News-edi 2

1832 Results / Page 46 of 204

Background

OBODO NAIJA

EU Say Dem No Go Boycott Nigeria 2027 Election

By: Yusuf Abuh European Union, on Monday say reports say dem wan boycott Nigeria 2027 election na false, as di bloc don accept INEC invitation to observe di election. EU Ambassador to Nigeria, Gautier Mignot, say dem go send two to four independent experts to monitor di election and check if e meet election standards. He say reasons like insecurity and bad treatment wey reports mention no dey inside EU […]

todayAugust 11, 2026 14

Local

NDC Leaders Meet to Plan for 2027 Election

By: Yusuf Abuh NDC leaders on Monday meet to discuss plans and prepare for di 2027 general election across Nigeria. Di party say di meeting focus on how to run coordinated campaigns and win for all dia candidates. Di meeting include NDC governorship candidates for Bauchi, Sokoto and Borno States, Ibrahim Kashim, Shamsu Aliyu and Sunusi Kashim Ibrahim. Other leaders wey attend include Buba Galadima and NDC chairmen for Kebbi […]

todayAugust 11, 2026 16

Lagos

Lagos Assembly Call for Stronger Security to Stop Public Property Vandalism

By: Yusuf Abuh Lagos State House of Assembly on Monday call for stronger community security and tougher punishment for people wey dey destroy gornment property across di state. Di lawmakers ask gornment to support and equip Lagos Neighbourhood Safety Corps and other local security groups to stop vandalism of roads, bridges and other public facilities. Moshood Aro, wey represent Ikorodu II, say vandals dey put extra burden on taxpayers because […]

todayAugust 11, 2026 13

Local

DSS Free Carpenter Arrested Over Oyo School Attack

By: Yusuf Abuh DSS don release carpenter Mustapha Marwana wey dem arrest over abduction and killing of pupils and teachers for Oriire, Oyo State. DSS DG, Tosin Ajayi, order im release after investigators check di matter and find say e no get link to di attack. DSS panel also confirm say Marwana, wey come from Katsina, no be member of any terrorist group and no get link with Ansaru. Di […]

todayAugust 11, 2026 10

Sports

Salah Move Into Nwakaeme Old House for Turkey

By: Yusuf Abuh Mohamed Salah don move into di same house former Super Eagles striker Anthony Nwakaeme dey stay before for Trabzon, Turkey, after Salah join Trabzonspor. Trabzonspor Presido Ertugrul Dogan confirm di matter and say di club provide houses for players as part of dia arrangement. Dogan explain say Salah current house na di same property Nwakaeme use when e play for di Turkish club. Di club presido say […]

todayAugust 11, 2026 15

Local

PDP Name 2027 Campaign Team for Kogi Central

By: Kofoworola Olayinka PDP for Kogi Central on Monday appoint Dr. Salami Etudaiye as Campaign DG and Abubakar Karaku as Campaign Chairman as di party start preparations for 2027 election. Dem inaugurate di two men during stakeholders meeting led by Senator Natasha Akpoti-Uduaghan for Kogi Central. Akpoti-Uduaghan charge di campaign team make dem work hard and focus on grassroots mobilisation to win all PDP seats for di district. She say […]

todayAugust 11, 2026 10

Local

Kano Health Agency Find Problems For 80 Hospitals

By Kofoworola Olayinka Kano State Contributory Healthcare Management Agency, KSCHMA, on Monday reveal say dem find gaps for record keeping, referrals and drug supply for 80 health facilities across 19 LGAs. KSCHMA spokesperson, Aminu Turaki, say di facilities dey serve over 129,000 people under di state health insurance scheme. He say di agency go train health workers, improve records and make sure hospitals manage drugs and referrals better. Turaki add […]

todayAugust 11, 2026 16

Politics

Dele Momodu Back Adeleke For Osun Election

By Kofoworola Olayinka ADC chieftain, Dele Momodu, on Tuesday say e support Gofnor Ademola Adeleke for second term ahead of August 15 Osun election. Momodu say opposition parties need put personal interest aside and support Adeleke to defeat APC. Di former presidential aspirant say e still remain proud ADC member despite supporting Accord Party candidate. Im explain say e join ADC because opposition leaders come together to fight wetin dem […]

todayAugust 11, 2026 17

Sports

Kane Carry European Golden Shoe After Correct Performance Last Season

By: Yusuf Abuh Finally UEFA Harry Kane don carry European Golden Shoe for di 2025/26 season after e finish as Europe top league goal scorer. Di England captain win di big individual award after another strong season with Bayern Munich. Kane score 73 goals for di season including 12 goals for England, as e match im best international goal record since 2021/22 season. Di European Golden Shoe na award wey […]

todayAugust 11, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds