National

1100 Results / Page 37 of 123

Background

National

Kwankwaso, Sanusi Matter Spark Fresh Wahala For Kano

By: Rilwan Agbomeji Fresh gbege don sup for Kano say Former Govnor Rabiu Kwankwaso tell members of New Nigeria People’s Party (NNPP) make dem pledge loyalty to reinstated Emir of Kano, Lamido Sanusi. Dis one no sit well with deposed Emir, Aminu Ado-Bayero, as e quickly fire back. U sabi say, On 23 May 2024, Kano State Governor, Abba Yusuf, remove Ado-Bayero as Emir afta State House of Assembly cancel […]

todayDecember 25, 2025 9

National

EFFC Boss Drop Yanings Say Corruption Dey Block God Blessings For Nigeria

By: Rilwan Agbomeji Chairmo of EFCC, Ola Olukoyede, don open di secret finally oh, say  na corruption dey block God blessings wey suppose reach Nigeria. Im tuk dis konfam tuk for im Christmas message say, na corruption dey stop di country make e reach full potential. Olukoyede beg Nigerians make dem join hand fight corruption to make Nigeria strong, rich and respected. Im call on everybody make dem waka together […]

todayDecember 25, 2025 10

National

Suicide Bomber Kill 5, Injure 35 For Ngamboru Market Mosque, Maiduguri

By: Rilwan Agbomeji Five people don kpai and 35 odas don get different kain injury afta one teen suicide bomber blow imself for mosque inside Ngamboru market, Maiduguri, during evening prayers on Wednesday. Eyewitness talk say di blast happen around 6:10pm when plenty traders dey worship before dem go house, and e make fire plus thick smoke burst for mosque ceiling. Di explosion scarra wetin nor good for di crowded […]

todayDecember 25, 2025 10

National

First Lady Remi Tinubu Share Christmas Food For Kaduna

By: Rilwan Agbomeji Nigeria first lady, senator Oluremi Tinubu, don flag off food distribution for Christmas and New year celebration for Kaduna, as she donate ₦100 million to Christian Northern Nigeria political forum. She praise di office of di senior special assistant to di president on political and other matters for arranging di programme, and reveal say Alhaji Ibrahim Masari provide 48,000 bags of 25kg rice plus transport money for […]

todayDecember 25, 2025 9

National

President Tinubu Set Up APC Peace Committee For 2027 Election

By: Rilwan Agbomeji President Bola Ahmed Tinubu on Wednesday for Lagos don set up APC committee wey go handle strategy, conflict resolution and mobilisation as party dey prepare for 2027 general elections. Di committee get APC govos, ministers and oda big party stakeholders, with Yobe state govo, Mai Bala Buni, as Chairman, while Muiz Banire serve as member and secretary. Oda members include Kwara state govo and NGF Chairman Abdulrahman […]

todayDecember 25, 2025 14

National

Army Kick Off Operation Ember Guard To Secure South West

By: Rilwan Agbomeji Unto security mata for di Detty December, wi Nigerian Military don ogbonge security, operation ember guard for south west, from December 23, 2025 reach January 15, 2026, to boost security during christmas and post-festive period. Talkin for flag-off ceremony, Theatre Commander, Rear Admiral Abubakar Mustapha, say intelligence report show say criminal activities fit increase, na why soldiers and oda security agencies don deploy to key areas for […]

todayDecember 24, 2025 10

National

Defence Ministry Arrange Paperless System For Naija Secuirty

By: Rilwan Agbomeji Di Ministry of Defence don officially go paperless as dem launch di Enterprise Content Management System, (ECMS), to boost digital operations for defence administration. Minister of Defence, retired general Christopher Musa, announce di development on Tuesday for Abuja during di formal go-live launch of di system at di ministry headquarters. General Musa say di initiative na major change for how di ministry handle national security marras, as […]

todayDecember 24, 2025 9

National

President Tinubu Wire Christmas Message Giv Naija Pipo

By: Rilwan Agbomeji Wi oga Presido Bola Tinubu don promise say im go protect religious freedom for all Nigerians. E yarn dis one for im 2025 Christmas goodwill message wey drop Wednesday. Tinubu talk say im government dey committed to stop violence and discrimination, make everybody enjoy peace.  

todayDecember 24, 2025 10 2

National

Na Im Be Say, Naija Govt And ASUU Don Finally Hammer New Deal

By: Rilwan Agbomeji Finally finally say wi Federal Govment and di Academic Staff of Universities don finish dia long negotiation over di 2009 FGN–ASUU agreement. ASUU share dis update for dia official Facebook page on Wednesday. Di new deal go start from January 1, 2026, and e go dey reviewed every three years.

todayDecember 24, 2025 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app