DONALD TRUMP

62 Results / Page 3 of 7

Background

obodo oyinbo

Trump Praise Tinubu Leadership For Letter

By: Yusuf Abuh United States President Donald Trump don write President Bola Ahmed Tinubu, praising am for wetin e call strong leadership on behalf of Nigerian people. Special Adviser to di President on Information and Strategy, Bayo Onanuga, tok for statement on Wednesday confirm di letter. According to di statement, Trump commend Tinubu for di way e dey lead Nigeria. Di full details of wetin Trump write for di letter […]

todayJuly 23, 2026 14

obodo oyinbo

Trump Promise Iran Fresh Bombing

By: Yusuf Abuh US President Donald Trump don warn say America go bomb Iranian civil infrastructure any time wey Iran go fire missile, rocket, drone or any weapon at ships wey dey pass Strait of Hormuz. Trump write for im Truth Social page on Wednesday say bridges and power plants, including some wey dey around Tehran, fit become target if any fresh attack happen. Di warning come shortly before Trump […]

todayJuly 23, 2026 16

obodo oyinbo

Fresh US attack make Tehran air defence spring into action

By : Jolayemi Olajide Fresh US strikes don trigger air defence for Tehran on Wednesday after President Donald Trump warn say e never finish with di war against Iran. US forces attack military logistics targets across Iran after fighting around Strait of Hormuz scatter earlier peace agreement and make di Middle East conflict worse. US top diplomat Marco Rubio, wey speak for ministers meeting for Manila, say America still ready […]

todayJuly 22, 2026 14

obodo oyinbo

Trump Slam 50% Tariff on Canada Goods, Trade Wahala Deepen

By: Esther Daniel US Presido Donald Trump don announce 50 percent tariff on plenty goods wey dey come from Canada, say na because Canada no dey treat American cars, dairy products and alcohol fairly. Di new tariff go affect items like wine, hockey sticks and cement, but energy, critical minerals, potash and fish no go join. Di announcement come on Tuesday, and di White House say di new import duty […]

todayJuly 21, 2026 17

obodo oyinbo

Trump Knock Tuchel Over England World Cup Exit

By: Esther Daniel US President Donald Trump don condem England coach Thomas Tuchel over di team 2-1 loss to Argentina for di 2026 FIFA World Cup semi-final. Trump say Tuchel make big  mistake wey im move captain Harry Kane into a defensive role after England score first. According to am, di decision give Argentina chance to take over di game and score two late goals to qualify for di final […]

todayJuly 20, 2026 18 2

obodo oyinbo

Iran Attack US Bases for Gulf Region Again

By Esther Daniel Iran don launch fresh attacks on US military bases for Jordan, Kuwait and Bahrain, as America still carry out overnight airstrikes on different locations inside Iran. US military say di strikes na to weaken Iran ability to threaten ships wey dey pass through di Strait of Hormuz. US President Donald Trump don warn Iran say make dem return to negotiation or face more military action. But Iran […]

todayJuly 16, 2026 12

obodo oyinbo

Human Rights Groups Sue Trump Over ICC Sanctions

By Esther Daniel One human rights group, DAWN, and Taxpayers Alliance Against Genocide don sue President Donald Trump administration over sanctions wey dem place on International Criminal Court (ICC). Dem say the sanctions dey stop Americans from supporting human rights work and talking freely about Palestine matters before the international court. Di case still argue say the sanctions break U.S. law because the president no get power to use sanctions […]

todayJuly 15, 2026 21

obodo oyinbo

America, Iran To Restart Peace Tuk Despite Ceasefire End

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido,  Donald Trump don drop micro soft word  say America go continue peace tuks with Iran, even as after dem announce say cease fir don end. Trump tok dis one for im Truth Social page, wia e make am clear say di truce no dey again. E also blast Iranian leaders, call dem "bad pipo," and say na dem go decide whether dem go return […]

todayJuly 10, 2026 17

obodo oyinbo

Iran Warn Trump Say Dem No Go Reach Agreement If Threat Continue

By : Jolayemi Olajide Iran Foreign Minister Abbas Araghchi don warn Donald Trump say if dem continue dia threat, dem go stop peace talks. Im tuk dis one give tori pipo on Monday, after report say, Trump America  dey plan force di peace  agreement with Iran. Iran dey insist say, nor be everything dem go use force, but if US insit dem go give dem hot, hot.

todayJuly 7, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds