News-edi 1

2593 Results / Page 98 of 289

Background

Lagos

Lagos CP Fatai Tijani Beg Police Job Applicant to Round up Screening

Oga Commissioner of Police for Lagos State Command, Fatai Tijani, don dey ginger boys wey  apply for di 2025/2026 Police Constable Recruitment Screening, to sharpaly  finish dia screening before Saturday deadline. E yarn dis one on Thursday as e visit screening centre for Police College, Ikeja, where e go check how di exercise dey go and ensure say everything dey follow di rules. Say, di Commissioner also meet officials from […]

todayApril 17, 2026 22

Sports

D’Tigress Enter Seed 2 for Women Basketball World Cup Draw

Nigeria women's national basketball team don land Seed 2 for 2026 FIBA Women's Basketball World Cup draw wey go happen for Berlin on April 21. Say like dis, dem fit jam strong teams like USA, Germany, France or Australia wey dey Seed 1. Other Seed 2 teams na China, Belgium and Spain, while Seed 3 get Japan, Puerto Rico, Italy and South Korea. Seed 4 include Turkey, Czech Republic, Mali […]

todayApril 17, 2026 21

Sports

AFN Presido, Tonobok Open Door for Ofili Return After Switch to Turkiye Jam Rock

AFN President Tonobok Okowa say like dis Favour Ofili still get chance to represent Nigeria after World Athletics reject her move to switch nationality to Turkey. Di decision hapun for World Athletics headquarters when dem review di application wey Turkey Athletics Federation submit, and dem finally turn am down for 2026 after checking all the details. Ofili bin apply for di switch around May 2025 because she no dey satisfied […]

todayApril 17, 2026 28

Sports

Sporting Lagos Climb Back to NPFL After Late 1-0 Win Over Osun United

Sporting Lagos don secure dia return to Nigeria Premier Football League (NPFL) after dem beat Osun United 1-0 for Ileogbo, Osun State. Na Alex Leme score di only goal, while goalkeeper Clinton Lawal make serious key saves wey help dem hold di win. Dem finish top for NNL Conference B with 36 points, just one point ahead of Akwa United wey get 35 points. Na dat win make sure say […]

todayApril 17, 2026 80 1

obodo oyinbo

Armed Robbers Strike Naples Bank, Hold 25 Hostage for 2 Hours

Say Three masked armed robbers enter a Credit Agricole bank for Naples, Italy on Thursday rob wetin nor good for dia. According to a police source, dem carry out the robbery for safe deposit boxes. Say di robbers, take about 25 customers and staff hostage inside the bank, as dem force control person  to search for money and valuables. According to Naples Prefect Michele di Bari, di robbers later escape […]

todayApril 17, 2026 18

obodo oyinbo

Lebanon Ceasefire Start officially as US, Iran prepare for Peace Deal

Lebanon dey celebrate today Friday say, US State Department don  announce 10-day ceasefire wey go allow Israel and Lebanon officials sit down negotiate permanent peace and security agreement. Di US Presido, Donald Trump  also tuk say, di deal to end di war with Iran dey very close, and say negotiations fit resume this weekend. Iran Foreign Ministry, according to Iranian state media, don also konfamate di update, welcoming di ceasefire […]

todayApril 17, 2026 22

National

President Tinubu Tuk Why Im Nor dey Fear for Di 2027 Election

Wi oga Presido, Bola Tinubu don scata mouth again oh,  say e no dey fear any opposition, as e describe dem as pipo wey just dey make noise and wey nor understand law. E yarn dis one during meeting with Renewed Hope Ambassadors leaders from all 36 states for State House, Abuja on Thursday. Say Na oga of APC govos group, , Hope Uzodimma, wey be DG of the ambassadors, […]

todayApril 17, 2026 27

National

Wike Blast Atiku, Call Am Serial Election Loser

FCT minister Nyesom Wike don blast former VP Atiku Abubakar, call am serial contestant wey dey always lose election. Dis one come after Atiku tuk  for interview say 2027 go be im last chance to run for president and label Bola Tinubu gornment as di worst. Na wia  Wike go inspect project for Abuja, wike take answer  Atiku, say di former vice presido  norbi sincere man, with wetin e tuk […]

todayApril 17, 2026 30

National

APC Chairmo, Yilwatda Press Tuk on Party Structure

APC National Chairmo, Nentawe Yilwatda, don clear mata say  nothing spoil  if more politicians  join di  APC  from opposition side. Im yarn dis one For one media chat wey happen for Abuja, Yilwatda say APC get solid system to manage different interests as membership dey grow. E still add say the party don already prove say dem sabi handle problems, so size nor mata at all.

todayApril 17, 2026 31

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds