News-edi 1

1461 Results / Page 11 of 163

Background

Sports

Maryam Usman Become Di First Nigerian Wey Enter Di Controversial Drug Enhanced Games

By: Rilwan Agbomeji Maryam Usman don become di first Nigerian wey dem don confirm say go compete for di new Enhanced Games wey allow athletes use performance-enhancing drugs. Di Games, wey Australian businessman Aron D’Souza start, go hold for May 24, 2026 for Resorts World, Las Vegas. Maryam na 35-year-old weightlifter wey don represent Nigeria for three Olympics and even win bronze medal for 2008 Olympics. She still get four […]

todayJanuary 22, 2026 6

National

How Govnor Ododo Scarra Terrorist Hideouts For Okene

By: Rilwan Agbomeji Kogi State Govo, Usman Ododo, dey vex wetin nor good say im nor wan use im two korokoro eyes see any jaguda for im state, so like dis im don order make security go pull down all terrorist hideouts for Okene Local Govment Area, say like dis security pipo don buy waka  destroy one suspected ISWAP camp for Sambel, Idoji. As security sources tuk, say extremist activities […]

todayJanuary 16, 2026 7

National

Oyedele Repeat Tuk Say Small Investors No Go Pay Capital Gains Tax

By: Rilwan Agbomeji Chairmo of di Presidential Committee on Fiscal Policy and Tax Reforms, Taiwo Oyedele, don share update, say na small investors for Nigeria go gain from di new tax law wella. E yarn dis one for di Cowry Quarterly Economic Discourse wey hapun on Thursday, say anybody wey sell asset wey no pass N150m and gain no pass N10m for 12 months dey automatically nor go pay tax. […]

todayJanuary 16, 2026 8

foreign

UN Hold Emergency Meeting On Top Protest For Iran

By: Rilwan Agbomeji United Nation Security Council don hold emergency meeting, say di kpai kpai, wey pipo dey kpai for Iran protest dem nor like am at all, at all. You sabi say, US Presido Donald Trump sti tuk for dis mata, even threaten to use military for di country. Iran UN deputy envoy talk say Iran no wan fight, but dem go respond if US start wahala, and accuse […]

todayJanuary 16, 2026 13 18

Sports

Adesanya Plan Return For March 28 To Face Joe Pyfer

By: Rilwan Agbomeji Former UFC middleweight champ Israel Adesanya don dey do jim jim di bodi to return back to Octagon  for March 28, wia im go show power against 15th-ranked Joe Pyfer. According to aproko pipo, Adesanya dey take dis fight very serious, as e dey on three straight losses, while Pyfer dey come with three wins back to back. Adesanya tuk say, for now, no be to collect […]

todayJanuary 16, 2026 9

Sports

BUA Chairman Go Still Pay $500,000 Pledge To Super Eagles Despite AFCON Wahala

By: Rilwan Agbomeji BUA Group chairman Abdulsamad Rabiu don confirm say e go still pay di promised $500,000 to Super Eagles even though dem no win AFCON 2025. Di billionaire announce am Thursday for im official Instagram page, where e hail di national team for dia determination and teamwork throughout di tournament. Rabiu talk say di players show serious grit and commitment for pitch, and even if di trophy no […]

todayJanuary 15, 2026 9 5

Sports

AFCON 2025: Super Eagles Go Train For Casablanca Ahead Egypt Clash

By: Rilwan Agbomeji For AFCON 2025 marras, Super Eagles don turn focus go di third-place match against Egypt afta dem lose 4–2 on penalties to host Morocco for semi-final wey happen Wednesday night. Na for Casablanca dem land on Thursday afternoon, as Naija prepare to face di Pharaohs of Egypt for bronze medal clash. As dem reach, team schedule recovery training for 6:30pm to cool body and reset mind afta […]

todayJanuary 15, 2026 10 3

foreign

London Fit Lose Plenty Jobs Because Of AI – Mayor Talk Am

By: Rilwan Agbomeji For London on Thursday, Mayor Sadiq Khan don warn say artificial intelligence fit cause serious job loss for di city, as e talk say capital dey face era of mass unemployment if care no take. Khan yarn dis one ahead of speech wey e go deliver later di same day, where e go break down how AI dey affect jobs for UK capital, especially finance, professional services […]

todayJanuary 15, 2026 7

National

Jaguda Boys Free Edo Doctor Afta N50m Ransom Reach Dia Hand.

By: Rilwan Agbomeji Dr Ibrahim Tahir, don free after im family pay N50 million ransom to di jaguda boys wey carry am for Edo State. Di wahala start for January 2, 2026, when Tahir and im younger brother dey open gate for dia  compound for City Pride Road, Igbira Camp, Auchi, na so jaduga boys carry dem go. Unfortunately, di jaguda boys kill di younger brother, come drop im bodi […]

todayJanuary 15, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app