News-edi 1

2355 Results / Page 143 of 262

Background

Sports

Make Fulham Forget Man City Beating — Iwobi

By: Rilwan Agbomeji Fulham winger, Alex Iwobi don fire up im boys afta dem loose 5-4 giv Manchester City for dia own house for Tuesday. Fulham Boys no come sell groundnut ooo as dem match City fire-for-fire, push dem sotay e remain small make dem thief one point comot Pep hand. Na Iwobi even light di fire as e tear net with one mad goal afta second half pass small, […]

todayDecember 3, 2025 14

Entertainment

2Baba Eye Comot Water As Marriage Gbege Grip Am For Neck

By: Rilwan Agbomeji Na wah oh! Nigerian music star, Innocent Idibia wey everybody sabi as 2Baba, don finally  open mouth talk wetin dey im mind for first time since di hot gbege with im wife, Natasha Osawaru burst everywhere for internet. For im IG tori on Wednesday, 2Baba tok say e need help, omo di message short but e carry weight wey hit body like trailer. E no finish there […]

todayDecember 3, 2025 34

National

Sowore Face Court Over Anti-Tinubu Post, Comot On Self-Recognition

By: Rilwan Agbomeji Na big gbege shele for Abuja on Tuesday as Omoyele Sowore, land Federal High Court, dey face DSS on top wetin im yarn for post on social media say President Bola Ahmed Tinubu na “criminal.” Di mata serious as DSS drag am for five counts of criminal defamation, and even Meta (Facebook) plus X Corporation (Twitter) join di hot gbege as co-defendants. DSS yarn say Sowore dey […]

todayDecember 3, 2025 26

National

Edo Assembly Don Drag 2Baba Wife Come Over Marital Gbege

By: Rilwan Agbomeji Edo Assembly don call Natasha Irobosa, Egor lawmaker, make she run go Ethics Committee within one week afta her gbege with 2Baba dey trend hot hot for everywhere. Speaker Blessing Agbebaku tok say wetin 2baba babe do dey disgrace House name and she gats clear herself. Di whole mata don turn hot gist for TV and social media.  Assembly yarn say members suppose dey behave well, no […]

todayDecember 3, 2025 23

Lagos

Lagos Govt Don Arrest 20 Street Beggars For Ketu, Mile 12

By: Rilwan Agbomeji Di Lagos State Government on Tuesday arrest 20 street beggars during enforcement for Ikosi Ketu and Mile 12 areas. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, talk say di operation na part of government plan to restore order and make sure public spaces dey used responsibly and safely. Wahab explain say KAI operatives carry out di latest enforcement around Ketu, Mile 12, Ikosi Road and di […]

todayDecember 2, 2025 42 2

Lagos

Lagos Govt Don Seal Yakoyo Abula Joint For Dirty Wastewater Dumping

By: Rilwan Agbomeji Di Lagos State Wastewater Management Office don seal Yakoyo Abula Joint Restaurant for Victoria Island because dem dey pour untreated wastewater and oil inside public drainage. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, reveal di action for im X handle. Dem shut down di restaurant on Tuesday morning afta officials see say dem dey deliberately discharge dirty water wey don block drainage and fit cause waterborne […]

todayDecember 2, 2025 20

foreign

UK PM Starmer – China Na Big Security Wahala, But Trade Still Dey

By: Rilwan Agbomeji UK PM Keir Starmer don yarn say China na gbege wahala for UK security, but im still talk say dem no fit chop Beijing belle, because money and business no dey play. Na for Monday night meeting im yarn am sharp, drag di old Conservative government say dem sidon sleep make UK–China mata turn complete yawa, with espionage gist dey scatter everywhere. Starmer remind everybody say since […]

todayDecember 2, 2025 14

Sports

Salah Go Bounce Enter Egypt Camp Dec 15 – Slot

By Rilwan Agbomeji Liverpool oga Arne Slot don burst confirm say Mo Salah go waka comot Anfield go link up wit Egypt for AFCON on December 15. Slot drop di tori before Liverpool face Sunderland, yarn say na FIFA order say December 15 na di final day wey club must release players. Egypt sef no dey dull dia AFCON camp don open and dem get friendly match wit Nigeria on […]

todayDecember 2, 2025 12

Sports

Maresca Talk Say Palmer Ready To Jam Leeds

By: Rilwan Agbomeji Chelsea Oga, Enzo Maresca don open mouth say Cole Palmer dey fit and ready to jam Leeds United for Elland Road dis Wednesday wey dey come. Maresca yarn say Palmer dey try gain im full fitness back, but di plan na to push am small-small until e fit run full 90 minutes like before. Di coach add say everybody dey okay, but Romeo still dey recover and […]

todayDecember 2, 2025 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds