News-edi 1

2592 Results / Page 10 of 288

Background

OBODO NAIJA

IGP Disu Beg Nigerians Make Dem Stop Recording Police

Di Inspector-General of Police, IGP Tunji Disu, don warn Nigerians make dem stop to record police officers while dem dey work and turning dem to skit content, saying e dey discourage officers. Disu talk dis for press conference for Abuja, saying police officers need full concentration to do dia work, even as e acknowledge say Nigerians get constitutional right to record officers wey dey perform public duties for public places. […]

todaySeptember 10, 2026 11

OBODO NAIJA

Peter Obi Talk Say E No Need 100 Years To Fix Nigeria

NDC presidential candidate, Peter Obi, don talk say e no need 100 years to put Nigeria back on di right track, as e insist say di country dey go wrong direction now. Obi, wey promise say e go spend only one term as Nigeria Presido, talk dis on Thursday during interview with one tuk tuk station, saying e no desperate to become presido. E say once e enter office, e […]

todaySeptember 10, 2026 13

south west

Ogun Police Tell Students Make Dem Reject Cultism And Crimes

Ogun State Police PPRO, DSP Oluseyi Babaseyi, don warn Nigerian students make dem reject cultism, drug abuse, violence and cybercrime, say wetin dem choose today go affect di future of di country. Babaseyi give di warning on Thursday while e dey speak for 45th Students Parliament Council Summit wey Federal College of Education, Abeokuta organise. E say school no be only place to read books and collect certificate, but na […]

todaySeptember 10, 2026 16

Lagos

LAWMA Gbab Woman For Alleged Waste Dumping Inside Gutter

LAWMA don arrest one woman for Meiran, Lagos, after dem accuse her of dumping refuse inside drainage channel while rain dey fall. Di arrest come after video of di woman go viral online, showing her dey bring waste comot from her house and allegedly throw am inside nearby drainage during rainfall. LAWMA carry out di arrest together with KAI and Mobile Police, as dem move against people wey dey turn […]

todaySeptember 10, 2026 13

Sports

Lamine Yamal React As Dembele Snub Am

Barcelona winger Lamine Yamal don react after Ousmane Dembélé no include am among im top three players for Ballon d’Or. Yamal jokingly ask whether Dembélé friendship with Kylian Mbappé fit get anything to do with di decision. Yamal make di comment after football transfer expert Fabrizio Romano post am for X on Wednesday. With smile, Yamal talk say, “Na Kylian Mbappé padi e be, abi?” But Yamal say e no […]

todaySeptember 9, 2026 16

Lagos

Nigeria Start New TV Audience Measurement System for Lagos

Nigeria don start new system to measure how people dey watch television for Lagos, using special People Meters wey go record di channels and programmes viewers dey watch. Di initiative na joint project of NBC and ARCON, wey appoint First Media Entertainment Integrated Limited, FMEIL, in partnership with First Media Entertainment Integrated Limited to run di system and select panelists. Di FMEIL/GARB chairman, Rotimi Pedro, say di project don dey […]

todaySeptember 2, 2026 22

Sports

Chelsea Break World Record as Dem Sell Players

By: Ayobami Dada Chelsea don spend £328 million to sign 10 first-team players dis summer, but dem make £519 million from player sales and loan fees. Dis mean say, according to di club internal figures, Chelsea net spend na minus £120 million, meaning dem make more money from sales than dem spend on new players. Di biggest deal na Enzo Fernandez, wey move go Manchester City for £125 million, making […]

todaySeptember 2, 2026 14

Lagos

Lagos Police say di tear-gas picture of pensioners for alausa na AI

By: Ayobami Dada Lagos Police don deny report say dem fire tear gas on pensioners during dia protest for Alausa on Monday, August 31. Police say about 500 pensioners gather peacefully, while security operatives dey maintain order, dem no fire any tear gas. Di Command say after government officials address di protesters, NUP executives hold meeting before dem peacefully comot around 4:30pm. Police also yarn say di viral photo wey […]

todaySeptember 1, 2026 17

Entertainment

Must Read: 2Baba and Annie Break Up Story

By: Kofoworola Olayinka   Sometimes, love fit real, di memories fit sweet, di children fit precious, but somehow, di marriage still fit scatter for ground. Check 2Baba and Annie Idibia tori from start to finish, you go understand wetin we dey yarn for here and why dia breakup pain plenty pipo. According to reports, 2Baba and Annie meet around 1999/2000 for Lagos wen dem start as padi. By 2004, Annie […]

todayAugust 31, 2026 22

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds