Blog horizontal

Background

Sports

Rashford Dey Enjoy Barca, Wan Make Move Permanent

England winger Marcus Rashford don talk say e dey enjoy im football time for Barcelona, as di Catalan club get option to make im move permanent for £28 million, wey cheaper pass di £40 million Manchester United fit collect from oda buyers. Even though Rashford still get contract with United till 2028, e no dey see future for di club under Ruben Amorim. Report talk say di 27-year-old contract with […]

todayOctober 24, 2025 15

Lagos

Rights Group Fault Police Story On Killing Of Six Traders For Lagos

Di Centre for Human and Socio-Economic Rights (CHSR) don warn Nigeria Police Force make dem stop wetin e call planned wahala to twist di story wey happen for Owode-Onirin Motor Spare Parts Market on August 27, 2025, wey six traders take die. For press briefing wey happen for di market yesterday, CHSR president, Comrade Alex Omotehinse, talk say police dey push false gist wey go make people forget di victims […]

todayOctober 24, 2025 4

National

Mass Burial Don Go Down For Niger Fire Victims, Survivors Cash Out ₦10m

Di Niger State Government don do mass burial for di victims of di tanker explosion wey kill about 39 people and injure 60 others for Essan community, Katcha Local Government Area. Di Chief Press Secretary to di Governor, Bologi Ibrahim, yarn for statement on Thursday say di state don donate medical supplies worth ₦10 million to hospitals wey dey treat di injured people. He talk say di government team, led […]

todayOctober 24, 2025 14

National

Tinubu tell Amupitan: Make 2027 Polls Clean, Free From Wahala

President Bola Tinubu don charge di new INEC Chairman, Professor Joash Amupitan, make e prioritise transparency, credibility, and non-violence as Nigeria dey prepare for 2027 general elections. Tinubu yarn say credible elections na di foundation of public trust and democracy stability. E give Amupitan clear charge to protect di integrity of elections and INEC, starting with di Anambra governorship election for November 2025. Tinubu yan say Amupitan appointment, wey Senate […]

todayOctober 24, 2025 3

Lagos

Ritual Killings, Human Trafficking Dey Rise — LASG

Experts and African leaders don raise alarm say ritual killings and human trafficking dey rise sharply, and dem dey call for urgent united action to tackle wetin dem call growing continental crisis. Di alarm come during di first Annual Africa Colloquium Against Human Trafficking, wey Lagos State Ministry of Justice organise with Pepperdine University’s Sudreau Global Justice Institute. Speakers condemn how ritual abuse, sacrifice, and trafficking networks dey spread for […]

todayOctober 24, 2025 6

Lagos

Woman Don Bag One Year Jail For Tramadol Wahala For Lagos

Di Federal High Court for Lagos don sentence one 50-year-old woman, Halima Abdulahi, to one year for prison or make she pay ₦500,000 fine for illegal Tramadol matter. Justice Ibrahim Kala bin convict Halima after she talk say she guilty for di charge wey NDLEA carry go court. According to wetin dem talk, dem arrest di woman on October 2, 2025, for ECOWAS border post, Seme, Lagos, with 50 packets […]

todayOctober 24, 2025 23

National

Nnamdi Kanu Lawyers Don Waka Comot From Di Case

Kanu Agabi, former Attorney-General of di Federation and lead lawyer to Nnamdi Kanu, di detained leader of Indigenous People of Biafra (IPOB), don apply to withdraw from di ongoing terrorism trial for Federal High Court, Abuja. Kanu dey face seven-count charge wey Federal Government file against am over terrorism. When court sit on Thursday, Agabi tell di judge say him and him team no go represent Kanu again because di […]

todayOctober 23, 2025 11

Lagos

10 Food Items Wey Price Don Blow Pass For Lagos Dis 2025″

Food prices still dey heavy for Lagos people chest as cost of some important food tins don sharply jump from January to October 2025. Research on monthly food-price survey for big markets like Mile 12, Oyingbo, Daleko, and Mushin, show say plenty essential tins don almost double from start of year. Di survey dey happen every second week of di month. Market data show say tomatoes, fish, pepper, and beans […]

todayOctober 23, 2025 10

National

Why Police Arrest Omoyele Sowore

Di Nigeria Police don explain why dem arrest African Action Congress (AAC) 2023 presidential candidate, Omoyele Sowore, for Abuja. According to di Force Public Relations Officer, CSP Benjamin Hundeyin, Sowore dey accused say na him lead protesters enter restricted area for FCT, despite say court don already issue order wey no allow anybody go dia. Hundeyin talk dis one on Thursday for Abuja, as e explain say Sowore go face […]

todayOctober 23, 2025 9

Lagos

RRS Don Arrest Street Boys Wey Dey Harrass Motorists For Lagos

Rapid Response Squad (RRS) don arrest street boys wey dey harrass motorists for different Lagos areas. According to dia statement for X, on 9th October 2025, RRS do sting operation for three major spots, Old Toll Gate/Motorways (Ketu), Adeniji Adele (Third Mainland Bridge), and Ile Epo, and catch some bad boys wey dey disturb motorists with broken-down cars. Among dem, three suspects be ex-convicts: Kayode Sulaiman (30), Basiru Saheed (33), […]

todayOctober 23, 2025 11 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app