obodo oyinbo

135 Results / Page 14 of 15

Background

obodo oyinbo

Trump, Zelenskyy Talk Say Russia-Ukraine Peace Deal Go Soon Hapun

By: Esther Ayoola US President Donald Trump and Ukraine leader Volodymyr Zelenskyy don share update say di peace deal between Russia and Ukraine dey make sense small small after dem meet for Florida. Trump say afta im discussion with Zelenskyy and earlier call with Russian President Vladimir Putin, Moscow and Kyiv don dey agree small small to end di war. Zelenskyy tuk say di 20-point peace plan,  don  reach 90 […]

todayDecember 29, 2025 7

obodo oyinbo

Russia, US Tuk Peace But Embassy Palava Still Remain

By: Esther Ayoola Russia and America diplomats don meet to tuk about some wahala wey dey spoil dia relationship, but Russia say big big issues never settle yet. According to report, Dem tuk say di meeting na about embassy problem, and another round go happen early next year. Russia also tuk say dis discussion no get anything to do with di Ukraine war.

todayDecember 23, 2025 5

obodo oyinbo

Israeli Soldiers Go Kill Two Men For Gaza Spoil Ceasefire

By: Esther Ayoola Israeli forces don kill at least two Palestinians for Gaza strip as ceasefire no dey respected and humanitarian aid still dey blocked. According to report, di two people die afta Israeli soldiers fire for Shujayea area, eastern part of Gaza city. Dis bring total number of Palestinians wey don die for di past 24 hours reach 12, including eight wey dem comot from rubble. Gaza government tuk […]

todayDecember 23, 2025 6

obodo oyinbo

US Dey Chase Venezuela Oil Tanker Over Sanctions

By: Esther Ayoola Di United States don start to chase anoda Venezuela oil tanker for international waters as part of dia pressure against President Nicolas Maduro government. Dis one come just one day afta US Coast Guard seize di second vessel near Venezuela coast within two weeks under one “blockade” wey former President Donald Trump order. One US official tell reporters say di tanker na part of Venezuela “dark fleet” […]

todayDecember 22, 2025 11

obodo oyinbo

Cambodia Put Accusa For Thailand Say Dem Drop Bomb For Dia Border

By: Esther Ayoola Cambodia Defence Ministry don accuse Thailand say dem use F-16 jet drop bomb and carry “toxic gas” for di border. Thai media tuk say two fighting hapun for Sa Kaeo province, wia fire burn house and homes for Khok Sung district. Thailand PM Anutin tuk say dem dey open to ceasefire, but Cambodia suppose stop firing first.

todayDecember 22, 2025 11

obodo oyinbo

Trump Arrange Mhen Make Dem Rename Kennedy Art Center

By: Esther Ayoola US Presido, Donald Trump omo with all bodness buy waka go rename top arts centre for Washington afta himself based on working. According to Konfam aproko wey come out, Kennedy center wey dem first name afta president John f. Kennedy, say now, dem go dey call am “Trump-Kennedy centre” afta board wey trump choose vote ama. Dis move na example of how trump dey influence big institutions […]

todayDecember 19, 2025 8

obodo oyinbo

Syria Security Man Go Kpai 3 Americans

By: Esther Ayoola Syria Interior Ministry don comot bodi from US wahala, gbebodia, yarn say, na one of dia security officer go kill two US soldiers and one civilian interpreter for Palmyra on Saturday. Di ministry talk for state TV on Sunday say, normally, dat particular officer get bad character and di man suppose comot from work because e get extremist Islamic belief. Washington sef confamate say, di jaguda boy […]

todayDecember 15, 2025 9

obodo oyinbo

Britain Economy Fall Again, Labour Dey Press For Growth

By: Esther Ayoola Britain economy don shock again as official data show say e shrink 0.1% for October afta e already fall 0.1% for September. Di office for national statistics release di numbers on Friday, and e dey dash blow to labour government wey dey hope revive economic growth. Analysts bin dey expect say economy go grow 0.1%, but di reality na contraction continue. Di only bright side be say […]

todayDecember 12, 2025 9

obodo oyinbo

Trump Wan Help Sort Thai-Cambodia Border Fight

By: Esther Ayoola Fight for Thai and Cambodia border don make ‘about 600,000 people comot from dia house, plus at least 20 people don kpai for di mata, According to officials, di wahala na because of border palava wey don dey for long time. US Presido Donald Trump, talk on thursday say, e wan yarn with Thai and Cambodia oga dem, make dem stop di fighting, sey e wan protect […]

todayDecember 12, 2025 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app