OBODO NAIJA

Trade Minister Say Prosperity Don Start to Flow for Nigeria

todayNovember 12, 2026 6

Background
share close

Minister of  Trade, Industry, and Investment Dr Jumoke Oduwole, don tok say prosperity don start to dey show for Nigeria Economy.

She make dis statement for one television siddon tok on Wednesday, November 11, 2026.

Oduwole say she sabi wetin she dey talk because na her ministry dey handle trade and investment matter for di country.

She also stand gidigba behind Presido Bola Ahmed Tinubu plan to change di way Nigeria economy dey run.

She maintain say di changes wey Gornment don make, don help to steady di economy and bring better result.

But she admit say many Nigerians still dey face high cost of living.

She say di country still get work to do before pipo go begin feel di full benefit of di changes.

Written by: Jolayemi Olajide

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds