News-edi 1

1361 Results / Page 14 of 152

Background

National

Amotekun Catch 39 Sokoto Jaguda Pipo For Ondo Forest

By: Rilwan Agbomeji Amotekun for Ondo State don catch 39 people wey dem say na from Sokoto State, wey dem hide for forest afta US-backed military strike against ISIS for North. According to report, say dem catch dem for Elegbeka area for Ose Local Govment, wey don long dey known as place wey bad people dey. State Commander, Adetunji Adeleye, talk say dem dey hide for forest, and dia cars […]

todayDecember 30, 2025 7

National

Court Arrange Room For Former-Agf Malami, Pikin And Wife For Kuje

By: Rilwan Agbomeji Federal High Court for Abuja don order make dem remand former Attorney-General of di Federation, Abubakar Malami, for Kuje Correctional Centre. Di court also send im pikin and one of im wife, Bashir Asabe, go Kuje prison pending when dem go hear dia bail matter. Justice Emeka Nwite give di order afta e hear argument from lawyers for both defence and prosecution. EFCC dey charge Malami and […]

todayDecember 30, 2025 12

foreign

US Don Promise Ukraine 15-Year Security Cover, Zelenskyy Yarn

By: Rilwan Agbomeji US offer Ukraine 15-year security guarantee as part of peace plan, Ukrainian President Zelenskyy talk on Monday. Zelenskyy yarn say e go prefer make di guarantee last 50 years to stop Russia from any further attack. US President Donald Trump host am for Florida on Sunday, talk say Ukraine and Russia dey closer to peace than before. Negotiations still dey, with wahala like who go withdraw where […]

todayDecember 29, 2025 6

National

Presido Tinubu Cancel Part Of NNPC Debt Worth $1.42bn And N5.57tn

By: Rilwan Agbomeji Wi oga Presido, Bola Tinubu don to cancel big part of debt wey Nigerian National Petroleum Company (NNPC) dey owe Federation Account. Dis na according to  Nigerian Upstream Petroleum Regulatory Commission talk for report wey dem present at November 18, 2025, Federation Account Allocation Committee (FAAC) meeting. Di report show say the cancellation go wipe about $1.42 billion and N5.57 trillion afta both NNPC and Federation Account […]

todayDecember 29, 2025 8

Sports

Cristiano Ronaldo Vow Say E Go Win More Trophies, Chase 1,000 Goals

By: Rilwan Agbomeji Football superstar Cristiano Ronaldo don vow for ground, say e wan win more trophies and reach 1,000 career goals before im retire finally. Ronaldo yarn dis one for Globe Soccer Awards wey hold for Dubai on Sunday, say e still get passion to play no matter where e dey,Europe or Middle East. E add say e go reach the 1,000 goals target if wunjury no worry am.

todayDecember 29, 2025 13

foreign

Trump To Meet Netanyahu For Florida To Align Gaza Ceasefire Talks

By: Rilwan Agbomeji US Presido Donald Trump wan enter meeting with Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu for Mar-a-Lago, Florida, today, to popori one or two on how dem go take address di Gaza ceasefire. Dis meeting come as US dey push Trump 20-point peace plan, even as Israel dey break di peace agreement almost every day. Meanwhile, Israel don increase attacks for West Bank, Lebanon and Syria, and some officials […]

todayDecember 29, 2025 10

Lagos

Lagos APC Go Start E-Registration For 20 Local Government Areas

By: Rilwan Agbomeji Lagos State APC don announce say dem go start electronic registration and revalidation for party members across di state. Di e-registration exercise go run from January 5 reach January 28, 2026 for all 20 local govment areas of Lagos. APC Lagos Chairman, Pastor Cornelius Ojelabi, talk dis one for end-of-year briefing with journalists for Lagos. E talk say di move dey meant to strengthen di party structure […]

todayDecember 29, 2025 10

National

Atiku Pray For Anthony Joshua Afta Road Accident

By: Rilwan Agbomeji Former PDP presidential candidate, Atiku Abubakar, don send message of sympathy to British-Nigerian boxer Anthony Joshua afta road accident happen for Makun, Ogun State, on Monday. Atiku talk dis one through im official X handle, say e pain am well well and e dey pray make Joshua recover sharp sharp. According to am, Anthony Joshua still be symbol of strength and resilience, and e sure say e […]

todayDecember 29, 2025 11

National

FG Confirm Say New Tax Reform Laws Go Start January 1, 2026

By: Rilwan Agbomeji Federal Govment don confirm say dem no go reverse di new tax reform laws wey go start on January 1, 2026. Chairman of Presidential Committee on Fiscal Policy and Tax Reforms, Taiwo Oyedele, talk dis one on Friday afta e brief President Bola Tinubu for Lagos. E add say four tax laws don sign into law, and two of dem don already start since June 26, 2025. […]

todayDecember 26, 2025 23 61

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app