OBODO NAIJA

830 Results / Page 6 of 93

Background

OBODO NAIJA

Health Minister Say Make Nobody Panic For Di Ebola Mata

Federal Gornment don drop mouth ordour  say no cause for alarm, dis Ebola mata wey pipo don dey fear up and down, say na one case dem don konfam and no need to do social distancing for di obodo Nigeria. Coordinating Minister of Health and Social Welfare, Dr. Muhammad Pate,  naim porporly dis update again, say like dis na di gornment dey active untop di mata. Hin press tok  say […]

todayOctober 23, 2026 11

OBODO NAIJA

JAMB Wan Use Technology Reduce Admission Wahala

JAMB Registrar, Professor Segun Aina, tok say di board don dey use technology take make admission easier and reduce di plenty stress wey candidates dey face. E tok dis one for siddon tok with tori pipo, say dem dey arrange some settings make candidates fit follow dia admission progress without too much worry. Aina, still make am clear say JAMB no go relax dia rules, as dem still wan stop […]

todayOctober 22, 2026 13

OBODO NAIJA

Federal Gornment Tok Say Nigeria Ready to Fight Ebola

Di Federal Gornment don assure Nigerians say dem ready to stop Ebola from spreading, after emergency meeting wey happen for Wednesday, October 21, for State House, Abuja. Chief of Staff to Presido Bola Ahmed Tinubu, Femi Gbajabiamila, and Health Minister, Professor Muhammad Ali Pate, tok  say dem don start to find pipu wey meet di sick person and take steps to stop di sickness from spreading. Dem beg Nigerians make […]

todayOctober 22, 2026 10

OBODO NAIJA

FG Hail Ebola Task Force As Dem Detect Ebola Case

Federal Gornment on Wednesday don praise di Presidential Task Force on Ebola Preparedness over how dem quickly detect Nigeria first Ebola case, as dem assure Nigerians say dem fit control di disease. Chairman of di task force and Chief of Staff to Presido, Femi Gbajabiamila, tok dis one after emergency meeting for State House, Abuja, according to statement wey Special Adviser to Presido on Information and Strategy, Bayo Onanuga, sign. […]

todayOctober 22, 2026 11

OBODO NAIJA

Russia Cause Serious Blackout For Ukraine 

Russia don increase attack on Ukraine power facilities, reach western areas wey no dey experience dis kind attack before. Di attacks don cause light to go off for different parts of di country, Ukrainian officials tok on Tuesday. Di fresh attacks begin for October as cold season dey near, with Russian forces targeting power stations and electricity supply lines. Ukraine officials say Russia dey deliberately attack dia power facilities, as […]

todayOctober 21, 2026 9

OBODO NAIJA

Ebola Dey Outside, No Gum Body With Anybody

Medical doctor and professor, Oladapo Ashiru, don advise Nigerians make dem avoid handshake and hug to reduce di risk of Ebola infection. Ashiru tok dis for siddon tok on Wednesday, October 21. E explain say Ebola dey spread mainly when pesin touch body fluid of infected person wey don begin show symptoms, but e no dey spread through air like COVID-19. E urge Nigerians make dem keep distance, wash dia […]

todayOctober 21, 2026 14

OBODO NAIJA

FG Konfamate First Ebola Case for Naija

Di Federal Gornment don konfamte Naija first Ebola virus case inside Abuja after one woman, wey just return from Uganda, fall sick. Health Minister, Prof. Ali Pate, naim dey fry dis mata for Abuja, say di woman start to dey sickisickie on October 7, she go hospital on October 11 before test come konfamate di virus on October 20, 2026. Right now, di patient dey isolation center wia doctor-dem dey […]

todayOctober 21, 2026 11

OBODO NAIJA

Tinubu Tell City Boy Movement Say Nigeria Must Win 2027 Election

Presido Bola Ahmed Tinubu on Monday, October 19, for Presidential Villa, Abuja, tell leaders of City Boy Movement say Nigeria must win di 2027 election before any candidate win. Tinubu tok say dem no dey campaign for am alone, but dem dey fight for dia own future and di future na wetin e call “Renewed Hope.” E urge di group to carry di message go meet young Nigerians, as e […]

todayOctober 20, 2026 13

OBODO NAIJA

NLC Cry Say N70k Salary Nor Do Dem 

Nigeria Labour Congress (NLC) don cry out say worker dey sufferly dey dey, heavy Sapa and bad economy, even with N70,000 new minimum wage. NLC President, Joe Ajaero, fry dis tok  for Abuja as e drag gornment  say nor be wetin dem agree naim dey hapun,  price of petrol dey rise like high blood pressure. E insist say de two-week deadline wey dem give  Federal Gornment to cut  petrol price […]

todayOctober 20, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds