News-edi 1

1354 Results / Page 3 of 151

Background

National

ADC Swear For New Chairmo To Do Constitution Review

By: Rilwan Agbomeji National Chairmo of Africa  Democratic congress, David Mark, don  go swear  Senior Lawyer,  Etigwe Uwa (SAN)  say make im do  Chairmo for di party Constitution Review Committee for Abuja. Untop marras wey sup for di party headquarters for Abuja on Thursday, Mark tell di committee make dem work framework wey go promote inclusiveness, transparency and accountability, and still follow di party original principles. Im say di party […]

todayJanuary 8, 2026 5

Sports

CAF To Run WAFCON Draw 2026 Fixtures For Morocco

By: Rilwan Agbomeji Confederation of African Football (CAF) share update say di Women African Cup Of Nations  2026 final draw go hold for Rabat, Morocco on Thursday, January 15. According to CAF official post on X, Di draw go start 2pm local time (1pm GMT) For di same day, CAF go announce winners for Women Coach of di Year, Interclub Player of di Year, and Women Club of di Year […]

todayJanuary 8, 2026 6

National

Afenifere Don Raise Alarm As Terror Attacks Dey Plenty For Yorubaland

By: Rilwan Agbomeji Afenifere, di pan-Yoruba socio-political group, don yarn say dem dey worried about di way terror attacks don increase for Yorubaland and oda parts of Nigeria. For statement wey dem release for Ibadan, di group publicity secretary, Jare Ajayi, call South-West governors make dem act on di security resolutions wey dem agree on for dia meeting on November 24, 2025. Recently, gunmen attack forest guards for Old Oyo […]

todayJanuary 8, 2026 7

foreign

Oxford English Dictionary Add Naija Words Like “Amala” and “Abeg”

By: Rilwan Agbomeji Di Oxford English Dictionary don add some Nigerian words come dia book, like “mammy market,” and “amala.” Di update, wey dem release for Wednesday, include over 500 new words, phrases, and tenses. Di dictionary say dis show how Nigerian language, culture, and food dey influence di world. Other Naija words wey dem add na “moi moi,” “abeg,” “biko,” and “Ghana Must Go,” plus internet slang like “DM,” […]

todayJanuary 8, 2026 8

Sports

FG Promise To Clear Super Eagles Bonus, Say Money Go Enter Friday

By: Rilwan Agbomeji Unto update for di Super Eagles bonus marra, say, Federal Government don  agree to  approve money for di Super Eagles match bonus wey concern AFCON 2025. Minister of State for Finance, Doris Uzoka-Anite, tuk say players go begin see di money for dia bank accounts from today or tomorrow. Before now, Super Eagles players bin threaten say dem no go travel for dia quarter-final match because allowance […]

todayJanuary 8, 2026 3

National

US Immigration Gbab Ghana Former Finance Minister Ken Ofori-Atta

By: Rilwan Agbomeji Say US Immigration don gbab Ghana  former Finance Minister, Ken Ofori-Atta, wey dem dey find am for Ghana over corruption matter. According to report, di 66-year-old man dey America since January last year for medical treatment, including prostate cancer surgery. You Sabi say, last year February, Ghana authorities declare am fugitive and later charge am for corruption for November. Im lawyers confamate di arrest, say US Immigration […]

todayJanuary 8, 2026 8

National

Dele Momodu: Atiku No Go Step Down For Obi For 2027

By: Rilwan Agbomeji One Former presidential candidate and Atiku Abubakar close friend, Dele Momodu, don clear marra, say Atiku no go withdraw from 2027 presidential race to support Peter Obi. Momodu talk dis one  on Thursday while e dey react to political talk for Nigeria, say Atiku join ADC for November 2025 afta e comot from PDP so e fit secure party ticket for 2027 election. According to am, Atiku […]

todayJanuary 8, 2026 5

National

Breaking: Rivers Assembly Start Waka To Comot Govnor Fubara From Office

By: Rilwan Agbomeji Rivers State House of Assembly don start impeachment process against Governor Siminalayi Fubara and im deputy, Ngozi Oduh. During plenary wey dem show live for Television on Thursday, Speaker Martins Amaewhule preside as Majority Leader, Major Jack, read di allegations of gross misconduct against Fubara. Twenty-six lawmakers sign the notice, say di mata involve serious wahala against di Nigerian Constitution. Amaewhule tuk say dem go serve Governor […]

todayJanuary 8, 2026 11

Sports

Adesanya Say E Nor Dey Enter Go Boxing

By: Rilwan Agbomeji UFC former two-time middleweight champion Israel Adesanya don share update on how im wan waka, say e nor go switch go boxing afta e finish for mixed martial arts (MMA). E yarn dis one during one Question & Answer session for Thailand, say e wan finish e career for UFC. Adesanya tuk say, e bin think about boxing small because of money, but e feel say MMA […]

todayJanuary 8, 2026 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app