afta im motor lose control. According to report, say di driver bin dey drive wawa speed, jam di innocent children wey dey dia own, Igboa. From statement wey fall out from di area Controller General of di Lagos State Fire and Rescue Service, Margaret Adeseye, […]

todayDecember 29, 2025 18

Lagos

Tinubu, Sanwo-Olu, Other Big Men Celebrate 73rd Eyo Festival For Lagos

By: Esther Ayoola Over di weekend, nor be small flex for wi oga Presido, Bola Tinubu, Imo State Governor Senator Hope Uzodimma and other big people joinbodi with Lagos State Governor Babajide Sanwo-Olu  flex, say dem dey celebrate di 73rd Eyo Festival for Lagos on Saturday. Di festival wey people dey call Adamu Orisa play, shelle  for Tafawa Balewa Square, if you see di agbada wey wi oga presido dek, […]

todayDecember 29, 2025 23

Lagos

PDP Lagos Set 19-Member Caretaker Committee

By: Rilwan Agbomeji Di People’s Democratic Party, PDP for Lagos, don inaugurate 19 people caretaker committee wey go run di party marras for di state. Di party talk say di Congress for zone, ward, Local and National levels go hold on January 9, 2026. Di inauguration happen dis week under di leadership of PDP National Chairmo, Hon. Abdul-Raman Mohammed, represented by PDP deputy national secretary, Engineer Adedeji Doherty. Doherty tell […]

todayDecember 26, 2025 36

Lagos

Just In: LASTMA Bring Out Two Deadi Body From Lagos Fire Scene

By: Rilwan Agbomeji Unto updates for di Lagos fire outbreak, say two men don die as dem rescue dem from di rubble of Great Nigeria Insurance House Plaza wey fire don destroy for Balogun Market, Lagos Island. Recall, di fire start for di fourth floor before e spread reach di sixth floor and later catch di oda floors plus di buildings wey dey around. One part of di plaza collapse […]

todayDecember 26, 2025 53

Lagos

Lagos Fire: China-Returnee, Others Still Dey Miss

By: Rilwan Agbomeji One China-based clothier wey dem dey call Obum and three other traders still dey trapped under rubble afta fire don destroy Great Nigeria Insurance House for Balogun Market, Lagos Island. Di plaza dey popular for cloth and shoe market for both pikin and adults. Fire start for fourth floor, spread reach sixth floor, then waka go oda floors and nearby buildings. Konfam report on Thursday see say […]

todayDecember 26, 2025 43

Lagos

Two Pipo Kpai As Tanker Blow For Badagry Expressway

By: Rilwan Agbomeji Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) omo don share update oh, say two people kpai for diesel tanker explosion wey happen for Badagry expressway, Oto-ijanikin axis near Lagos state university of education. LASTMA tuk tuk persin Adebayo Taofiq, explain say, di accident happen when di tanker driver dey try overtake anoda motor with too much speed and lose control. According to Taofiq, di tanker crash burst into […]

todayDecember 26, 2025 29

Lagos

Lagos State Govment Go Divert Traffic For Third Mainland, Obalende On Saturday

By: Rilwan Agbomeji Lagos State Govment don sound alarm for drivers and commuters say make dem plan dia movement well well as some big roads for Lagos island go lock on Saturday sake of Eyo festival. Major routes wey go feel am include Third Mainland Bridge, Obalende and oda nearby streets around di Island. Government talk say di diversion na for small time, so as to make di colourful Eyo […]

todayDecember 25, 2025 46

Lagos

Govnor Sanwo-Olu Open Ogboni Iduntafa Palace

By: Rilwan Agbomeji Govnor Babajide Sanwo-Olu don officially open di Ogboni Iduntafa Palace and welcome di Eyo Ologede group for Lagos Island. Ogboni Iduntafa na one of di oldest and most respected traditional institutions wey come from Yoruba culture. Di palace stand as strong symbol of Lagos Island tradition, spiritual authority, community protection, and ancestral heritage wey don last for many generations.  

todayDecember 25, 2025 40

Lagos

Govnor Sanwo-Olu Give Update On GNI Building Fire

By: Rilwan Agbomeji Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don break silence on di fire wey shake Great Nigeria Insurance Building for Martins Street, Lagos, oga go see di place, dey beg people make everybody calm down. Sanwo-Olu yarn dis one through Information Commissioner, Gbenga Omotoso, for statement wey im drop Thursday. Sanwo-Olu say emergency teams don control di fire and situation dey under check. Good news be say no single […]

todayDecember 25, 2025 38

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds