Iran don cancel flight go Baghdad for Iraq and Muscat for Oman from midnight on Tuesday, just hours before US punishment against Iran go start.
Tok tok pesin for Iran civil aviation tell media tok tok pipo say Baghdad and Muscat airports no go accept Iran flight again, but flight to other area like Istanbul go continue normal normal.
Iran flight oga dem dey follow Iraq yarn to move Baghdad flight to Najaf, where many Iranian worshipers dey travel go, as yarnings with Oman still dey go on.
Iraq gornment never officially announce di ban, but senior man gornment official say Baghdad go follow di decision.