OBODO NAIJA

770 Results / Page 19 of 86

Background

OBODO NAIJA

How Oshiomhole Lead Protest When Obasanjo Comot Fuel Subsidy.

By: Mariam Ajayi Edo North Senator, Adams Oshiomhole, don recall how e organise residents for Ogun State to protest against fuel subsidy removal during former Presido Olusegun Obasanjo University of Lagos government. Oshiomhole make dis disclosure during national discourse wey The Companion organise for University of Lagos, as e say e fear say corruption fit swallow di money from di subsidy removal. E tok say at di time, e bin […]

todayAugust 26, 2026 15

OBODO NAIJA

Charly Boy Say No Mistake Obasanjo Laughter For Weakness

By: Mariam Ajayi Popular Nigerian entertainer, Charly Boy, don warn Nigerians say make dem no mistake former Presido Olusegun Obasanjo laughter for weakness. Charly Boy say Obasanjo no be person wey anybody suppose mess with, as e describe di former presido as fearless. For post wey e make for X, Charly Boy compare himself with Obasanjo and say both of dem dey make am laugh sometimes.

todayAugust 26, 2026 16

OBODO NAIJA

Kingibe Accuse Wike Say E Borrow Money For FCT Without Approval

By: Mariam Ajayi FCT Senator, Ireti Kingibe, don accuse FCT Minister, Nyesom Wike, say e dey take loans for Abuja without National Assembly approval. Kingibe make di allegation on Tuesday during interview with one television station, say DMO records show say loans dey taken for FCT between August 2023 and March 2026. She add say Wike never appear before Senate to seek approval for di borrowing.

todayAugust 26, 2026 16

OBODO NAIJA

IPMAN Say Refineries Revival Go Reduce Fuel Price

By: Mariam Ajayi Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria, IPMAN, don talk say bringing Port Harcourt, Warri and Kaduna refineries back to work fit help reduce fuel prices for Nigeria. IPMAN toktok pesin, Chinedu Ukadike, tok dis one during one interview with tok tok channel as debate over fuel subsidy return dey continue. E say di best way to bring down fuel price, wey dey between N1,230 and N1,299 per […]

todayAugust 26, 2026 15

OBODO NAIJA

Sowore Vow Say E Go Make Nigeria Four Refineries Work If E Win 2027

By: Mariam Ajayi African Action Congress, AAC, presidential candidate, Omoyele Sowore, don promise say e go make Nigeria four government-owned refineries work if e win di 2027 presidential election. Sowore make di promise on Tuesday during interview for one media station, where e blame corruption and mismanagement of public funds by past administrations for di refineries’ failure. E say if Nigeria fit refine crude oil locally, di country go save […]

todayAugust 26, 2026 19

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Order Make Dem Do Benin-Agbor-Asaba Road

By: Mariam Ajayi Presido Bola Tinubu don order total reconstruction of di Benin-Agbor-Asaba road and other major federal highways for Edo State and nearby areas. Minister of Works, David Umahi, give di order on Tuesday when e inspect di bad Benin-Agbor-Asaba road and apologise to motorists over di hardship wey dem dey face. Umahi also condemn di contractor wey dey  handle di road after hin accuse rain say naim dey […]

todayAugust 26, 2026 10

OBODO NAIJA

Comot If You No Go Support APC – Samuel Danjuma Shekwolo Yarn

As 2027 general election dey come near, Kuje Area Council chairman for FCT, Samuel Danjuma Shekwolo, don threaten say e go resist residents wey wan vote against di ruling All Progressives Congress (APC). For one video wey dey circulate for social media, Shekwolo say e no go allow anybody for di council work against APC or oppose Presido Bola Tinubu second-term ambition. Di chairman point to development projects wey Presido […]

todayAugust 25, 2026 20

OBODO NAIJA

Police Approve Job For Families Of 10 Officers Weh Bandits Kpai For Kebbi

Di Inspector-General of Police, Olatunji Disu, don approve recruitment of relations of di 10 police officers wey jaguda bandits kpai  for Kebbi State, after dem apply to join di force. Disu use di opportunate promise Nigeria Police Force hin no go abandon di families of any officers wey lose dia lives based on duty call. Di IGP sti promise to pay all salaries and promise wey dem make to dis […]

todayAugust 25, 2026 11 2

OBODO NAIJA

Peter Obi Say Make Gornment No Chop Subsidy Money

Di Nigeria democratic Presidential candidate, Peter Obi don distance himself for dis fuel subsidy mata say mismanagement of money by di current gorment nor mean say make Nigeria return back to subsidy. Im fire fire dis mata  during sit down tok tok inside di Nigerian Bar Association Annual General Conference for Port Harcourt, Rivers State. Di presidential candidate of NDC say hin support removal of subsidy, but gornment suppose use […]

todayAugust 25, 2026 21

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds