News-edi 1

1466 Results / Page 14 of 163

Background

foreign

French Far Right Politician, Marine Le Pen Face Court Appeal

By: Rilwan Agbomeji Marine Le Pen, wey be far-right French politician, say go nor appeal court decision wey ban her from public office for five years. U sabi say, dem find her guilty last year say she embezzle EU money, but she talk say she never do any wrong. If court hold di ban, she no go fit run for 2027 presidential election. Jordan Bardella, wey be her party president, […]

todayJanuary 13, 2026 7 3

National

How Jaguda Boys Do Warling Film For Obajana Police HQ

By: Rilwan Agbomeji Say nor be small war start film play for Obajana Police Divisional Headquarters for Kogi State, dat jaguda boys enter di area and begin shoot wetin nor good kill one civil defence guide, but last last face and scata dem. Several security personnel and vigilante members sustained gunshot wunjor for di mata oh. Resident say di mata wey sup from Sunday to Monday night nor allow dem […]

todayJanuary 13, 2026 7 2

foreign

Iran Minister Drop Yarns Dat Iran Nor Go Legbere For Anybody

By: Rilwan Agbomeji Iran Foreign Minister Abbas Araghchi, once again don tuk oh, say Iran ready for war if America wan “test” dem. Dis dey come afta US President Trump warn say im fit use military over Iran protests. Protests start over money wahala but don grow to big calls for system change. Ontop interview with tori pipo,  E say tuk channels with US still open but Iran military strong […]

todayJanuary 13, 2026 5 3

Sports

Dan Evans, Oda Brit Tennis Players Chop Defeat For Australian Open

By: Rilwan Agbomeji Great Britain tennis player, Dan Evans go fall hand for Australia, fail to reach Australian Open main draw. Im go lose inside first round for qualifying phase wey sup for Melbourne. Na so im service weak like dodo, lose 6-1, 6-2 to Japan player Rei Sakamoto. Oda Britons, Jay Clarke and Jack Pinnington Jones, also lose straight sets, and Oliver Crawford lose 6-3, 2-6, 6-3 to Spain […]

todayJanuary 13, 2026 10 3

Lagos

Lagos Gorment Release Plan For Waterside Business

By Ebi Oboko Lagos State  gorment don release new plan say, dem wan turn all   watersides for  di state to beta business wey go bring state  money. Based on yanings with tori pipo,  Di  Commissioner for Waterfront Infrastructure Development, Dayo Alebiosu, tuk say, dis new policy go hapun dis  2026 and say, e show beta workings for  2025. Before now, say  people dey buy land dem for di waterside, dem […]

todayJanuary 12, 2026 14 4

National

Wike Challenge Haters to Tell Tinubu to Sack Am

By Ebi Oboko FCT Minister, don tell im haters say make dem dey dia dey,  say, na only President Bola Tinubu get power to sack am from im cabinet, not people wey dey criticize am. Di minister yarn this one on Sunday when e go Obio/Akpor LGA for Rivers State for the last part of im “thank you” visit. Wike say if Tinubu feel say e no get anything to […]

todayJanuary 12, 2026 15

foreign

Iran Presido, Pezeshkian Promise to Listen to Protesters

By Ebi Oboko Iran presido, Masoud Pezeshkian, don bow to pressure,   say  dem go  rearrange di iran economy wey dem spoil, dey warn protesters to be calming down. Pezeshkian dey beg for tv sit don tuk, say make di protesters nor go do until  “rioters” and “terrorist elements”  con take over di mata, say dat one  go be big  wahala. The protest don enter third week after market people for […]

todayJanuary 12, 2026 13

Sports

El Clasico Final: Barcelona Conquer Real Madrid 3-2

By Ebi Oboko Barcelona don go beat  Real Madrid 3-2 for El Clasico for Spain Super Cup final for Saudi Arabia, ni dem run dis one. Raphinha shine shine bobo, score two goals for  di Catalan side. Barcelona  wey dey top La Liga  qualify for di final afta dem hammer Real Betis 5-0 for semifinal. Real Madrid beat Atletico 2-1 for di second semifinal before dis final. Last year, Barcelona […]

todayJanuary 12, 2026 19 5

Sports

Super Eagles To Buy Waka To Rabat For AFCON Semis

By Ebi Oboko Unto update for AFCON, say Super Eagles go waka from Fes go Rabat on Monday afternoon for dia semi-final match wey dem go play against AFCON 2025 host Morocco. Team media officer Promise Efoghe na im yan one. On Sunday, Super Eagles don return Fes and dem do recovery session by 6:15pm for Saardienne football complex. Now, all the players and officials go travel to Rabat,  ready […]

todayJanuary 12, 2026 16 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app