News-edi 2

1832 Results / Page 55 of 204

Background

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Open ₦178.12bn Kaduna–Birnin Gwari Road, Fulfil Campaign Promise

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido Bola Tinubu don officially flag off di reconstruction of di 122-kilometre Kaduna–Birnin Gwari Road through Gofnor Uba Sani, say now wey im dey deliver im 2022 campaign promise, nobody dey tuk oh. Tinubu tok say na based on im coconut head im take package dis project, dat security pipo warn am about di Birnin Gwari, say kidnappers oh, im say no, my pipo dere […]

todayAugust 5, 2026 10

OBODO NAIJA

Police Konfam Say Dem Dey Touch Light AIG Moshood Jimoh for Corruption

By: Yusuf Abuh   Nigeria Police Force don open dia yamchop confess say, dem dey touchlight Assistant Inspector-General of Police for Zone 2, AIG Moshood Jimoh, to see whether senior man kahkah for church. You know wetin dey cause dis one, na social media activist Martins Otse, di one wey you sabi as VeryDarkMan naim go put dark accusate for di young man head say im dey corrupt. Police say […]

todayAugust 5, 2026 14

south west

Osun APC Blast Adeleke, Say Him Dey Find Excuse Before Election

By: Esther Daniel Osun State APC don fire back at Gofnor Ademola Adeleke, say all di allegation wey him make against Presido Bola Tinubu and Minister of Marine and Blue Economy, Adegboyega Oyetola, na empty talk and excuse before August 15 governorship election. For statement wey party Media Director Kola Olabisi release on Tuesday, APC tok say Adeleke claim say Tinubu and Oyetola dey persecute am politically no get head […]

todayAugust 4, 2026 13

obodo oyinbo

17 Migrants Die As Boat Drift 15 Days For Sea

By: Esther Daniel Two North African migrants don survive after dem spend about 15 days dey drift for Mediterranean Sea as dem dey try reach Spain Balearic Islands. Rescue team save dem early Tuesday morning about 13 nautical miles from Mallorca. Di two men dey battle dehydration and serious hunger, so rescue workers rush dem go hospital for treatment. According to wetin di survivors tell rescuers, na 19 pipo bin […]

todayAugust 4, 2026 17

obodo oyinbo

Ukraine Strike Hit Three Wildberries Warehouses For Russia

By: Esther Daniel Ukraine don launch overnight attack on Monday wey hit two Wildberries warehouses, while anoda site wey dem believe say get link with Russia biggest online shopping company also suffer damage near Moscow. For di past few weeks, Ukraine don dey target Wildberries facilities, wey plenty pipo dey call "Russia Amazon," as part of dia attacks. Local officials tok say at least five pipo die and 10 oda […]

todayAugust 4, 2026 10

obodo oyinbo

Man Hide Mama Body Inside Freezer for Almost 3 Years, Land Jail

By: Esther Daniel Strange story don shock people as 60-year-old Christopher Phillips collect two years and four months jail term after e hide im mama body inside chest freezer for almost three years. Court hear say Phillips keep di body of im 89-year-old mother, Sylvia Phillips, for dia family house after she die for March 2023, while e continue to collect her pension and other benefits. Di man tell court […]

todayAugust 4, 2026 13

Sports

Nigerian Basketball Star Enter Trouble Over Rape Allegation

By: Esther Daniel Wahala don land as Nigerian basketball player Daniel Tobiloba Adegboyega don enter police hand for United States over alleged rape matter, and Jacksonville State don suspend am from dia team. Court papers show say di 21-year-old player dey for Calhoun County Jail as e dey wait for court hearing after police accuse am of forcing sexual act on one person. Di alleged incident reportedly happen on Wednesday, […]

todayAugust 4, 2026 16

National

Customs Change Recruitment Game, New Jobs Go Drop Every Year

By: Esther Daniel Nigeria Customs Service don announce say recruitment into di agency go now happen every year instead of di irregular system wey applicants dey wait years before another exercise. Comptroller-General of Customs, Adewale Adeniyi, make di announcement on Tuesday during briefing for Customs headquarters for Abuja as im release di final list of successful candidates for di 2024/2025 recruitment. Adeniyi explain say di new policy go help di […]

todayAugust 4, 2026 9

OBODO NAIJA

Wike Say Fubara Miss Second Term Chance Over Rivers Crisis

By: Esther Daniel FCT Minister Nyesom Wike talk on Tuesday say di political crisis for Rivers State don cost Gornor Siminalayi Fubara im chance to contest for second term. Wike yarn during im monthly media chat say wrong advice from political allies and outside interests make Fubara abandon di political structure wey bring am to power. Di former Rivers governor reveal say e warn Fubara several times make e no […]

todayAugust 4, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds