OBODO NAIJA

770 Results / Page 15 of 86

Background

OBODO NAIJA

KASU Unions Say Make Govt Pay Workers Dia Money

By: Mariam Ajayi KASU union leaders don tell Federal Gorment make dem put di 2026 agreement with non-teaching staff for public universities. Dem also call on Kaduna State Government to pay all outstanding allowances, promotion arrears, pension arrears and wage award wey dem owe university workers. Di unions make di demand after dem hold meeting for Kaduna State University union secretariat on Tuesday. Dem warn say government need to honour […]

todaySeptember 2, 2026 15

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Defend Economy Hardship Policy Again

By: Mariam Ajayi Presido Bola Tinubu don defend di economic reforms wey dey make life hard for Nigerians, say na necessary plan to push Nigeria economy reach $1 trillion by 2030. Tinubu, through APC National Chairman, Prof Nentawe Yilwatda, say although di medicine bitter now, government foreign reserve and revenue don dey improve. But former Vice Presido no gree, as e question why government wait for more dan three years […]

todaySeptember 2, 2026 9

OBODO NAIJA

Dino Melaye Blast Tinubu Over Five New Presidential Aeroplane

By: Mariam Ajayi ADC chieftain, Dino Melaye, don blast Presido Bola Tinubu gorment over di reported addition of five new aeroplane to Nija Presido Air Fleet for less than four years. Melaye make di statement for X, e describe di increase as ridiculous, say country wey e say still dey struggle with poverty. Di former Kogi West Senator also complain say Nigerian Air Force no even receive any new aircraft […]

todaySeptember 1, 2026 15

Lagos

Falana Demand Police Arrest As Tear Gas Scatter Pentioners

By: Mariam Ajayi Human rights lawyer, Femi Falana, call for di arrest of police officers wey  use tear gas scatter pensioners wey protest for Alausa, Lagos. Di pensioners gather for Lagos State Gorment Secretariat and House of Assembly complex dey demand dia outstanding pension adjustments and wage awards before police scatter di protest. Di retirees say di Lagos State Gorment never pay dem pension increases, consequential adjustments and wage awards […]

todaySeptember 1, 2026 16

OBODO NAIJA

Tinubu Hails Soldiers, Local Hunters Over Kogi Rescue Mission

By: Mariam Ajayi Presido Tinubu don hail security operatives and local hunters wey rescue 21 kidnapped pipu, with 15 NYSC corpers, from kidnappers’ hideout for Kogi. Di team enter di forest for Ofu LGA and rescue eight men and 13 women. Di victims don dey hospital where dem dey receive treatment before dem go take them to dia family Tinubu say gorment no go stop until dem crush kidnappers and […]

todaySeptember 1, 2026 19

OBODO NAIJA

Tinubu Tell North-Central Make Dem Join Body Fight Insecurity

By: Blessing Aminu Presido Bola Tinubu don call traditional rulers, religious leaders, youths, women and communities for North-Central make dem join body wit gorment and security agencies fight insecurity. Tinubu tok dis for 2026 North-Central Security Summit for Makurdi, Benue State. Di Presido, wey SGF George Akume represent, tell traditional and religious oga make dem dey alert security agencies anytime dem notice danger. E also beg Nigerians make dem share […]

todayAugust 31, 2026 16

OBODO NAIJA

Court Giv 55-Year-Old Woman Bail On Top Turkey Oil Marras

By: Blessing Aminu Chief Magistrate Court No. 1 for Gombe, wey Chief Magistrate Musa-Saleh Kilawa dey stay, don grant bail to one 55-year-old woman, Antine Amadu, wey dey face allegation say she receive stolen property. Amadu, wey dey stay for Dawaki Quarters, Gombe, show for court over allegation say she dishonestly collect one gallon of Turkey oil wey worth N60,000. Prosecution tell di court say di incident happen around 1am […]

todayAugust 31, 2026 20

OBODO NAIJA

FG Set Passport Exercise For Nigerians Wey Dey UK

By: Kofoworola Olayinka Federal Gorment don announce dates and places for special passport exercise for Nigerians wey dey live for United Kingdom. Nigeria Immigration Service go carry out di exercise for London, Manchester, Aberdeen and Cardiff. Di move follow directive from Interior Minister, Olubunmi Tunji-Ojo, plus discussion with Nigerian High Commission and Nigerian communities for UK. Di Nigeria Immigration Service say dem deploy Passport Intervention Team from dia headquarters for […]

todayAugust 31, 2026 8

OBODO NAIJA

NELFUND Boss Deny Money Wey Dem Use Anyhow

By: Kofoworola Olayinka NELFUND Boss, Akintunde Sawyerr, don deny down allegation say money dey miss for di agency, e tok say nobody get evidence to prove say dem mismanage money. Sawyerr yarn dis one for TV siddon tok on  Monday, saying NELFUND need money to give students loans and say di scheme na part of Federal Gornment plan to redirect money enter welfare programmes. E say make people understand say […]

todayAugust 31, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds