News-edi 1

2355 Results / Page 89 of 262

Background

OBODO NAIJA

VP  Shettima Welcome Dauda Lawal Join All Progressives Congress

Vice Presido, Kashim Shettima on Wednesday for Abuja don go receive Zamfara State Governor Dauda Lawal and im supporters into All Progressives Congress (APC) on behalf of  oga Presido, Bola Tinubu. Oga vice Presido yarn every every for di ceremony, say Tinubu dey work seriously through security agencies to end di insecurity for di obodo naija. Shettima explain say Lawal joining APC, e go hellep beta collabo and support efforts […]

todayMarch 25, 2026 20 1

National

Makinde Clear Air, Konfam Loyalty To PDP

Oyo State Govo, Seyi Makinde, don dismiss report say, im nor dey comot from Peoples Democratic Party (PDP). Di mata of im defection, come out, few days afta Makinde, Peter Obi and Seriake Dickson waka meet Rabiu Kwankwaso for Kano. Im clear dis mata for meeting with PDP people from all di 33 Local Government Areas for Ibadan. Makinde  say, PDP still dey strong, and di party go still take […]

todayMarch 25, 2026 23 1

Lagos

Lagos Gorment Promise To Deliver Ogbonge Security For 2026 Lagos Fanti Carnival

Lagos State Gornment say, like dis now dem dey expect nothing less than 40,000 tourists and pipo wey go participate for di 2026 Lagos Fanti Carnival. Madam Commissioner for Tourism, Arts and Culture, Toke Benson-Awoyinka, na im dey yarn dis one for news tuk on Tuesday. Madam Commissioner say security go mount every wia for di event wey go hold on April 6, 2026, for Tafawa Balewa Square (TBS), Lagos. […]

todayMarch 25, 2026 22

Lagos

How FG Wan Rub Mind With Private Business To Boost Education

Naija Education Minister, Dr Tunji Alausa, like dis na, dey look for serious business pipo to hellep fix education through di Nigeria Education Sector Renewal Initiative (NESRI). Oga Education minister yan dis one for roundtable breakfast tuk tuk wey im do with stakeholders and top business pipo for Lagos. Alausa say, di new move go bring beta management to wi schools, and e go hellep Naija schools compete with resof […]

todayMarch 25, 2026 26

Lagos

IGP Arrange New Police Commissioner For Lagos

Ogbonge report from police headquarters Abuja, say Lagos state don get new Commissioner of Police after dem promote some senior officers. According to oga inspector general of police Olatunji Disu, CP Fatai Tijani go now be Lagos police commissioner, taking over from CP Olohundare Moshood Jimoh wey don become Assistant Inspector-General of Police. Say AIG Jimoh na im go dey  lead Zone 2 Command wey cover Lagos and Ogun states. […]

todayMarch 25, 2026 27

Lagos

FG Open Online Package For Importers To Reduce Trade Wahala

Federal Gornment on Tuesday for Apapa, Lagos, officially don launch National Single Window project, dat is ogbonge online registration for importers. Minister of Finance, Wale Edun, na im dey ground run di parole. Edun explain say dem dey do am to reduce plenty katakata for trade, and make am easy for importers and exporters to do business.

todayMarch 25, 2026 18

Sports

Victor Osimhen Chop Knife For Im Broken Arm

Victor Osimhen don successfully do surgery for im right hand wey break during di away match against Liverpool for UEFA Champions League Round of 16. Galatasaray announce on Monday say di surgery hapun for Maslak Acıbadem Hospital for Istanbul, and di club doctor, Op. Dr. Yener İnce, na im perform di surgery. Di Turkish champions wish Victor quick recovery and hope say e go fit return to di field soon. […]

todayMarch 24, 2026 17 2

Sports

No Write Note Giv Chelsea Players – Emmanuel Petit

France legend Emmanuel Petit don clear Chelsea manager Liam Rosenior to stop passing note to players. Petit tuk dis one during im chat with Talksport, after Chelsea lose 3-0 to Everton for Premier League. E tuk say Rosenior dey shame imself with di paper, because players no be children, dem no need all dis kind writing. Petit explain say whenever Rosenior try show substitution note to players wey dey come […]

todayMarch 24, 2026 15

Sports

Nasarawa United Tear Rivers United 4-1 For Lafia Stadium

Rivers United don enter anoda wahala for dia title chase  lossing 4-1 to Nasarawa United for Lafia City Stadium on Monday. Coach Finidi George bin tuk say dem go like return back to di top of di table after Rangers win 2-0 on Sunday, but Nasarawa quick goals spoil dia plan. Ngei Oluka-Efor and Abubakar Abdullahi quick quick score two goals for Nasarawa, while Chimezie Victor add another, before Taiwo […]

todayMarch 24, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds