OBODO NAIJA

770 Results / Page 72 of 86

Background

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Hold Talk on Beta National Mata With Senate Oga Dem

Presido Bola Tinubu on Wednesday meet Senate ogas for closed-door meeting inside Presidential Villa, Abuja. According to reports, dem take serious decisions on key national issues during di high-level meeting, as dem discuss urgent matters wey concern di country. Senate Presido Godswill Akpabio na im lead di Senate team wey include Deputy Senate Presido, Barau Jibrin, Senate Leader Opeyemi Bamidele, and Minority Leader Abba Moro.

todayApril 23, 2026 18

OBODO NAIJA

FG Give Airlines Fee Discount to Fight Jet Fuel Wahala

Aviation Minister Festus Keyamo on Wednesday for Abuja talk say Federal Government don bring new plan to help airlines as Jet A1 fuel price dey rise. E yarn dis one after long meeting wey involve Petroleum Ministry people, airline operators, and oil marketers because fuel cost don too high and e fit cause flight wahala. Keyamo say Presido Bola Tinubu don approve discount on some outstanding fees wey airlines dey […]

todayApril 23, 2026 21

OBODO NAIJA

President Tinubu Vow to do Joinbodi Business with UK

Wi oga Presido, Bola Tinubu don tuk say Nigeria ready to do beta business collabo with United Kingdom stronger, especially for aviation and other areas wey go benefit both sides. Im yarn dis one when im receive delegation from British Airways, led by Richard Montgomery, for Aso Rock on Wednesday. Tinubu explain dat dis new collabo go make long relationship between Nigeria and Britain stronger, an very important for both […]

todayApril 23, 2026 28

National

JAMB Boss Ishaq Oloyede Say UTME 2026 Dey go Smooth

Registrar for Joint Admissions and Matriculation Board, Ishaq Oloyede, don clear matas say di  ongoing Unified Tertiary Matriculation Examination waka well for most parts of Nigeria. He yarn dis one for University of Ibadan CBT centre during im monitoring visit for Oyo State. According to am, na only small wahala like light issue and minor technical faults naim dem see for about 16 centres out of di nearly 980 nationwide. […]

todayApril 18, 2026 32 1

National

Edun Explain How Tinubu Economic Reforms Dey Hold Ground

Say like dis wi oga Presido  Bola Tinubu economic reforms dey show workings. According to Finance Minister Wale Edun, di reforms strong wetin nor good, steady and fit carry Nigeria enter real growth instead of just survival. Edun tuk dis one for press briefing during World Bank and IMF Spring Meetings for Washington DC. Im say since mid-2023, di reforms really help stabilise di naija economy and make am strong […]

todayApril 18, 2026 26

National

JAMB Release 2026 Result for Dia Thursday April 16 Candidates

Joint Admissions and Matriculation Board don release result for candidates wey write 2026 Unified Tertiary Matriculation Examination on Thursday, April 16, as 632,788 results don dey ready to check. For statement wey dem release Friday, spokesperson Fabian Benjamin tuk say make candidates send “UTMERESULT” go 55019 or 66019 with the same number wey dem use register take check their score. JAMB talk say for now, na only to view result […]

todayApril 18, 2026 48

National

FCCPC Clear Air Say Airtime Borrowing Still Dey, No Ban At All

FCCPC don come out tuk on Friday for dia official X page say dem never ban airtime borrowing or data advance anywhere for Nigeria, as viral social media posts bin dey claim. Di Commission say those reports na false and misleading. Dem explain say people still fit use all telecom value-added services normal, and dat nothing don change.

todayApril 18, 2026 30

National

Police Arrest 7 Suspects for Benue Kidnap Case

Security operatives for Benue State don arrest seven suspects wey dem link to di kidnapping wey hapun for Otukpo Local Government Area. Police PRO, Udeme Edet, naim dey konfamate  di mata for statement wey dem release on Friday. Recall say, di attack hapun on Wednesday when gunmen stop one Benue Links bus, rob di passengers and carry some of dem enter bush. Police tuk say na 14 people dem kidnap, […]

todayApril 18, 2026 52

Lagos

First Lady Insist Say Na Unity, Love And Respect Go Push Nigeria Forward

First Lady, Oluremi Tinubu again don press tuk  say national development go only work, when citizens joinbodi share values like love, tolerance, peace, sacrifice, compassion and service to humanity. She yarn this one on Friday for wia  she go do inauguration of Odo-Noforija Ultra-Modern Central Mosque for Epe, Lagos State. She no dey there physically, she send message through her Senior Special Assistant on Public Affairs and Strategy, Wahab Alawiye-King […]

todayApril 18, 2026 82

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds