News-edi 1

2593 Results / Page 62 of 289

Background

General

How Kidnappers Dey Target Victims Through Social Media

For old days, if kidnappers wan pick person, dem go need informant, follow person physically, or get insider wey know di victim well well. But nowadays, things don change. Na so-called “harmless” social media post don turn their biggest tool. Plenty criminals no even need stress again, na victims dey give dem full informate like gift. Security experts don warn say kidnappers and other criminals now dey use Facebook, Instagram, […]

todayJune 9, 2026 36

Sports

Super Falcons Show Power

Nigeria Super Falcons show say dem ready oh for WAFCON 2026, beating  Senegal 3-0 for dia second friendly match for Ikenne, Ogun State. Di win complete double victory for di African champions after dem first beat di Teranga Lionesses 2-1 on Friday. Coach Justin Madugu and im players dominate di game from start to finish, create plenty chances even though Senegal defence try hold ground for first half. Di result […]

todayJune 9, 2026 14

obodo oyinbo

WHO Give Uganda Big Respect

Di head of di World Health Organization, Tedros Adhanom Ghebreyesus, don hail Uganda as dem dey try well-well to stop di Ebola virus from spreading enter inside dia country. Oga Tedros, wey visit Mulago National Referral Hospital for Kampala on Monday, talk say Uganda really dey handle di matter sharply. Dis praise dey come after WHO declare di Ebola outbreak a heavy international emergency, as di sickness don kpai 91 […]

todayJune 9, 2026 9

OBODO NAIJA

Senate Push For State Police

Senate don drop microsoft word say dem go begin urgent discussion on state police dis week to hellep tackle di rising insecurity for di country. Senate Leader, Opeyemi Bamidele, naim tuk dis one for statement, say di mata don become top priority inside di ongoing constitutional review process. Im say dem don already dey meet stakeholders and dem go quick pass di bill so e fit move go state assemblies […]

todayJune 9, 2026 16

OBODO NAIJA

President Tinubu Replace Adelabu, Tuggar With New Ministers

Wi oga Presido, Bola Tinubu don go swear for two new ministers, Joseph Tegbe as Minister of Power and for Sola Enikanolaiye as Minister of State for Foreign Affairs for Aso Villa, Abuja. Di swearing-in ceremony hapun on Monday inside di Council Chamber with top gornment officials and family members present. Di appointment follow di resignation of former ministers Adebayo Adelabu and Yusuf Tuggar, wey leave office to contest election […]

todayJune 9, 2026 23

Lagos

Vice Presido, Shettima Hail Tinubu

Vice Presido Kashim Shettima on Monday say Nigeria plan, na to build one-trillion-dollar economy, wey investors go package across all levels of gornment. Im tuk dis tuk one wen e open di Invest Lagos 3.0 Summit for Eko Hotel and Suites, Victoria Island, Lagos. Shettima also praise Presido, Bola Tinubu, say im  ma try oh, even though plenty Nigerians nor dey see dat oga presido try, as im take transform […]

todayJune 9, 2026 24

Sport Yarns

Alex Iwobi Thank Nigerians Say im Wan Play Im 100th Game For Super Eagles

By : Jolayemi Olajide Super Eagles star midfielder, Alexander Iwobi, don send big thank you to all Nigerians for home and abroad for di heavy love and support as im prepare to play im 100th match for Nigeria against Portugal inside Leiria on Wednesday. Inside one sharp tuk on Monday, naim di playmaker take fry mouth tuk di tuk. Iwobi say im dey very proud to wear di green and […]

todayJune 8, 2026 20

OBODO NAIJA

 Atiku Salute Ngozi Okonjo-Iweala Based on Her Younger Brother Wey Kpai

By : Jolayemi Olajide Former Vice Presido, Atiku Abubakar don send im condolence message to di Director-General of di World Trade Organization (WTO), Dr. Ngozi Okonjo-Iweala, after her younger brother, Prince Ikechukwu Okonjo, kpai. Inside one post on top im X account on Monday, naim Atiku take salutate di former Nigeria finance minister and her entire family over di painful loss wey hit dem. Atiku describe di late Prince Ikechukwu […]

todayJune 8, 2026 20

Lagos

Protesters Storm Lagos Assembly Demand For Ajiran Community Leader

By : Jolayemi Olajide Some Lagos pipo storm State House of Assembly on Monday to protest because police lock up one Ajiran community leader, Hammed Tajudeen Akanbi. Di protesters march from Ikeja Shopping Mall go give di Speaker petition, as dem dey shout make gornment release di man. Dis rally hapun after Akanbi lawyers cry out say di court dey do partial for the mata, so fresh investigation must start. […]

todayJune 8, 2026 21

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds