News-edi 2

1831 Results / Page 33 of 204

Background

OBODO NAIJA

Kingibe Accuse Wike Say E Borrow Money For FCT Without Approval

By: Mariam Ajayi FCT Senator, Ireti Kingibe, don accuse FCT Minister, Nyesom Wike, say e dey take loans for Abuja without National Assembly approval. Kingibe make di allegation on Tuesday during interview with one television station, say DMO records show say loans dey taken for FCT between August 2023 and March 2026. She add say Wike never appear before Senate to seek approval for di borrowing.

todayAugust 26, 2026 12

OBODO NAIJA

IPMAN Say Refineries Revival Go Reduce Fuel Price

By: Mariam Ajayi Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria, IPMAN, don talk say bringing Port Harcourt, Warri and Kaduna refineries back to work fit help reduce fuel prices for Nigeria. IPMAN toktok pesin, Chinedu Ukadike, tok dis one during one interview with tok tok channel as debate over fuel subsidy return dey continue. E say di best way to bring down fuel price, wey dey between N1,230 and N1,299 per […]

todayAugust 26, 2026 12

OBODO NAIJA

Sowore Vow Say E Go Make Nigeria Four Refineries Work If E Win 2027

By: Mariam Ajayi African Action Congress, AAC, presidential candidate, Omoyele Sowore, don promise say e go make Nigeria four government-owned refineries work if e win di 2027 presidential election. Sowore make di promise on Tuesday during interview for one media station, where e blame corruption and mismanagement of public funds by past administrations for di refineries’ failure. E say if Nigeria fit refine crude oil locally, di country go save […]

todayAugust 26, 2026 11

Sports

Awoniyi Scores, Assists As Coventry Beat Plymouth 4-2 In Carabao Cup  

By: Mariam Ajayi Super Eagles striker Taiwo Awoniyi don open im goal account for Coventry City as e score one goal and provide assist for dia 4-2 win against Plymouth for Carabao Cup on Tuesday. Awoniyi put Coventry ahead just three minutes into di match after e finish Caleb Yirenkyi assist. Just two minutes later, di Nigerian striker turn provider as e set up Jack Rudoni to make am 2-0. […]

todayAugust 26, 2026 9

obodo oyinbo

Strait Of Hormuz Still Dey Closed As Iran, US Gbege Demselves

By: Mariam Ajayi According to di Deputy Foreign Minister, Kazem Gharibabadi say US must first return to im commitments before dem fully open di waterway. U sabi say, US President Donald Trump say all mines (dat navy bomb) for di international waters of di strait don clear and warn say any ship wey try plant new bomb ehn go dance osurugede dance, dem never shishonshi. Meanwhile, US State Department say […]

todayAugust 26, 2026 18

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Order Make Dem Do Benin-Agbor-Asaba Road

By: Mariam Ajayi Presido Bola Tinubu don order total reconstruction of di Benin-Agbor-Asaba road and other major federal highways for Edo State and nearby areas. Minister of Works, David Umahi, give di order on Tuesday when e inspect di bad Benin-Agbor-Asaba road and apologise to motorists over di hardship wey dem dey face. Umahi also condemn di contractor wey dey  handle di road after hin accuse rain say naim dey […]

todayAugust 26, 2026 9

Lagos

Suspected Cultists Kpai Security Man Inside Lagos Estate

By: Mariam Ajayi One security man wey dem identify as Stanley don kpai after two suspected cult members shoot am for Royale Estate, Sangotedo area of Lagos, on Friday night. Witness say di attackers storm di estate around 10pm to 11pm, shoot Stanley several times including for di head, before dem fire shots into di air and run comot. Lagos State Police Command tok tok pesin, Abimbola Adebisi, confirm di […]

todayAugust 26, 2026 11

Lagos

LAWMA Lock Markets Over Dirty Environment

By: Yusuf Abuh LAWMA don lock some markets and plazas for Ayobo, Lagos, on Sunday over repeated environmental violations and illegal dumping. LAWMA Project WISE team carry out di enforcement around Ayobo-Ipaja axis to clear waste backlog and stop illegal dumping. LAWMA boss Muyiwa Gbadegesin say dem target facilities wey repeatedly break di environmental rules despite several warnings. Rock of Age Plaza, Ajerogun I Market, Ayobo Market and Oba Plaza […]

todayAugust 25, 2026 14

south west

Ogun Police Burst Alleged Baby Factory, Rescue Six

By: Yusuf Abuh Ogun Police don burst alleged baby factory for Mowe on Monday, August 24, rescuing two pregnant women and four children. Police spokesperson DSP Oluseyi Babaseyi disclose di operation on Tuesday, say six suspects dey custody over alleged human trafficking and illegal adoption. Operatives carry out di raid around 8am for Toluwalase Street, Abaren Village, after sustained intelligence on activities inside di facility. Police say dem dey continue […]

todayAugust 25, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds