National

233 Results / Page 23 of 26

Background

National

One Person Die, Seven Injure As Building Collapse For Jigawa

Kirikasamma Local Government Council for Jigawa don confirm say one person don die and seven others wound after one building collapse for the area. The council Information Officer, Musa Muhammad, talk this one inside statement wey he release for Dutse on Sunday. According to am, the building collapse na because of heavy rainfall wey fall for Kirikasamma and surrounding villages. The incident happen around midnight on Friday for Kabak village, […]

todaySeptember 9, 2025 8

National

2027: Osun, Lagos, Ogun Lead as INEC Register Over 3.5 Million PVC [Full List]

More than 3.5 million Nigerians don pre-register online for their Independent National Electoral Commission (INEC) Permanent Voters Cards (PVC) as dem dey prepare for 2027 general elections. INEC announce this news on Monday, just two weeks after the registration exercise begin. According to the data wey dem release, Osun state dey lead with 518,635 registrations, followed by Lagos State wey get 440,647 and Ogun State wey get 348,217 registrations so […]

todaySeptember 9, 2025 7

National

FG, Labour Union Closed-Door Meeting on NUPENG, Dangote Wahala End Without Agreement

The closed-door meeting wey Federal Government organise to settle beef between Nigeria Union of Petroleum and Natural Gas Workers (NUPENG) and Dangote Group don end without solution. Di meeting wey Minister of Labour and Employment, Mohammed Dingyadi, and Minister of State for Labour and Employment, Nkiruka Onyejeocha, lead, na effort to stop NUPENG planned strike. Di meeting gather NUPENG national executives, officials from Nigeria Labour Congress (NLC), Trade Union Congress […]

todaySeptember 9, 2025 11

National

Oyedele Talk Say 5% Fuel put in Surcharge Start for 2007, No Be Tinubu Government Bring Am

Chairman of di Presidential Committee on Fiscal Policy and Tax Reforms, Mr. Taiwo Oyedele, don talk say di 5% surcharge wey dem wan collect on top fuel no be President Bola Tinubu administration bring am come. Oyedele talk dis one on Tuesday. According to am, na since 2007 dem introduce di law, but dem no implement am because government that time dey subsidise fuel. “One very important message for people […]

todaySeptember 9, 2025 8

National

SERAP Drag RMAFC Go Court Over Plan To Increase Tinubu, Others’ Salary

Socio-Economic Rights and Accountability Project (SERAP) don carry Revenue Mobilization Allocation and Fiscal Commission (RMAFC) go Federal High Court for Abuja because of the commission plan to increase salaries of political and public office holders, including President, Vice President, Governors, their deputies, and National Assembly members. Last month, RMAFC Chairman, Mohammed Shehu, reveal say the commission wan increase the salaries as the current ones dey “paltry.” Shehu talk say President […]

todaySeptember 8, 2025 6

National

Dangote/NUPENG Problem: FG dey try stop nationwide strike

Abuja – September 8, 2025 – The Federal Government don summon Dangote Group and NUPENG leaders come emergency meeting today over serious wahala wey fit paralyze Nigeria fuel supply as oil workers don begin nationwide strike against Dangote Group over wetin dem call anti-union policy and poor working condition. Minister of Labour and Employment, Muhammadu Dingyadi, gree say the matter don red and invite all parties to urgent tripartite meeting […]

todaySeptember 8, 2025 13

National

Hisbah Catch Person Wey Dem Suspect Say Be Human Trafficker with 12 Women for Kano

Kano State Hisbah Command don arrest one suspected human trafficker with 12 women for one motor park along Zaria Road for Kano, as dem dey try travel go Lagos. The Deputy Commander General of Hisbah, Sheikh Mujahideen Aminuddeen, confirm the arrest for one statement. He talk say na Hisbah operatives, led by Officer in Charge of motor parks, Muhammad Bashir, intercept the suspect wey come from Borno State. Even though […]

todaySeptember 4, 2025 15

National

Ambode Declare Say Him Go Run For 2027 Lagos Governorship, Pledge Support For Tinubu Second Term

Former Lagos State Governor, Akinwunmi Ambode, don announce say him wan run for 2027 governorship election for Lagos, and e still back President Bola Ahmed Tinubu make dem re-elect am. Ambode talk this one for Badagry during one sensitisation programme wey dem do to encourage people to register and collect their Permanent Voter Cards (PVC). The former governor no show for there personally, but Dr. Seyi Bamigbade, wey be Director […]

todaySeptember 4, 2025 50

National

Nigeria Don Gain Global Respect, Tinubu Talk

President Bola Tinubu don talk say the bold economic reforms wey him government dey do to bring Nigeria back to better position dey show better results, and e don make people from different parts of di world begin respect Nigeria again. The President talk this one for State House wen him receive Oba Ghandi Afolabi Oladunni Olaoye, Orumogege III, wey be Soun of Ogbomosoland, together with other royal fathers. According […]

todaySeptember 4, 2025 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app