News-edi 1

2355 Results / Page 90 of 262

Background

obodo oyinbo

Colombian Military Plane Crash Kill 66+Pesin, 4 Still dey Miss

Say plenti pipo na im kpai afta one Colombian military plane wey carry 125 pesin crash on Monday. According to  Minister of Defence Pedro Sanchez tuk, Di C-130 Hercules plane, wey Lockheed Martin make, crash shortly afta e lift from Puerto Leguizamo, near Ecuador and Peru border, strewing fire and wreckage for jungle floor. Sanchez explain say di plane hit ground just 1.5 km from takeoff, make ammunition blow, catch […]

todayMarch 24, 2026 12

obodo oyinbo

U.S, IRAN Battle Words For Peace Tuks

U.S and Iran  dey yarn different tori about, if dem go fit talk over di war. Presido, Donald Trump  say, e  stop im plan to attack Iran power plant after e get "productive" gist with Tehran. But Iran parliament oga tuk say no tuk don happen, e call am "fake news." Nor forget say IRAN bin threaten to close di full strait of Hormuz, if US try nonsense with di […]

todayMarch 24, 2026 15

Sports

Nigeria Shock Ghana, Win By 136 Runs For Patricia Kambarami Cup

Nigeria carry better all-round play beat Ghana by 136 runs for di Patricia Kambarami Cup wey dey happen for Lagos. Naija captain Piety Luck and Victory Igbinedion na im wan finish Ghana, make 44 runs for three overs, while Christabel Chukwuonye carry di innings go reach 159 for four. For Ghana side, matter scatter as dem lose five wickets for only 13 runs early, never fit recover. Nigeria bowler Peace […]

todayMarch 23, 2026 17 2

Sports

NPFL Match Day 31: Katsina, Kano, Remo, Rangers Record Win

For Sunday matas, the NPFL nor dey slack at for match day 31  as top teams  fight for points. Katsina United FC beat Shooting Stars FC 1-0, while Kano Pillars FC show power with 2-0 win over Enyimba International FC. Remo Stars FC carry 3-1-win comot for Kwara United FC, and Enugu Rangers FC waka go 2-0 against El-Kanemi Warriors FC. Some games like Warri Wolves FC vs Bendel Insurance […]

todayMarch 23, 2026 17

Sports

Lookman Score Historic Goal, But Real Madrid Still Shock Atletico 3-2

Ademola Lookman don make history as e become first Nigerian wey score for Madrid derby, but e goal no sti hellep as 10-man Real Madrid turn game around to win 3-2 against Atletico Madrid for La Liga on Sunday. Lookman don score two goals dis season for im debut campaign in Spanish top flight. Di win give Real Madrid (69 points) reduce Barcelona (73 points) lead to just four points […]

todayMarch 23, 2026 15

Sports

Man City Beat Arsenal 2-0 To Carry League Cup

Manchester City don win dia first trophy for dis English season as Nico O’Reilly score two goals for di second half to hellep dem beat Arsenal 2-0 for di League Cup final. Arsenal wey be Premier League leaders come as favourites, but power pass favourite for Wembley stadium. Di first half no too get action, but O’Reilly first goal come after Arsenal goalkeeper Kepa Arrizabalaga fumble. Four minutes later, O’Reilly […]

todayMarch 23, 2026 13

OBODO NAIJA

14 Brigade Go Do Shooting Drill For Abia

14 Brigade Nigerian Army don tell farmers and people wey dey near 14 Brigade Range Area make dem no fear if dem hear gun shots from Monday, March 23 go reach Wednesday, March 25, 2026. Di Brigade talk say dem go do first Range Classification exercise to improve how soldiers dey handle weapons, shooting skills, and marksmanship. According to statement wey Captain Mazinho Attah sign, di exercise go happen for […]

todayMarch 22, 2026 20

OBODO NAIJA

Tinubu Set Plan Wey Go Reduce Fuel Wahala For Nigerians

Oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don yarn say fuel price don dey too high for Nigerians, and don start plans to reduce di sufferness wey citizens dey face. Dis one dey inside statement wey Hamisu Muhammad Gumel, Chief Press Secretary to Jigawa governor, release give media tori pipo. Di Governor talk dis one during Eid-el-Fitr celebration for Dutse, after e receive Emir of Dutse and other traditional oga dem for […]

todayMarch 22, 2026 27

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds