News-edi 1

2593 Results / Page 52 of 289

Background

Local

Kogi Confirm Say Dem Don Kill Bandit Wey Attack School

Kogi State Gofment don confirm say security operatives do Rambo doings kpai one notorious bandit leader, Kachala Ibrahim Batijo, wey dem say na im plan recent attack for one school for Iluke Bunu, Kabba/Bunu LGA. State Commissioner for Information and Communications, Kingsley Fanwo, tok dis one on Tuesday for Tv sit down tuk, say Batijo die during joint security operation alongside oda bandits. According to am, na di same bandit […]

todayJune 16, 2026 18

Local

How Air Force Officers Allegedly Beat Driver Die

Nor be small tin, problem dem  say nor dey finish, One 43-year-old  driver, Joseph Okpe, naim go collect beating from Nigerian Air Force officers. According to court affidavit wey im broda Innocent Okpe file for High Court, di officers accuse am say e hit dia Coaster bus and demand N100,000 compensation. Di affidavit talk say when Joseph no fit bring di money, di officers begin mama di man, dem punch […]

todayJune 16, 2026 21

Lagos

Lagos Govt Talk Say Dem Go Close Iddo Bridge For Repairs

By : Jolayemi Olajide Lagos State gornment don announce say dem go lock Iddo Bridge for Ijora area sake of repair work wey dem dey do. Di Commissioner for Transportation, Mr. Oluwaseun Osiyemi, yarn dis one for inside one statement on Tuesday. Di government talk say Federal Ministry of Works go use di time fix heavy steel beams make di bridge come strong well-well, so dem need to close di […]

todayJune 16, 2026 23

south west

Governor Adeleke ask Police to Commot Security for APC Local Gofnor Chairmen

  By : Jolayemi Olajide Osun State Governor, Ademola Adeleke, don tell the Inspector General of Police make e order im men to commot security personnel from di local gofnment chairmen wey belong to APC. Baba govo, Adeleke sorosoke dis one for Osogbo, as im ma dey touch light di Federal High Court judgement wey throway im party Accord Party and five others through window. After di judgement, na so […]

todayJune 16, 2026 21

Entertainment

Reno Omokri Reply Davido As Dia Two Clash Sake of World Cup concert

By : Jolayemi Olajide Ambassador- to Mexico, Reno Omokri, don fire back at Afrobeats star, Davido, afta di singer rain insult on am sake of comments wey Reno make about im performance for one World Cup concert. The whole wahala start as Davido perform for di FIFA World Cup countdown concert for Los Angeles. For the show, e wear one jacket wey write the names of over 40 schoolchildren and […]

todayJune 16, 2026 21

Politics

Court order police to arrest Omoyele Sowore

By  : Jolayemi Olajide Federal High Court for Abuja don order say dem must arrest AAC presidential candidate, Omoyele Sowore, sake of say im nor show face for im trial. Dem suppose start the case wia DSS charge Sowore for cybercrime, dem say e call Presido, Bola Tinubu, "criminal" for social media. Sowore bin don tell court say na im go defend imself since im lawyers don comot body for […]

todayJune 16, 2026 19

OBODO NAIJA

IGP Calm Federal Police Officers, Say State Police No Go Take Food from dia table

By : Jolayemi  Olajide Inspector-General of Police, Olatunji Rilwan Disu, don assure officers and men of Nigeria Police Force say plan to create state police no go scata or replace federal police. Im yarn dis one During im working visit to Jigawa State Police Command, According to Disu, federal police go still dey carry out dia constitutional duty of maintaining law and order across the country.

todayJune 16, 2026 26

Politics

Obidient Movement drag court on why dem wan comot 5 parties from 2027 election

By : Jolayemi Olajide Di Obidient Movement don come out strong to condem say dem wetin di Federal High Court order INEC to delete five political parties, nor make brain at all. U sabi, Justice Peter Lifu give di order on Monday, say di parties, ADC, Accord, APP, AA, and Zenith Labour nor go run for di 2027 election dat dem nor follow constitution. Na one group of former lawmakers […]

todayJune 16, 2026 17

Politics

Atiku Abubakar pick Rotimi Amaechi as running mate for 2027 presidential race

By : Jolayemi Olajide Di African Democratic Congress (ADC) don officially announce former Rivers State Governor and ex-Minister of Transportation, Rotimi Amaechi, as the vice-presidential candidate to join forces with Atiku Abubakar for the 2027 general election. Di party National Publicity Secretary, Mallam Bolaji Abdullahi, reveal dis news on Monday, explaining say dem take di decision after serious consultations wit party leaders, stakeholders, and representatives from all di six geopolitical […]

todayJune 16, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds