Blog horizontal

Background

obodo oyinbo

Netanyahu Say Israel & Trump Dey “Win” Di War For Iran

By: Esther Ayoola Prime Minister Benjamin Netanyahu say Israel and America dey “win” di war against Iran, and dat confusion gadima for Iran. Him yan dis one for news tuk say nobody send dem message oh, dat Israel act alone wen dem strike Iran big South Pars gas field, but US Presido, Donald Trump later ask tell dem to “hold off” for di next attacks. Netanyahu tuk say di war […]

todayMarch 20, 2026 15

obodo oyinbo

Iran Plan To Drop Qatar Gas Export By 17%

By: Esther Ayoola Iran Foreign Minister Abbas Araghchi tuk on Thursday say na just small part of dia power ni dem don dey use attack regional energy facility . E tuk dis one for news tuk, say, if anybody touch Iran energy again, dem no go hold back. According to report dem dey plan attack Ras Laffan gas plant for Qatar, and dat e go cut Qatar LNG export by […]

todayMarch 20, 2026 17

National

Minister Promise Beta Light Supply Say FG Dey Work On Something Huge

By: Esther Ayoola Minister of Power, Adebayo Adelabu, say Nigerians go soon dey enjoy beta electricity supply as gornment dey work to fix gas wahala wey dey affect power generation. Im yan dis one for Im Eid-el-Fitr message say gornment dey put proper plans to make sure power dey steady for homes, businesses, and factories. Say Some gas suppliers stop to dey supply thermal power plants because of big N3.3tn […]

todayMarch 20, 2026 12

National

Obi Greet Muslims For Eid, Say Make Ramadan Values Continue

By: Esther Ayoola Di 2023 Labour party presidential candidate, Peter Obi, don wire beta greetings for Nigerian Muslims as dem end Ramadan fasting. E put for news statement on Thursday say dem don show faith by fasting, praying, and giving charity throughout Ramadan. Obi beg make di lessons of compassion, humility, and unity wey Ramadan teach continue even afta di month. E also pray make Almighty Allah bless Nigerians, give […]

todayMarch 20, 2026 12

National

Tinubu Greet Muslims For Eid, Dey Ginger Dem To Dey Peaceful And United

By: Esther Ayoola Wi oga Presido Bola Tinubu don goodwill message for Muslims for Eid-el-Fitr on Friday, a wey mark end of Ramadan. Him drop dis message on Thursday through him spokesman, Bayo Onanuga, for Abuja. Baba Seyi say make Muslims use di festival reflect on di spiritual lessons of Ramadan like discipline, sacrifice, compassion, and devotion to God and humanity. Im con sti press tuk say dis kind reflection […]

todayMarch 20, 2026 12

National

Oluremi Tinubu Preach For Lambeth Palace

By; Esther Ayoola Naija First Lady, Oluremi Tinubu, don go preach wetin nor good for  Lambeth Palace on Thursday, as part of Naija first state visit to UK for almost forty years. She tuk say make people dey united and get faith, make dem listen to each other and respect everybody no matter who dem be or which God dem worship. She also share how she dey do daily spiritual […]

todayMarch 20, 2026 10

National

President Tinubu Insist Say Economic Hard Time Na Past Tense

By: Esther Ayoola Wi Oga Presido, Bola Tinubu say Naija economy don waka pass dat dark place wey confusion bin dey Gadima. Baba Seyi nor hold back telling Nigerians to keep di renew hope, say make dem vote am enter office for second term. Oga Presido tuk dis one for exhibition wey dem hold for United Kingdom during im two-day visit. E come sti promise say government go continue to […]

todayMarch 20, 2026 14

National

Tinubu Enter London To Naija Sign £746m Deal With Citibank To Fix Apapa Port

By: Esther Ayoola Wi Oga Presido Bola Ahmed Tinubu on Thursday for London joinbodi with Naija a Ministry of Finance, wey Wale Edun lead, sign £746 million deal with Citibank to upgrade ports for obodo Naija. Edun tuk say di agreement go help modernise Apapa Port and Tin Can Island Port, reduce congestion and make business move faster. According to gornment, dem do am to strengthen Naija trade, improve efficiency, […]

todayMarch 20, 2026 13

Lagos

Lagos Trade Fair Traders Beg FG To Stop Roadblocks, Taxes For Market

By: Esther Ayoola Traders for Lagos International Trade Fair Complex don wire call like dis to Federal Government to check all di wahala wey dey with roadblocks and taxes wey dey slow containers and goods for di market. Dem tuk say conventional security agencies and other bodies dey disturb trade, wey dey affect business growth. According to report, Di Minister of Industry, Trade and Investment visit di market for Lagos […]

todayMarch 20, 2026 20

Lagos

Lagos Police Commissioner Go Patrol To Guide Area For Eid El Celebration

By: Esther Ayoola Officers, dat is olokpa of di lagos police command don do join body patrol with Naija military to check mate every every for di Eid el fitr celebration. Say dis convoy sef na di commisoner of police Olohundare Jimoh ni lead di team enter some corners for Lagos on Thursday. For di police commissioner say, di major aim na to make sure say every wia dey safe […]

todayMarch 20, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds