News-edi 2

1832 Results / Page 47 of 204

Background

obodo oyinbo

How Former Thai Lawmaker Take Kpai Innocent Person Over Money Wahala

By: Yusuf Abuh Former Thai lawmaker Chalong Riewrang don go kpai onelocal gornment official, Thongchai Yenprasert for broad daylight because of money for Nonthaburi province on Monday. Police arrest Chalong after di shooting, and he later confess. Chalong say when di official refuse to tuk, he bring out im gun, dat nor be say im plan am, e just hapun. Di shooting hapun just few days after another school shooting […]

todayAugust 11, 2026 14

OBODO NAIJA

Wike Deny Lobby For APC Campaign DG Job

By: Yusuf Abuh FCT Minister Nyesom Wike don on Monday deny report say e dey lobby to become Director-General of APC Presidential Campaign Council for di 2027 election. Wike fire dis mata through im Senior Special Assistant on Public Communications and Social Media, Lere Olayinka, talk say di report na false and e never discuss campaign council leadership or membership with anybody. E say e still dey support oga presido […]

todayAugust 11, 2026 12

south west

Osun Women Protest Beg INEC to do Free And Fair Election

By: Yusuf Abuh Osun number one lady, Titilola Adeleke, on Monday lead women protest for Osogbo against alleged arrests and violence ahead of Saturday election. Di women march from Osogbo-Ilobu Road to near Osun Police Command, carrying placards and calling for free and fair election. Dem also beg police make dem remain neutral and stop alleged arrest of dia husbands and supporters. Police stop di protesters from reaching di main […]

todayAugust 11, 2026 18

Lagos

Bill To Regulate Craftsmen And Artisan Pass Second Reading

By: Kofoworola Olayinka Lagos State House of Assembly don consider di Lagos State Artisans and Craftsmen Regulation Bill 2025 for second reading. Di bill, sponsored bye Hon. Adams Nohem, go establish a regulatory board wey go register and monitor artisans and craftsmen for Lagos, so gornment fit get proper record of dem activities. Lawmakers too support di bill, but dem raise questions about funding, loans and how members go register.   […]

todayAugust 11, 2026 14

Lagos

Lagos Assembly Congratulate Oba Akiolu As E Mark 23 Years For Throne

By: Yusuf Abuh Members of Lagos State House of Assembly don tuale give di Oba of Lagos, Oba Rilwan Akiolu as e mark 23 years for throne. Na di Majority leader of di house Hon. Adams Noheem na lead di lawmakers congratulate di traditional ruler during plenary on Monday, August 10, 2026. Di lawmakers also remember say before Oba Akiolu become king, e serve for Nigeria Police Force, where e […]

todayAugust 11, 2026 15

Sports

NBA Legend Don Nelson Die at 86 After Historic Coaching Career

By: Esther Daniel NBA legend Don Nelson don die at age 86 on Sunday, August 9, 2026, im family announce, after long career as player and coach for NBA. Nelson win five NBA titles with Boston Celtics between 1966 and 1976, and Celtics later retire im number 19 jersey. As coach, Nelson win 1,335 games with Golden State, Milwaukee, New York and Dallas before Gregg Popovich break di record for […]

todayAugust 10, 2026 22 10

OBODO NAIJA

Makinde Ask “Nigerian Economy Dey Grow, But Nigerians Dey Feel Am?”

By: Esther Daniel Oyo State Gofnor Seyi Makinde don ask whether Nigerians dey feel di impact of Nigeria’s growing , for im August 2026 newsletter, “Di Business of Governance,” because economic growth suppose improve people lives. Makinde tok say Oyo State and National Bureau of Statistics don release fresh economic figures, wey show say GDP(Gross domestic product ) dey grow, gornment revenue dey rise and budgets dey get implementation. Di […]

todayAugust 10, 2026 19

Politics

Osun APGA Candidate Comot for Race, Back APC Candidate

By: Esther Daniel Osun APGA gofnorship candidate, Adesina Adeyemi-Doro, don comot for di race and support APC candidate because e say na di best interest of Osun people. Adeyemi-Doro talk for One Tv show on Monday say e make di decision after serious thinking and consultation. E say e enter politics to serve people, no be just to get political office, and good leader suppose put people interest before personal […]

todayAugust 10, 2026 17

Sports

Three Barcelona Players Don Return to Training After World Cup Break

By: Esther Daniel Barcelona players Joan Garcia, Eric Garcia and Anthony Gordon don return to training for di first time after dia World Cup break, as dem begin preparation for di new season. Di three players, wey represent Spain and England for di World Cup, train for weekend alongside Gavi through gym work and ball exercises. Di rest of di Barcelona squad get rest after di triangular tournament for Udine, […]

todayAugust 10, 2026 16 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds