Sport Yarns

107 Results / Page 10 of 12

Background

Sport Yarns

Lookman Shine Again, As Atlético Madrid Beat Girona 1-0

By: Esther Ayoola Super eagles’ striker, Ademola Lookman, ogbonge  goal naim Atlético Madrid  take beat Girona 1-0 for Metropolitano Stadium on Sunday. Antoine Griezmann naim give am assist, and Lookman fire di ball enter net for di 21st minute of di game. Dem replace am for second half with Clément Lenglet inside 63rd minute. So far, di Naija star don score 4 goals for 11 league matches under Diego Simeone.

todayMay 18, 2026 13

Sport Yarns

Dembele Explain Why Im Dey Calm For 2026 Ballon d’Or Race

By : Jolayemi Olajide Paris Saint-Germain forward Ousmane Dembélé don drop micro soft word say e dey very calm despite di competition for di 2026 Ballon d’Or award. Di French star, wey win last edition after helping PSG win major trophies including UEFA Champions League, say individual awards no be im main focus. E explain for beIN Sports interview say team success like Ligue 1, Super Cup and Intercontinental Cup […]

todayMay 15, 2026 16

Sport Yarns

Fans boo Mbappé as Madrid win Oviedo 2-0

By : Jolayemi Olajide Supporters of Real Madrid shock many people after dem boo star striker Kylian Mbappé despite Madrid 2-0 victory over Real Oviedo. Di match happen for Spain, where Madrid secure comfortable win but some fans still show frustration over Mbappé performance during di game. Reports say di French forward struggle to impress sections of di supporters even as di team continue dia winning run. Di result still […]

todayMay 15, 2026 16

obodo oyinbo

Iran Football Federation Talk Say Dem Never Collobi US Visa Till Now

By : Jolayemi Olajide Iran Football Federation Oga, Mehdi Taj, don talk say till now, dem never issue visa give Iran national team to enter United States for 2026 World Cup. According to state media, Taj talk say dem go get crucial meeting with FIFA in di next one or two days, say FIFA must give dem clear guarantee because di visa matter never still clear. According to Mehdi Taj, […]

todayMay 14, 2026 16

OBODO NAIJA

Dangote Reveal Why E No Buy Arsenal, Choose Finish $20bn Refinery Instead

By : Jolayemi Olajide Africa richest man, Aliko Dangote, don reveal say e abandon im plan to buy Arsenal F.C. because e need di money to complete im $20 billion refinery project for Lagos. Dangote make di disclosure during one podcast interview with Nicolai Tangen, where e explain say Arsenal value na around $2 billion when e seriously dey consider takeover. Di billionaire businessman talk say at dat time, e […]

todayMay 14, 2026 33

Sport Yarns

Foden Warn Arsenal Say Many Things Fit Happen For Final Day

By : Jolayemi Olajide Manchester City star boy, Phil Foden don yarn warning give Arsenal say Premier League title race fit still go down to final match day before e clear. Foden yarn dis one with Sky Sports after dem beat Crystal Palace 3 Kondo, on Wednesday night. E yarn say, di aim na to keep pushing and to mount pressure on top Arsenal head.

todayMay 14, 2026 16

Sport Yarns

Tobi Amusan Grab Naija  First Gold for African Championships for Accra

By : Jolayemi Olajide Nigerian sprint queen Tobi Amusan don win Nigeria first gold medal for Senior Athletic Championships wey dey hapun for Accra on Wednesday. She outrun every other person for women 100m hurdles, while her fellow Nigerian Adaobi Tabugbo carry bronze medal for di same race. Na di third African Championships gold medal be this for Amusan, and Sebastian Coe personally hand am the medal. Before di race, […]

todayMay 14, 2026 13

Sport Yarns

Jake Paul Make Plans To Retire Afta Joshua Scatter Im Jaw

By: Esther Ayoola Say like dis now, Jake Paul dey plan retirement from combat sports afta di YouTuber beating from Anthony Joshua. Say di 500 wey touch back in dat December fight sti dey make im head dey shake. For dia last fight last December, Joshua knock am out brutally. Di fight leave Paul with broken jaw wey force am undergo corrective surgery. Since den, di American boxer never return […]

todayMay 13, 2026 19

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds