OBODO NAIJA

770 Results / Page 16 of 86

Background

OBODO NAIJA

Defence Minister Say FG Serious About Safer Nigeria

By: Kofoworola Olayinka Defence Minister Gen. Christopher Musa on Sunday, August 30, 2026, don promise Nigerians for obodoyinbo say Federal Government dey serious about making Nigeria safer and secure for everybody. Musa yarn dis wan for meeting with Nigerians wey dey  live for Angola, on di sidelines of African Union meeting for Luanda. E say gornment dey increase soldiers and improve dia equipment and ability to fight security threats across […]

todayAugust 31, 2026 14

OBODO NAIJA

Nigerians Criticise Peter Obi

By: Mariam Ajayi Some Nigerians don criticise NDC presidential candidate Peter Obi after e visit Koinonia Global Ministries for Abuja on Sunday. Obi, during di visit, urge Nigerians to pray for politicians, saying dem dey contribute to di problems wey Nigeria dey face. E also ask citizens to pray make politicians stop stealing gornment money and make di country better.

todayAugust 31, 2026 15

OBODO NAIJA

Dino Melaye Mocks Tinubu

By: Mariam Ajayi ADC chieftain Dino Melaye don mock Presido Bola Tinubu over im three-week vacation outside Nigeria. Melaye make di statement as Tinubu travel from Abuja to Europe for im annual leave, according to presidential aide Bayo Onanuga. Onanuga say Tinubu first stop na London, United Kingdom, as part of di vacation.

todayAugust 31, 2026 12

OBODO NAIJA

Serap, Tell National Assembly Make Dem Pull Back Foreign Aid Bill

By: Mariam Ajayi SERAP and Nigerian Guild of Editors don call on National Assembly to withdraw Foreign Aids Regulation Bill 2026 over concerns about media freedom and civic space. Dem make di call in a joint letter dated August 29, 2026, asking Senate Presido Godswill Akpabio and Speaker Tajudeen Abbas to reject di bill. Di groups say di proposed law unnecessary, unlawful and unconstitutional and fit affect democratic participation for […]

todayAugust 31, 2026 6

OBODO NAIJA

Police Arrest 22-Year-Old Man For Suspected Defilement Of 15-Year-Old Girl

By: Mariam Ajayi Police don arrest 22-year-old Daniel for Ogun State over allegation say e drug 15-year-old girl with malt drink before e allegedly defile her. Force spokesperson Ani Iniedu confirm di arrest in a statement on Sunday, saying di girl lose consciousness after she drink di malt. Police take di victim go Olukoye Ransome-Kuti Memorial Hospital for Asero for medical check-up, while dem carry di suspect go custody.

todayAugust 31, 2026 16

OBODO NAIJA

NDLEA Seize N6.2bn Dangerous Drugs For Lagos Airport

By: Mariam Ajayi NDLEA operatives don arrest 49-year-old drug kingpin Akinbile Kazeem Aikins for Murtala Muhammed International Airport after dem catch am with N1.5bn Captagona pills from Ghana wey e hide inside local soap. NDLEA spokesman Femi Babafemi say Aikins confess say e wan supply di drugs for Northern Nigeria. For another operation, NDLEA and Nigeria Customs seize over 3.9 million Tramaking and Tapentadol tablets worth N4.6bn inside four abandoned […]

todayAugust 31, 2026 16

OBODO NAIJA

Where Petrol Subsidy Money Dey Go??

By: Mariam Ajayi  Advocate of Nigeria (SAN) and popular human rights lawyer, Femi Falana, don throw heavy mouth give goment again. Di man tuk say since dem commot fuel subsidy, all di big-big money wey dem talk say dem dey save, where e dey enter? Because e no dey reach ordinary Nigerians pocket. E drop dis yarn on Sunday during one TV interview. He say make nobody dey tell Nigerians […]

todayAugust 31, 2026 14

OBODO NAIJA

Atiku Tell Tinubu: Your Time Don Reach, Prepare Handover

By: Kofoworola Olayinka ADC presidential candidate, Atiku Abubakar, don knock Presido Tinubu gornment over promise to reduce transport fares, saying di policy come too late after fuel subsidy removal. Atiku say di gornment fail to cushion di high cost of living, adding say only about 120,000 vehicles don convert to CNG in more than three years. E say di figure na less than one per cent of about 14 million […]

todayAugust 28, 2026 17

OBODO NAIJA

High Court Give NDLEA Gbas Gbos, Make Dem Free KC Luxury

By: Mariam Ajayi Lagos Federal High Court Judge, Justice Friday Ogazi, just give NDLEA hot query make dem carry body bring social media big boy KC Luxury, come face court after dem suuk am for cell for 14 solid days like garri inside water without even charging am to any crime. AS KC Luxury lawyer wire the court ex parte motion, na so Baba Judge,  come tell the drug officers […]

todayAugust 28, 2026 21

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds