OBODO NAIJA

770 Results / Page 18 of 86

Background

OBODO NAIJA

Federal Gorment Say 60% Of Active Electricity Customers Get Meter

By: Mariam Ajayi Federal Gornment don announce say 60 per cent of active electricity customer for Nigeria don get meter as gornment dey work to end estimated bill. Government say 668,000 meter don already dey installed out of di 1.033 million meters delivered under di World Bank-backed programme. Di initiative, wey include Presidential Meter Initiative, dey target di electricity metering gap and stop arbitrary estimated bill for registered customer.

todayAugust 27, 2026 14

OBODO NAIJA

FG Announce Ogbonge $1bn Funds Wey Dem Wan Use Help Poor Pipo

By: Yusuf Abuh Federal Gornment don launch $1 billion Renewed Hope Social Protection Programme to help poor Nigerians. First Lady Oluremi Tinubu, AKA iya Alakara naim porporly dis mata on Wednesday for Presidential Banquet Hall, State House, Abuja, say dis project wey dem call HOPE-SP go helep create ogbongelicious small businesses for country man and woman. Iya Oluremi say di programme go listen to di specific needs of poor families […]

todayAugust 27, 2026 22

OBODO NAIJA

Baba Presido Tinubu Beg Ogas of Gas to Make Naija Gass Business Work

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido, Bola Tinubu don ginger  Naija Liquefied Natural Gas, NLNG to reduce gas flaring and make better use of Nigeria gas reserves so Nigerians fit enjoy more economic benefits. Tinubu make di call on Wednesday for State House, Abuja, when e meet NLNG Board members wey  di company Managing Director and CEO, Adeleye Falade carry come. Baba Seyi say NLNG must look beyond making money […]

todayAugust 27, 2026 28

OBODO NAIJA

FG Launch 100 Electric Buses for Civil Servants

By: Kofoworola Olayinka Federal Gornment don commission 100 electric buses on Wednesday for Eagle Square, Abuja, to ease transport wahala and improve welfare of federal civil servants. Head of Civil Service, Didi Walson-Jack, say di buses na major step to improve worker welfare under di Renewed Hope Mass Transit Programme. Di first phase get 37 buses out of di 100 approved, with di programme designed to provide better and more […]

todayAugust 26, 2026 16

OBODO NAIJA

Plateau Troops Rescue Two Kidnap Victims

By: Kofoworola Olayinka Troops of Operation ENDURING PEACE don rescue two kidnap victims for separate operations inside Bassa and Kanam Local Gornment Areas of Plateau State. Joint Task Force Media Information Officer, Captain Chinonso Oteh, confirm di rescue on Wednesday, say di operations na part of ongoing security efforts across di state. Di task force say dem carry out di operations to stop terrorists from moving freely and carrying out […]

todayAugust 26, 2026 20

OBODO NAIJA

ADC Chieftain Tell Wike to Warn Kuje Chairman Over Threat

By: Kofoworola Olayinka ADC chieftain, Okai Austin, don ask FCT Minister Nyesom Wike to caution Kuje Area Council Chairman, Samuel Shekwolo, over comments wey e describe as dangerous and divisive. Okai make di call on Wednesday for Abuja after one viral video allegedly show Shekwolo threatening to deal with people wey dey criticise am for social media. Di Kuje chairman also allegedly tell residents wey no support APC to comot […]

todayAugust 26, 2026 15

OBODO NAIJA

Ogun Introduce Rent-to-Own Housing Scheme for Residents

By: Mariam Ajayi Ogun State Gornment don introduce Rent-to-Own housing scheme to make house ownership easier and create jobs for artisans across di state. Commissioner for Housing, Jamiu Omoniyi, disclose dis during an X Space on Tuesday, say di scheme go help tackle high construction costs and inability to pay for houses at once. Gornment dey partner Gateway Mortgage Bank on Prince Court Estate, Kobape Phase IV, where residents fit […]

todayAugust 26, 2026 19

OBODO NAIJA

Umahi Blasts Benin-Asaba Road Company

By: Kofoworola Olayinka Di Federal Gornment don say e go check all di roads wey private company dey manage across di country, to make sure say dem dey do wetin dem promise and make things easier for Nigerians. Works Minister, David Umahi, tok dis yesterday when e visit Benin-Asaba road to see di situation by imself. E blame di company wey dey handle di road, BAECC, say dem no do […]

todayAugust 26, 2026 15

OBODO NAIJA

VeryDarkMan Accuse Security Operatives Say Dem Be Di ‘Unknown Gunmen’

By: Mariam Ajayi Social media critic, Martins Vincent Otse, wey pipu know as VeryDarkMan, don accuse Nigerian security operatives of being behind di ‘unknown gunmen’ wey dey cause insecurity for di country. VeryDarkMan make di allegation on Tuesday while im dey talk for di 2026 NBA Annual General Conference for Port Harcourt, Rivers State. E claim say military, immigration and customs officers fit dey behind some of di attacks, despite […]

todayAugust 26, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds