OBODO NAIJA

433 Results / Page 17 of 49

Background

OBODO NAIJA

Oyo Gornment Bulldoze House Wey Jaguda boys take  Hide Adelabu Sister 

By : Jolayemi Olajide Oyo State Gornment don pull down di building wey kidnappers use hide Olaide Adegoke John-Paul, sister to former Power Minister Bayo Adelabu, and her twin pikins. Di demolition happen on Monday, less than two days after police rescue di woman and her pikin dem from di kidnappers. Gornment tok say dem discover say na for di building di criminals keep the victims during dia captivity. Authorities […]

todayJune 8, 2026 8

OBODO NAIJA

Fg Pay Over 700 Billion Naira To Local Contractors To Boost Economy

By : Jolayemi Olajide Wi Federal gornment don konfamate say dem package 700 billion naira for local contractors, with 436.6 billion naira comot for inside May alone to clear old debts. Finance Ministry image-maker, Efe Ovuakporie, yarn for statement on Monday say over 1,240 contractors across different agencies benefit from di money. Di Minister of Finance, Taiwo Oyedele, naim sign di funds after dem do proper screening to make sure […]

todayJune 8, 2026 6 5

OBODO NAIJA

Akpabio Clear Nigerians Why Everybody Need To Fire Prayer

By : Jolayemi Olajide Nor be small tin, wi Senate Presido, Godswill Akpabio don tell Nigerians on Sunday, say wi need to fire payers oh, unto di way, wey pipo take dey lose for di country. Akpabio drop dis one for im abuja office, say, like im don start monthly prayer session to block kidnapping and killing, an im run same thin when im be Governor for Akwa Ibom State. […]

todayJune 8, 2026 12 4

OBODO NAIJA

Iyabo Obasanjo Dump Apc For Ogun Gofnorship Ticket Mata

By : Jolayemi Olajide Former Senator and daughter of Baba Obasanjo, Prof. Iyabo Obasanjo, don officially watch hand comot for APC mata inside Ogun State, dat di parti leaders nor dey try, dat dem see her finish. She wrap dis one for one letter wey she send to the state APC Chairmo, Yemi Sanusi. U know wetin hapun, according to report oh, Madam Iyabo pull dey out after she lose […]

todayJune 8, 2026 11 1

OBODO NAIJA

FG APPROVE FIVE FLIGHTS WEY GO CARRY NIGERIANS COMOT SOUTH AFRICA

  By : Jolayemi Olajide Di Federal Gornment don arrange five emergency flights wey go carry Nigerians comot South Africa, based on xenophobic attack Foreign Affairs Ministry tuk, tuk person, Kimiebi Ebienfa, drop dis ogbonge update on Sunday, say na over 500 citizens don register to come back home, and dem don moving di packing go Wednesday, so dat more person go register. Nor be amebo say, wi oga Presido, […]

todayJune 8, 2026 19 5

OBODO NAIJA

Datti Blast Atiku

Former Labour Party Vice Presidential candidate, Datti Baba-Ahmed don go shake table oh, say Atiku thinkings for politics nor enter sand, nor strong, if to say Atiku Abubakar support Peter Obi for di 2023 election, e for don win presidency for 2027. Im yarn dis one for TV sit down tuk, say, if Atiku show patience like Tinubu and allow Obi contest first, both of dem for support am later. […]

todayJune 8, 2026 15

OBODO NAIJA

Abuja Police Seize Over 30  Cars say dem get black glass

By : Jolayemi Olajide FCT Police Command don seize more than 30 vehicles with tinted glass, wey be say dem cover plate, say any motor wey nor get correct registration go collect based on di insecurity. According to di  FCT Commissioner of Police, Ahmed Sanusi, say nao ga IGP, Olatunji Disu, give dem dem di go ahead and to tackle rising cases of one-chance robbery, kidnapping and other violent crimes. […]

todayJune 5, 2026 14

OBODO NAIJA

Atiku Drag Tinubu Again Over Oyo Kidnap Victims

By : Jolayemi Olajide Former Vice Presido, Atiku Abubakar don tackle Presido, Bola Tinubu and First Lady Oluremi Tinubu over the continued kidnapping pupils and teachers  for Oyo State. For statement wey im media aide, Phrank Shaibu, release on Friday, Atiku accuse di Federal Gornment of failing to show enough energy to rescue di victims. Di African Democratic Congress presidential candidate say e dey difficult to understand why gornment still […]

todayJune 5, 2026 11

OBODO NAIJA

NCDC Raise Red Alert, Say Ebola Fit Enter Naija Anytime

By : Jolayemi Olajide Nigeria Centre for Disease Control and Prevention, NCDC, don make am clear say Ebola Virus Disease entering Nigeria dey very high cause e dey spread Uganda and Democratic Republic of Congo. NCDC Director-General, Dr Jide Idris, naim sorosoke dis announcement during media briefing for Lagos as e explain Nigeria preparedness level against di disease threat. According to am, as e dey increase for international, movement of […]

todayJune 5, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds