News-edi 1

1477 Results / Page 38 of 165

Background

foreign

Australia Tighten Gun Laws Afta Deadly Bondi Shootings

By: Rilwan Agbomeji Australia don declare say dem go tighten gun laws afta one of di worst mass shootings in almost 30 years hit di country. Father and son burst Hanukkah festival for Bondi Beach on Sunday, open fire wey kill 15 people including small pikin. Crowd scatter scatter for Sydney beach, people dey run for dia life as bullets dey fly. Among di dead na 10-year-old girl, one Holocaust […]

todayDecember 15, 2025 9

Business

“Trump Dey Happy With Dangote Refinery” — Aliko Dangote

By: Rilwan Agbomeji President of Dangote Refinery, Alhaji Aliko Dangote, don calm di internet, talk say US President Donald Trump no get any wahala at allwith di $20 billion Dangote Refinery. E yarn dis while e dey react to social media gist wey scatter everywhere, wey some people begin talk say Trump no happy say Africa biggest refinery dey Nigeria. Di talk burst afta Trump threaten say im go hit […]

todayDecember 15, 2025 10

Entertainment

“Abeg Make Una Leave My Marriage Palava, Make We Face Real National Wahala” – 2Baba

By: Rilwan Agbomeji Nigerian music icon Innocent Idibia, wey people sabi as 2Baba, don call Nigerians make dem stop to dey focus on im personal life and turn eye to di serious problems wey dey worry di nation, for one live performance on December 12, 2025. As e yarn di crowd directly, di singer talk say discussion about im marriage to Edo State lawmaker Natasha Osawaru don too long, and […]

todayDecember 15, 2025 14

Sports

Lookman, Ajayi, Osayi-Samuel Reach Super Eagles Cairo Camp

By: Rilwan Agbomeji Atalanta winger Ademola Lookman,  defenders Semi Ajayi plus Bright Osayi-Samuel don touch Super Eagles camp, Cairo, to jim jim di bodi ahead of AFCON 2025. Fresh faces like goalkeeper Amas Obasogie, Tochukwu Nnadi, and Igoh Ogbu also don report for duty, ready to join di squad. Dem join forces with Francis Uzoho, Stanley Nwabali, Ebenezer Akinsanmiro, and Fisayo Dele-Bashiru, wey don already dey camp. With everybody now […]

todayDecember 15, 2025 11

National

Court Clean Room For Wi Former Minister Ngige For Kuje Prison

By: Rilwan Agbomeji Now make we comot body enter court, wia wi Former Labour Minister, Chris Ngige, deny all di 8 charges wey EFCC put for im head, for Abuja High Court and dat im carry ₦2.2 billion contract give family and friends. Di Minister say walahi im nor do anything like dat. Justice Maryam Hassan talk say make Ngige rent one room for Kuje Correctional Centre since im dey […]

todayDecember 12, 2025 16

Sports

Slot Say Im Sti Want Salah For Liverpool

By: Rilwan Agbomeji Liverpool manager, Arne Slot say  liverpool marraigae with Salah never sti finish normal, and that im go sit down Salah tuk mata as e dey be. U sabi say Salah, wey be 33 years old, vex say dem leave am out of di Champions League game against Inter Milan afta Liverpool draw 2-2 for Leeds, and e complain say e dey throw under di bus by di […]

todayDecember 12, 2025 23

National

Dangote Reduce Fuel Price Again To N699

By: Rilwan Agbomeji E nor possible e nor possible, like dis, like dis, Dangote petroleum refinery don reduce petrol deport price from n828 to n699 per litre, to make life go wiliwere for common Nigerian. Di latest reduction sharply drop (gboza for ground),  afta Chairmo, Aliko Dangote  do two aside with wi Oga Presido Bola Ahmed Tinubu package one or two on  friday, and dat, di reduction go continue go […]

todayDecember 12, 2025 17

National

APC Officially Arrange Office For Fubara As New Member

By: Rilwan Agbomeji Di All Progressives Congress for Rivers State branch, don officially set table for oga Govo Siminalayi Fubara as di newest member wey Kawasaki from di PDP to APC. Like dis like dis , di state APC Chairmo Tony Okocha carry di mata for head like say na government work dey share share di govo left, right and center on top social media , dis one happen for […]

todayDecember 12, 2025 24

National

Maryam Sanda Death Ruling Stay As E Be

By: Rilwan Agbomeji Supreme Court no change mouth, dem uphold di death sentence wey Maryam Sanda collect. Di court, for a 4–1 decision, confirm say nothing dey to change di original judgment. All di grounds wey she take appeal, dem cancel am and call di case empty. Justice Moore Adumein, for di lead verdict, confirm say prosecution show enough evidence to nail di matter.

todayDecember 12, 2025 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app