News-edi 2

1344 Results / Page 115 of 150

Background

National

Bread Van Driver Don Crush Two Women to Death for Oyo

Tragedy don happen for Ogbomoso, Oyo State on Monday, October 27, as one bread distribution van reportedly jam two middle-aged women wey dey cross road for Alao-Akala Memorial Highway, Randa area, and dem die on di spot. According to eyewitness wey talk di matter, di van wey get registration number Oyo AME 92 XB dey move with serious speed when di women try cross di road. “Di two of dem […]

todayOctober 28, 2025 40

International

183 Million Gmail Passwords Don Leak As Data Breach Burst Out

Gmail users don dey get serious warning make dem check dia accounts after dem steal over 183 million passwords for one massive data breach. Australian cyber expert, Troy Hunt, wey first reveal di matter, describe am as one “vast corpus” of leaked data wey reach 3.5 terabytes e talk say na di same size like 875 full HD movies put together. According to Hunt, all di major email providers dey […]

todayOctober 28, 2025 18

National

Court Don Sentence Three Men To Death For Robbing 87-Year-Old Woman for Ekiti

Di Ekiti State High Court wey dey sit for Ado-Ekiti don sentence three people Shadrack Apos (30), Lucky Akpos (33), and Adunola Precious (24) to d3ath by hanging for robbing one 87-year-old woman. Dem arraign di trio for August 19, 2024, before Justice Lekan Ogunmoye on top two-count charge of conspiracy and armed robbery. According to di charge, dem rob Mama Victoria Folorunso for Ifaki Ekiti on June 12, 2024, […]

todayOctober 28, 2025 17

Lagos

Otti Hail Abia Biker We Ride From Lagos, Vow To Still Put People First

Governor Alex Otti don talk say him government no go gree make anything distract dem from giving Abia people di real dividends of democracy, as him still stand gidigba to better di welfare and well-being of di people. Di Governor yarn dis one when him receive one Abia-born cyclist, Mr. Wisdom Chisom, we ride bicycle all di way from Lagos reach Abia just to honour di Governor for him visible […]

todayOctober 28, 2025 32

Lagos

Police Don Storm Lagos As Residents Cry Over Demolition Deaths

Two pikin don reportedly die for Oworonshoki, Lagos, as police deploy full ground to control wahala wey burst from di new demolition wey Lagos State Government start again. Police full everywhere from Iyana Oworo reach Adeniji Adele after some residents threaten say dem go block road for protest. Fresh demolition start around midnight for Coker and Ojulari area, just one day after government yarn say about 80 landlords don collect […]

todayOctober 28, 2025 63

Lagos

Drug Traffickers Don Enter Nigeria Courier Services

For Lagos wey dey always full of traffic and wahala, dispatch riders don turn di real heartbeat of city life. As di road dey choke and people dey find how to move fast, dem riders dey weave in and out like breeze carry food, parcel, and document go offices and houses sharp sharp. Dem don become di engine of convenience for Nigeria wey every minute mean money. According to National […]

todayOctober 28, 2025 19

Lagos

Lagos Assembly Ok New Rules To Run LGA, LCDA Work

Lagos State House of Assembly don give final approval to new regulations and guidelines wey go make administration and governance for all di Local Governments and Local Council Development Areas (LCDAs) strong well well. Di approval happen on Monday during plenary wey Speaker Rt. Hon. (Dr.) Mudashiru Ajayi Obasa preside over. Di report wey Hon. Sanni Ganiyu Babatunde Okanlawon (Kosofe I) present before, come get serious discussion from Hon. Members […]

todayOctober 28, 2025 42

Lagos

Demolition Protest: Police Warn Sowore Make E No Enter Lagos

Di Commissioner of Police for Lagos, Mr Olohundare Jimoh, don warn activist Omoyele Sowore and him people make dem no try mobilise protest over di recent demolitions wey happen for di state. CP Jimoh talk dis one on Monday as e dey address newsmen for Iyana-Oworo area near Third Mainland Bridge. Di police oga talk say dem don deploy plenty officers waka around di city to stop any protest wey […]

todayOctober 28, 2025 27

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds