OBODO NAIJA

770 Results / Page 71 of 86

Background

OBODO NAIJA

Naija New Housing Minister Promise Affordable Houses

Di new Minister of Housing and Urban Development, Muttaqha Darma, don promise say im go use teamwork take solve Nigeria housing shortage and make houses more affordable. E tuk dis one for handover ceremony wey happen for Abuja on Monday evening. Darma say im administration go work closely with all important pipo for di housing sector to fit achieve better results.

todayApril 28, 2026 19

OBODO NAIJA

Bandits Kpai 11, Injure 2 for Gurbi Community for Katsina

For Katsina State, some Jaguda boys, oyinbo dey call dem suspected bandits don go attack Gurbi community for Kankara LGA, kpai eleven pipo and wunjor two others. Police spokesman Abubakar Sadiq na im dey konfamate dis mata, say once dem receive distress call, joint security team with police and military quickly move go di area. Dis attack happen around 2:40pm on April 26, 2026, as di gunmen enter di zanga, […]

todayApril 28, 2026 18

OBODO NAIJA

How Gunmen Kpai 29 Pipo for Adamawa Community

Say nor be small badness yesterday, as Gunmen attack Guyaku and Telabala communities for Gombi LGA of Adamawa State, kpaing nothing  less than 29 pipo. Witness tuk say di attackers enter during one football match for primary school around 5pm Sunday, begin shoot anyhow, pipo begin run for safety. Di gunmen no stop for there, dem still burn some religious buildings, while residents cry for di loss of dia family […]

todayApril 28, 2026 22

OBODO NAIJA

Tinubu Tell New Ambassadors to Improve Naija Image

Wi oga Presido Bola Tinubu don tell Nigeria new ambassadors and high commissioners say make dem work hard to improve how world pipo go dey see Nigeria. Di Presido tuk dis one on Monday for induction programme wey hapun for Ministry of Foreign Affairs for Abuja. George Akume, wey be Secretary to di Gornment of di Federation,  na im represent am tuk for dis event. E still ask dem to  […]

todayApril 28, 2026 16

OBODO NAIJA

Atiku Abubakar, Rabiu Kwankwaso Show Face for Opposition Leaders Summit for Oyo.

Opposition political leaders don gather for Ibadan, Oyo State, for national summit wey aim to strengthen unity and coordination among parties for Banquet Hall, Oyo State Government House. For statement wey dem drop for PDP official X page, organisers talk say di meeting na strategic move to tackle di challenges wey dey face di country. Oda politicians like Former Vice Presido, Atiku Abubakar and Former Kano Govo, Rabiu Kwankwaso also […]

todayApril 25, 2026 33

OBODO NAIJA

Police Rescue Two-Year-Old Pikin Wey Jaguda Boys Carry for Kano

Kano State Police Command don rescue one two-year-old boy wey jaguda boys carry, dem still grab three suspects and recover ₦930,000 from di ransom wey family pay. Police tuk dis one for statement wey dem drop on Saturday, wey Police PRO Abdullahi Kiyawa sign, as e break down how di pikin take miss and how police track di matter use correct informate go bring am back. Kiyawa talk say di […]

todayApril 25, 2026 23

OBODO NAIJA

Senator Oluremi Tinubu Launch Federal Government Industrialisation Programme for Kano

Senator Oluremi Tinubu don launch “Energise Commercialisation Now” programme, wey go help turn research ideas to real money and industry for Nigeria on Thursday for Kano State. Di initiative na Federal Government plan to push innovation, attract investors, and boost production for all six geo-political zones. Di event wey carry theme “From Innovation to Industry” dey try close gap between ideas for school and research centres and how dem go […]

todayApril 23, 2026 15

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Ask Senate Make Dem Approve Fresh $516.3m Loan

Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don ask Senate make dem approve fresh $516.3 million loan from Deutsche Bank to take finance one road project. Di request dey inside letter wey dem read during plenary on Thursday to Senate Presido, Godswill Akpabio. According to di letter, di loan go fund Sections 1, Phase 1a and 1b of Sokoto–Badagry Superhighway, one major road project of about 1,000km, with 120km for current […]

todayApril 23, 2026 24

OBODO NAIJA

Soldiers Push Back Attack for Yobe, Kpai 24 Jaguda Boys

Operation Hadin Kai Troops don fire back as jaguda boys try attack dem for midnight for military base inside Kukareta, Yobe State, as dem kpai 24 of di jaguda boys. Di gbege start early Thursday and e last for about three hours before soldiers overpower di jaguda boys. Media Information Officer for Joint Task Force, North-East Operation Hadin Kai, Lt. Col. Sani Uba, na im confirm di matter say di […]

todayApril 23, 2026 19

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds