News-edi 2

1831 Results / Page 32 of 204

Background

Sports

Man City Prepare £120m for Chelsea Star Enzo Fernandez

By : Mariam Ajayi Manchester City dey prepare fresh bid for Chelsea midfielder Enzo Fernandez as Premier League champions dey push to sign di Argentina international before transfer window close. Reports say City don make Fernandez priority target as coach Enzo Maresca dey look to strengthen Chelsea midfield after several major departures. Chelsea value di 25-year-old midfielder at £120 million and dem fit consider sale only if dem secure suitable […]

todayAugust 26, 2026 14

Local

Sunday Igboho Stop Police Arrest of Tani Olohun

By: Mariam Ajayi Yoruba Nation activists, Sunday Igboho, block police attempt to arrest Isese advocate, Abdulazeez Adegbola, popularly known as Tani Olohun. Footage shared on Tani Olohun Facebook page show confrontation between police officers and residents who gather as dem come to arrest am. One of di videos show one police officer pin Olohun to ground while residents gather around di scene. Di reason for di planned arrest no dey […]

todayAugust 26, 2026 17

OBODO NAIJA

Ogun Introduce Rent-to-Own Housing Scheme for Residents

By: Mariam Ajayi Ogun State Gornment don introduce Rent-to-Own housing scheme to make house ownership easier and create jobs for artisans across di state. Commissioner for Housing, Jamiu Omoniyi, disclose dis during an X Space on Tuesday, say di scheme go help tackle high construction costs and inability to pay for houses at once. Gornment dey partner Gateway Mortgage Bank on Prince Court Estate, Kobape Phase IV, where residents fit […]

todayAugust 26, 2026 14

Politics

Amaechi Say E Pay Pregnant Women N10,000 for Antenatal

By: Mariam Ajayi ADC presidential running mate, Rotimi Amaechi, don reveal say as Rivers State gorfnor, hin dey give pregnant women N10,000 each for antenatal care to help reduce maternal and child deaths. Amaechi make dis disclosure while explaining say Rivers State rank second for maternal-child mortality during hin time as governor from 2007 to 2015. hin say di payment na part of measures wey hin administration introduce to encourage […]

todayAugust 26, 2026 15

Sports

Tottenham Use £60m Take Sign Omar Marmoush on Loan

BY: Blessing Aminu Tottenham Hotspur don agree loan deal to sign Manchester City forward Omar Marmoush, wit Spurs expect to make di move permanent for £60 million next summer. Di 27-year-old Egypt international join City from Eintracht Frankfurt for £59 million in January 2025, but e struggle to get regular playing time, wit Erling Haaland often ahead of am for di attack. Marmoush come as second-half substitute during City 3-0 […]

todayAugust 26, 2026 15

OBODO NAIJA

VeryDarkMan Accuse Security Operatives Say Dem Be Di ‘Unknown Gunmen’

By: Mariam Ajayi Social media critic, Martins Vincent Otse, wey pipu know as VeryDarkMan, don accuse Nigerian security operatives of being behind di ‘unknown gunmen’ wey dey cause insecurity for di country. VeryDarkMan make di allegation on Tuesday while im dey talk for di 2026 NBA Annual General Conference for Port Harcourt, Rivers State. E claim say military, immigration and customs officers fit dey behind some of di attacks, despite […]

todayAugust 26, 2026 15

OBODO NAIJA

How Oshiomhole Lead Protest When Obasanjo Comot Fuel Subsidy.

By: Mariam Ajayi Edo North Senator, Adams Oshiomhole, don recall how e organise residents for Ogun State to protest against fuel subsidy removal during former Presido Olusegun Obasanjo University of Lagos government. Oshiomhole make dis disclosure during national discourse wey The Companion organise for University of Lagos, as e say e fear say corruption fit swallow di money from di subsidy removal. E tok say at di time, e bin […]

todayAugust 26, 2026 14

Politics

Atiku Promise Nigerians Beta Life

By: Mariam Ajayi ADC presidential candidate, Atiku Abubakar, don promise say e go strengthen naira and improve Nigerians’ living condition if e win di 2027 presidential election. Atiku make di promise as e insist say im position on bringing back targeted fuel subsidy still remain di same. E say e go restore targeted subsidies and put more purchasing power back for di hands of Nigerians. Atiku, for post on X, […]

todayAugust 26, 2026 8

OBODO NAIJA

Charly Boy Say No Mistake Obasanjo Laughter For Weakness

By: Mariam Ajayi Popular Nigerian entertainer, Charly Boy, don warn Nigerians say make dem no mistake former Presido Olusegun Obasanjo laughter for weakness. Charly Boy say Obasanjo no be person wey anybody suppose mess with, as e describe di former presido as fearless. For post wey e make for X, Charly Boy compare himself with Obasanjo and say both of dem dey make am laugh sometimes.

todayAugust 26, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds