OBODO NAIJA

770 Results / Page 70 of 86

Background

OBODO NAIJA

TUC Explain How Naira Stability Take Dey Marry Minimum Wage

Nigeria Workers’ Day don bring fresh talk about whether salary increase really dey help workers. TUC President Festus Osifo na im yarn dis one for interview untop di spirit of workers day celebration. According Osifo wage increase and currency value dem be Ejima, must work together to improve workers’ buying power.

todayMay 1, 2026 25

OBODO NAIJA

Atiku Abubakar Question Presido Tinubu Policy

Former Vice President Atiku Abubakar, don blast di economic policies of President Bola Tinubu, say na Nigerian workers dey suffer pass. Im put dis one for im Workers’ Day message, say dis year, nor be time to celebrate but to think about how workers dey suffer. Di koko of im message be say, Atiku agree say removing fuel subsidy dey necessary, but dat, di gornment to rush am with out […]

todayMay 1, 2026 28

OBODO NAIJA

Obidient Movement Back Nigeria Labour Congress Wage Increase

Obidient Movement don show support for Nigeria Labour Congress as dem dey push make gornment increase minimum wage. Coordinator Yunusa Tanko talk for Workers’ Day say Nigerian workers na di real heroes wey dey keep di economy standing. E mention say current minimum wage na ₦70,000, but NLC dey propose make dem raise am reach ₦154,000 because of inflation and high cost of living. E come beg Federal Gornment under […]

todayMay 1, 2026 23

OBODO NAIJA

Army Begin To Touchlight Wetin Kpai Abuja NYSC Corper

Nigerian Armed Forces don begin investigate to know wetin really hapun wey lead to di kpaing of one NYSC Corper for Dei Dei, Abuja. Defence Media Operations oga, Michael Onoja, na im tuk dis one for Thursday during dia monthly briefing for Defence Headquarters, say dem go make sure say dem release di result when dem finish di investigation. Onoja still tuk say support wey come from United States don […]

todayMay 1, 2026 25

OBODO NAIJA

NEC Approve 112 Emergency call Number Fix Naija Disasters

Naija National Economic Council (NEC) wey Vice Presido Kashim Shettima dey chair, Inside dia 157th virtual meeting, don approve 112  national emergency number. Say dis one sef go  make emergency response faster and remove delay during danger or disaster time. According to di number two man, di new numbers go hellep people for anywhere for Nigeria get quick response when emergency hapun, anytime and anywhere.

todayMay 1, 2026 15

OBODO NAIJA

FG Approve N548.98bn To Rebuild Carter Bridge

Federal Gornment don approve make dem break down and rebuild Carter Bridge for Lagos, and di whole work go cost about N548.98 billion. According to report, after investigation, dem find out say di part wey dey inside water don spoil beyond repair. Minister of Works, Dave Umahi, na im announce di approval after Federal Executive Council meeting wey hapun on Thursday.

todayMay 1, 2026 15

OBODO NAIJA

Supreme Court Nullify PDP Ibadan Convention

Nigeria top court don nullify the national convention wey Peoples Democratic Party hold for Ibadan on November 15 and 16, 2025. Say with dis  judgment Tanimu Turaki branch of PDP otilor, saying dat, di Supreme Court tok say dia appeal wey dem take run di convention nor get merit. For di split decision, three justices agree say di group break court order wey Federal High Court give before di convention. […]

todayApril 30, 2026 19

OBODO NAIJA

FG Declare May 1 as workers Day Public Holiday

Federal Gornment don declare Friday, May 1, 2026, as public holiday to mark International Workers’ Day. Minister of Interior, Olubunmi Tunji-Ojo, announce di  holiday and hail Nigerian workers for dia hard work and contribution to di country. E tuk say workers effort dey very important for Nigeria growth and better development. Gornment still encourage dem make dem continue to dey patriotic, work well, and stay committed to dia duties.

todayApril 30, 2026 23

OBODO NAIJA

FG Push 30-Day Credit, Direct Fuel Sale to Save Airlines

 Federal Gornment through Aviation and Petroleum Ministries and NMDPRA don tuk say airline fuel marketers must give operators 30-day credit and also sell aviation fuel direct to dem. Dem tok dis one for executive summary wey come out Monday for Abuja, after high-level meeting wey involve FAAN, NAMA, NCAA, airline operators and fuel marketers. Di reason why dem take dis decision na to tackle serious jet fuel shortage and price […]

todayApril 28, 2026 22

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds