National

1100 Results / Page 23 of 123

Background

National

Makinde Wire SMS To Oyo Residents Say Make Dem Watch Dia Back

By: Esther Ayoola Oyo State Govo, Seyi Makinde, once again don clear im state member, say make dem dey alert and security-conscious. Govo Makinde yarn dis on Monday wen e dey address public and civil servants during interfaith service wey dem hold for Ibadan to usher in di New Year. E press tuk say, im gorment go always do wetin e suppose do to protect lives and property.

todayJanuary 13, 2026 9 7

National

Bandits Kpai 5 For Otobi, Benue State

By: Esther Ayoola Nor be small thing oh, eehooo, say Bandits don kpai kpai pipo for Benue again oh, say  five pipo kpai for Otobi community, Otukpo LGA, Benue State. One of di people wey dem say die, na 2019 PDP House of Assembly candidate, Igbabe Ochi. According to report, di attack happen around 1:30am on Tuesday, after community volunteer guards do better commando scarra some jaguda boys wey wan […]

todayJanuary 13, 2026 7 1

National

Lagos APC Tell Obi Say Tinubu Dey Active For Governance

By: Esther Ayoola Di Lagos State chapter of di All Progressices Congress on Tuesday don tuk dia tuk, say, wi oga Presido, Bola Tinubu no dey miss and dat e dey active for him duties. Di comment follow question wey Peter Obi, Labour Party presidential candidate for 2023, raise about di president’s presence yesterday. APC spokesman, Seye Oladejo, tell newsmen for Lagos say Tinubu still dey fully involved for governance, […]

todayJanuary 13, 2026 6 6

National

How Jaguda Boys Do Warling Film For Obajana Police HQ

By: Rilwan Agbomeji Say nor be small war start film play for Obajana Police Divisional Headquarters for Kogi State, dat jaguda boys enter di area and begin shoot wetin nor good kill one civil defence guide, but last last face and scata dem. Several security personnel and vigilante members sustained gunshot wunjor for di mata oh. Resident say di mata wey sup from Sunday to Monday night nor allow dem […]

todayJanuary 13, 2026 7 2

National

Edo Gorment React To Jaguda Boys Doings For Ekpoma

By: Esther Ayoola Edo State Governor, Monday Okpebholo, don condemn di attack wey hoodlums carry go Onojie of Ekpoma palace after dem hijack peaceful protest against kidnapping and insecurity for di area. Di protesters scata market, kill goats, beat cows, block major road and destroy parts of di palace, making businesses come standstill. Governor Okpebholo finally visit di palace on Monday and tuk say di violence no dey acceptable, dat […]

todayJanuary 13, 2026 6

National

President Tinubu Put Bodi For Climate Change Submit In Abu Dhabi

By: Esther Ayoola Say like dis wi oga Presido, Bola Tinubu don arrange bodi to tuk Naija mata for climate change and sustainability for Sustainability Summit wey dey sup for Abu Dhabi, UAE. Untop yanings with tori pipo, Minister of Foreign Affairs, Yusuf Tuggar tuk say Tinubu go yan with other world leaders about Nigeria climate plan and how we fit develop. Tuggar also tuk say, Oga presido go use […]

todayJanuary 13, 2026 14

National

Police Mehn Guide Kano State Gorment House

By: Esther Ayoola Say Security tie wrappa for Kano State Gornment House dat, oga govo,  Abba Yusuf dey make move to  defect go other party. Na so security mehn block di gate, combined security force  from di Nigeria Police Force and di Department of State Services (DSS) all of dem joinbodi for di location. According to report, if u must enter di gorment house, u must identify yaself, show ID […]

todayJanuary 12, 2026 6

National

FG And ASUU Fix Date For Deal Signing, January 14

By: Esther Ayoola Federal Gornment and Academic Staff Union of Universities (ASUU) say dem go meet for conner on Wednesday, January 14, 2026, sign new agreement to improve university education and maintain stability across di obodo Nigeria. Ministry of Education tuk dis for statement released on Sunday, saying di ceremony go hold for TETFund Conference Hall, Maitama, Abuja. Di event go dey presided by Minister of Education, Dr. Maruf Alausa, […]

todayJanuary 12, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app