obodo oyinbo

60 Results / Page 6 of 7

Background

obodo oyinbo

US Dey Chase Venezuela Oil Tanker Over Sanctions

By: Esther Ayoola Di United States don start to chase anoda Venezuela oil tanker for international waters as part of dia pressure against President Nicolas Maduro government. Dis one come just one day afta US Coast Guard seize di second vessel near Venezuela coast within two weeks under one “blockade” wey former President Donald Trump order. One US official tell reporters say di tanker na part of Venezuela “dark fleet” […]

todayDecember 22, 2025 4

obodo oyinbo

Cambodia Put Accusa For Thailand Say Dem Drop Bomb For Dia Border

By: Esther Ayoola Cambodia Defence Ministry don accuse Thailand say dem use F-16 jet drop bomb and carry “toxic gas” for di border. Thai media tuk say two fighting hapun for Sa Kaeo province, wia fire burn house and homes for Khok Sung district. Thailand PM Anutin tuk say dem dey open to ceasefire, but Cambodia suppose stop firing first.

todayDecember 22, 2025 9

obodo oyinbo

Trump Arrange Mhen Make Dem Rename Kennedy Art Center

By: Esther Ayoola US Presido, Donald Trump omo with all bodness buy waka go rename top arts centre for Washington afta himself based on working. According to Konfam aproko wey come out, Kennedy center wey dem first name afta president John f. Kennedy, say now, dem go dey call am “Trump-Kennedy centre” afta board wey trump choose vote ama. Dis move na example of how trump dey influence big institutions […]

todayDecember 19, 2025 7

obodo oyinbo

Syria Security Man Go Kpai 3 Americans

By: Esther Ayoola Syria Interior Ministry don comot bodi from US wahala, gbebodia, yarn say, na one of dia security officer go kill two US soldiers and one civilian interpreter for Palmyra on Saturday. Di ministry talk for state TV on Sunday say, normally, dat particular officer get bad character and di man suppose comot from work because e get extremist Islamic belief. Washington sef confamate say, di jaguda boy […]

todayDecember 15, 2025 8

obodo oyinbo

Britain Economy Fall Again, Labour Dey Press For Growth

By: Esther Ayoola Britain economy don shock again as official data show say e shrink 0.1% for October afta e already fall 0.1% for September. Di office for national statistics release di numbers on Friday, and e dey dash blow to labour government wey dey hope revive economic growth. Analysts bin dey expect say economy go grow 0.1%, but di reality na contraction continue. Di only bright side be say […]

todayDecember 12, 2025 7

obodo oyinbo

Trump Wan Help Sort Thai-Cambodia Border Fight

By: Esther Ayoola Fight for Thai and Cambodia border don make ‘about 600,000 people comot from dia house, plus at least 20 people don kpai for di mata, According to officials, di wahala na because of border palava wey don dey for long time. US Presido Donald Trump, talk on thursday say, e wan yarn with Thai and Cambodia oga dem, make dem stop di fighting, sey e wan protect […]

todayDecember 12, 2025 5

obodo oyinbo

Venezuelan opposition Leader Maria Machado return After years of hiding

By: Alice Iduh Venezuelan opposition leader Maria Corina Machado don show face last last  for Oslo on Thursday after nearly one year wey she dey hide, as she win Nobel Peace Prize. Di Nobel Institute talk say Machado do “everything in her power to come to the ceremony,” say her journey  dey   dangerous,” but she reach too late to collect the prize. Machado herself tori pipo say, she dey go  […]

todayDecember 11, 2025 6

obodo oyinbo

Australia Cut Rope For Under-16s Say Make Dem Comot Social Media

By: Esther Ayoola Chai nor be small tin, say Australia  gorment don carry beta fight wey get odour  enter social media, say dem nor wan see any of dia 16 year old pikins for social media , facebook, instagram, youtube, and X on wednesday. According to the Australian gornment say dem wan take back the power from di tech sharks and dem dat, dem dey spoil dia childrensis for dem. […]

todayDecember 10, 2025 12

obodo oyinbo

US FDA Launch Big Probe Into Reported Covid Vaccine Deaths

By: Esther Ayoola Di US Food and Drug Administration don open one mata dey touchlight deaths of US citizens, wey some people claim fit relate to Covid-19 vaccines. According to report, Since Presido Donald Trump appoint Health Secretary Robert F. Kennedy,  US gorment  big overhaul of vaccine policy, and dis move don raise worry among medical experts. Kennedy tuk tuk persin  Andrew Nixon tell tori pipo  say, FDA dey run […]

todayDecember 10, 2025 16 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app