Sport Yarns

107 Results / Page 9 of 12

Background

Sport Yarns

Southampton Collect Ban Say Dem Spy Opponent Training Sessions

By: Esther Ayoola Southampton FC don collect punishment say dem dey spy dia opponent before match. According to independent disciplinary commission, Southampton watch training of Oxford United FC and Ipswich Town FC, and even film Middlesbrough FC before play-off semi-final. So like dis Middlesbrough go take Southampton place for championship playoff final and dem deduct dem 4 point from next season.

todayMay 20, 2026 14

Sport Yarns

Arsenal Finally Break 22-Year Jinx, Carry EPL Title

By: Esther Ayoola Arsenal Football Club don finally win di English Premier League title on Tuesday afta Manchester City draw 1-1 for Vitality Stadium. Dis na di first time for 22 years wey Arsenal go carry di Premier League trophy, afta dem don finish as runners-up for three seasons back-to-back. Manchester City bin need to win to keep di title race alive but dem fall hand beta style. Arsenal go […]

todayMay 20, 2026 13

Sport Yarns

Super Eagles To Jam Guinea-Bissau, Tanzania, Madagascar for AFCON 2027 Qualifiers

By : Jolayemi Olajide Nigeria don land for Group L as dem go face Guinea-Bissau, Tanzania and Madagascar for 2027 AFCON qualifiers. Di draw happen for Cairo, Egypt on Tuesday, and Super Eagles fans don begin expect tough matches. Nigeria don meet Guinea-Bissau plenty times before, including 2021 and 2023 AFCON competitions, while dem beat Tanzania 2-1 for 2025 AFCON. Super Eagles now go battle to secure one of the […]

todayMay 19, 2026 24

Sport Yarns

Super Eagles to Know Dia 2027 AFCON Qualifier Opponents Tuesday

By : Jolayemi Olajide Say Three-time African champions Super Eagles go know dia opponents for the 2027 AFCON qualifiers on Tuesday as Confederation of African Football dey prepare to do di official draw for Cairo, Egypt. The tournament wey dem tag AFCON PAMOJA 2027 go hapun from June 19 to July 17, 2027, and na the first time three countries, Kenya, Tanzania and Uganda, go host am together. Nigeria don […]

todayMay 19, 2026 13

Sport Yarns

PGMO Admit Man United Goal Against Forest Na Handball Error

By : Jolayemi Olajide Di Professional Game Match Officials Limited, PGMO don admit say Manchester United second goal against Nottingham Forest suppose no stand because of handball. Di controversial moment hapun for dia 3-2 win, when Bryan Mbeumo appear to touch ball with im hand before Matheus Cunha score from di rebound. Referee Michael Salisbury first allow di goal, and VAR call am make e go check pitchside monitor. Even […]

todayMay 19, 2026 18

Sport Yarns

Arsenal Near Premier League Glory As Burnley Win Put Dem 5 Points Clear

By : Jolayemi Olajide One game to go as Arsenal plan  to end  dia 22-year wait to win Premier League,  beating Burnley 1-0 on Monday and move five points clear . Kai Havertz naim score di only goal with header, but e lucky escape red card wey fit change di title race. Arsenal fit even win di league as early as Tuesday if Manchester City fail to win dia match […]

todayMay 19, 2026 17

Sport Yarns

Chisora Tuk up Moral Say Anthony Joshua Go Knock Out Fury For Four Rounds

By: Esther Ayoola British boxer, Derek Chisora, don predict say Anthony Joshua go knock out Tyson Fury within four rounds anytime, both heavyweights finally enter ring together. Chisora, wey don fight Fury three times before, tuk dis one for interview with Sun Sport. According to am, Joshua go first face Albanian boxer Kristian Prenga for Riyadh on July 25, while Fury sef go do one warm-up fight for August before […]

todayMay 18, 2026 20

Sport Yarns

Tobi Amusan Finish Third For Shanghai Diamond League Hurdles

By: Esther Ayoola Nigerian world record holder, Tobi Amusan, don sti go finish third for women 100m hurdles as 2026 Diamond League season open for Shanghai on Saturday. Amusan, wey just win gold for African Senior Athletics Championships for Ghana few days before, run season best of 12.41s. Di race na Olympic champion Masai Russell from USA win am, with meeting record time of 12.25s, while Bahamian athlete Devynne Charlton […]

todayMay 18, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds