News-edi 2

1385 Results / Page 25 of 154

Background

OBODO NAIJA

Shettima Tuk Say Nigeria No Get Reason To Poor

By Esther Daniel Vice Presido Kashim Shettima don say Nigeria no get any reason to dey poor despite di country's rich natural resources. Speaking for one agriculture summit in Abuja, e compare Nigeria with Indonesia, saying Indonesia make more money from palm oil exports dan Nigeria earn from crude oil in 2025. Shettima also tuk di Niger Delta get huge potential for fish farming and other marine businesses wey fit […]

todayJuly 16, 2026 5

OBODO NAIJA

EFCC Release Activists Randy Peter and Mama Pee

By Esther Daniel Di EFCC don release activists Randy Peter and Mama Pee after dem honour invitation by di anti-graft agency for Abuja. Na Justice Cracks, wey follow Randy Peter and Mama Pee go EFCC headquarters for Abuja, confirm dia release for one post wey e share on X on Wednesday. Dem regain freedom shortly after midnight on Wednesday after plenty hours of questioning. According to dia colleague, Justice Cracks, […]

todayJuly 16, 2026 7

Health

Doctor Warn Nigerians About Sarcoma Cancer

By Esther Daniel Chief Executive Officer of Kano Cancer Treatment Centre, Dr. Nafisa Abdu, don advise Nigerians make dem quickly go hospital if dem notice persistent lumps, swelling wey no clear, or bone pain wey no gree stop. She warn say di symptoms fit mean sarcoma, one rare but serious type of cancer. According to Dr. Abdu, early diagnosis na di best way to improve treatment and survival, as she […]

todayJuly 16, 2026 9

Entertainment

Davido Call Chioma Im ‘Life Coordinator’’

By Esther Daniel Afrobeats star Davido don call im wife, Chioma Adeleke, im "life coordinator," saying she dey help am manage im finances. For one video wey don go viral, Davido call Chioma after e no fit log into im bank account to send money to im personal assistant, Lati. Di  singer ask Chioma make she transfer $4,000 to Lati on im behalf before dem travel back to Nigeria. Di […]

todayJuly 16, 2026 11

obodo oyinbo

Ajayi Set for London Diamond League Race

By Esther Daniel After im impressive victory for im first Diamond League race, Nigeria fastest man Kayinsola Ajayi don set for another big test as e go compete for the London Diamond League on Saturday. Di 21-year-old recently equal Nigeria 100m record of 9.84 seconds and beat world champions Oblique Seville and Christian Coleman for Oregon. Ajayi now dey hope to continue im fine form and prove say im last […]

todayJuly 16, 2026 12

president Bola Tinubu

OBODO NAIJA

Tinubu Defend Economic Reforms, Say Better Days Dey Come

By Esther Daniel Wi oga Presido, Bola Tinubu don defend im gornment economic, tax doings, saying although the changes hard for Nigerians, dat e dey bring ogbonge result. Tinubu tok dis on Wednesday for the State House, Abuja, wia im receive delegation from Deloitte Africa led by CEO Ruwayda Redfearn. According to baba Seyi, di reforms no easy, but if dem implement am well, e go bring beta  future for […]

todayJuly 16, 2026 9

obodo oyinbo

Iran Attack US Bases for Gulf Region Again

By Esther Daniel Iran don launch fresh attacks on US military bases for Jordan, Kuwait and Bahrain, as America still carry out overnight airstrikes on different locations inside Iran. US military say di strikes na to weaken Iran ability to threaten ships wey dey pass through di Strait of Hormuz. US President Donald Trump don warn Iran say make dem return to negotiation or face more military action. But Iran […]

todayJuly 16, 2026 9

Sports

Declan Rice Ready for England World Cup Semi-Final Against Argentina

By Esther Daniel England coachie Thomas Tuchel don konfamte doings say Declan Rice don recover from sickness and e fit start Wednesday World Cup semi-final against Argentina. Bad belle Man United Fans bin dey think say, kobbie maino go get opportunity start im first game today, but with dey update ehn, every wia blur Rice bin comot for halftime during England quarter-final win over Norway, but Tuchel say di midfielder […]

todayJuly 15, 2026 17

obodo oyinbo

Human Rights Groups Sue Trump Over ICC Sanctions

By Esther Daniel One human rights group, DAWN, and Taxpayers Alliance Against Genocide don sue President Donald Trump administration over sanctions wey dem place on International Criminal Court (ICC). Dem say the sanctions dey stop Americans from supporting human rights work and talking freely about Palestine matters before the international court. Di case still argue say the sanctions break U.S. law because the president no get power to use sanctions […]

todayJuly 15, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds