National

1100 Results / Page 31 of 123

Background

National

Kebbi Goment Open Town Schools Again After Bandit Wahala

By: Esther Ayoola Kebbi State goment don approve make some primary and secondary schools for big towns and cities resume immediately afta wetin jaguda boys use dia eyes see last year. U sabi say, dem bin close schools before, afta bandits attack Gorment Girls’ Comprehensive Secondary School for Maga town for November, wia dem kidnap 25 schoolgirls and kill one school guard. Commissioner for Basic and Secondary Education, Dr. Halimatu […]

todayJanuary 5, 2026 5 4

National

Kwankwaso Set Compass On How Im Wan Waka For 2027 Presidential Election

By: Esther Ayoola Oga national leader of New Nigeria People’s Party (NNPP), Rabiu Musa Kwankwaso, say im nor be mumu oh, dat im go only waka go another party, if dem agree to give am presidential or vice-presidential ticket for 2027 election. U sabi say, Peter Obi join African Democratic Congress (ADC) last year and e go dey contest presidential ticket with Atiku Abubakar and Rotimi Amaechi, wey fit cause […]

todayJanuary 5, 2026 6

National

President Tinubu Order Security To Kramp Niger State Jaguda Boys

By Ebi Oboko Oga Presido, Bola Tinubu dey vex seriously don order im olopka, army, vigilante say make dem carry dia rake and fork enter the bushes of Niger state environs to gbab di jaguda boys wey attack communities for Niger State, kill over 40 pipo and kidnap plenty others. For statement wey im sign by imself on Sunday, Tinubu say im don send sms to wi Defence Minister, Service […]

todayJanuary 5, 2026 14 37

Business

Tins Wey You Need Sabi About Di Naija New Tax Law

By Ebi Oboko TO WHO E CONCERN – MAKE I JUST GIVE YOU DIS INFORMATE. QUESTIONS & ANSWERS ON DI NEW NIGERIA TAX LAW (Focus on Individuals and Small Businesses) 🟢 Q1: When Di  new Nigeria Tax Act go start work? A1: Di  new tax law go start from 1st January 2026. 🟢 Q2: Who dis tax law concern? A2: E concern everybody wey dey earn money for Nigeria – […]

todayJanuary 5, 2026 23 14

Local

Naija National Assembly Wan Release Certified Tax Bills to Clear Wahala

By Ebi Oboko Di Naija National Assembly to clear mehn doubt, say dem don dey arrange to show the general public di part of di Tax Acts wey dem say small confusion dey untop, say no wayo anywia. Director of Information, Bullah Bi-Allah, yan yesterday, say dem don direct the Clerk to release certified copies of di bills wey President Bola Tinubu don sign. Di copies go get certificate pages, […]

todayJanuary 2, 2026 9 2

National

Ondo Govo ginger mehn police to Guide Area

By  Ebi Oboko Ondo State Governor, Lucky Aiyedatiwa, dey vex serious, say jaguda boys dey worry pipo, so like dis im don send security make dem double for all communities and forest areas, after New Year attack for Ipele police station for Owo LGA. The attack happen Wednesday night as plenty people dey attend night service to welcome 2026. Di Govo say, di mata nor dey let am sleep, so […]

todayJanuary 2, 2026 9

Local

First Lady Welcome Nigeria First Pikins dem for 2026

By Ebi Oboko First Lady of Nigeria, Senator Oluremi Tinubu, don welcome Nigeria first pikin of the year, baby girl Enekole Zion Adakole, wey born exactly 12:00 midnight for FMC Jabi, Abuja, January first. The baby mama na 26-year-old first-time mother, Omeyi Patience Adakole, with her husband Celestine Adakole, as Madam First Lady present official birth certificate from National Population Commission give the newborn. She also celebrate Blessing Oragwu wey […]

todayJanuary 2, 2026 7

Local

ADC Disown Obi Say Im Registration No Follow

By Ebi Oboko One faction of the African Democratic Congress (ADC), wey Nafiu Gombe dey lead, don reject Peter Obi. Ontop yrnings with tori pipo,  the ADC faction talk say Obi no follow correct procedure when e register for the party for Enugu. Di faction call demself di real leaders of ADC. U sabi say   Obi announce dat,  im ma don join ADC for event wey hold for Nike Lake […]

todayJanuary 1, 2026 7

National

Senate Presido, Akpabio Repent Sake Of New Year Mass Message Wey Touch Im Heart

By Ebi Oboko Wi oga Senate Presido, Senator Godswill Akpabio, in the spirit of the new year don tell him lawyers make dem withdraw all di defamation cases wey e get against some people for inside the obodo naija. Akpabio speak on Thursday for Sacred Heart Parish, Uyo, say e get almost nine cases for court against people wey e accuse of defaming am. E explain say e hear di […]

todayJanuary 1, 2026 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app