News-edi 2

1832 Results / Page 54 of 204

Background

south west

Ooni Of Ife Donate ₦100 Million, Hilux To Sunday Igboho Security Group

By: Esther Daniel Ooni of Ife, Oba Adeyeye Ogunwusi, don donate ₦100 million and one brand-new Hilux vehicle to support Iru Ekun Security Network wey Sunday Igboho establish. Di donation happen on Tuesday during courtesy visit by Sunday Igboho and members of di security outfit to Ooni Palace for Ile-Ife. Palace announce di donation for statement wey come out on Wednesday through Director of Media and Public Affairs office. Di […]

todayAugust 5, 2026 17

Entertainment

Davido Say Nobody Fit Beat Am for Free and Fair Election

By: Esther Daniel Afrobeats star Davido tok during one livestream with content creator Carter Efe say nobody fit beat am for any free and fair election, but im no get plans to join politics now because e believe say Nigeria election process no straight forward. Di singer say im rather focus on im music career until elections for Nigeria become free, fair and transparent. Davido add say im no fit […]

todayAugust 5, 2026 17 3

Lagos

Senate Deny Say Dem Sponsor Bill Wey Go Fine People Wey Dey Preach For Bus

By: Esther  Daniel Di Senate don deny reports say Senate Leader Opeyemi Bamidele and spokesman Yemi Adaramodu sponsor di bill wey propose ₦50,000 fine for people wey preach, trade or hawk inside commercial buses. Yemi Adaramodu tok dis one during interview as public debate over di FRSC Amendment Bill 2026 continue. Di bill still retain di ₦50,000 fine after Senate pass am as part of plan to strengthen road safety […]

todayAugust 5, 2026 14

National

FG Approve Plan To Give Hospitals 24-Hour Light

By: Esther Daniel Federal Gornment don approve new plan to give at least 30 percent of Nigeria health facilities steady 24-hour electricity before end of 2026. Health Minister of State, Dr Iziaq Salako, tok dis one after di Nigeria Power for Health Initiative meeting on Tuesday. Di committee approve new funding and governance plans plus shortlist eight private sector proposals for further engagement. Di move na to improve power supply […]

todayAugust 5, 2026 17

OBODO NAIJA

Federal Fire Service Raise Interest Free Loan to ₦500,000

By: Esther Daniel Federal Fire Service Controller-General, Olumode Adeyemi, on Tuesday announce for Wuse, Abuja, say di Service don increase interest-free loan for officers from ₦300,000 to ₦500,000 and launch Medical Intervention Scheme to improve staff welfare. Adeyemi tok say di welfare package go help reduce medical expenses and support officers and men across Nigeria. Im also reveal say instead of accepting one grand reception after e assume office, im […]

todayAugust 5, 2026 10

OBODO NAIJA

Abia Pass Law To Regulate House Rent

By: Esther Daniel Abia State House of Assembly don pass law to regulate house rent and protect both tenants and landlords for di state. Speaker Emmanuel Emeruwa preside as lawmakers Augustine Okezie and Mandela Obasi sponsor di bill. Di new law come after plenty complaints from tenants for Umuahia and Aba over high rent and house agents wey dey inflate prices. Lawmakers also pass another law to help courts handle […]

todayAugust 5, 2026 16

OBODO NAIJA

Senate Say State Police Bill Work No Go Stop

By: Esther Daniel Di Senate don assure Nigerians say work on State Police Bill no go stop despite National Assembly recess. Senate spokesman Yemi Adaramodu tok say committees still dey work to harmonise di bill with House of Representatives. According to am, di recess no go delay di constitutional amendment process. Di bill don get support from gofnors, state assemblies and oda stakeholders wey want better security.  

todayAugust 5, 2026 12

Sports

We Ready Die for Pitch, Ajibade for Egypt Game

By: Yusuf Abuh Super Falcons captain Rasheedat Ajibade tok say Nigeria players dey enter dia last group game with beta peper body for di WAFCON after dem beat Zambia and lose 3-2 to Malawi. Ajibade make di statement after Nigeria beat Zambia 1-0 for Morocco to keep dia title defence alive.   Skippo, say if Egypt, nor take dia time, dem nor go see body go house, cause na dis […]

todayAugust 5, 2026 14

obodo oyinbo

How Iran-Oman Hormuz Tuks Take Dey Give New Hope

By: Yusuf Abuh Finally e be like mehn mehn don give demselves brain oh, dat like dis now, Iran gornment don konfam say dia diplomatic tuks with Oman to reopen di Strait of Hormuz dey make brain. Even United States Secretary of State Marco Rubio konfam di progress for news and Treasury Secretary Scott Bessent con press tuks say agreement fit hapun today or tomorrow. Di tuks come after world […]

todayAugust 5, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds