Blog masonry

Background

National

Edo Gorment React To Jaguda Boys Doings For Ekpoma

By: Esther Ayoola Edo State Governor, Monday Okpebholo, don condemn di attack wey hoodlums carry go Onojie of Ekpoma palace after dem hijack peaceful protest against kidnapping and insecurity for di area. Di protesters scata market, kill goats, beat cows, block major road and destroy parts of di palace, making businesses come standstill. Governor Okpebholo finally visit di palace on Monday and tuk say di violence no dey acceptable, dat gornment go take action to maintain peace for di area.

todayJanuary 13, 2026 6

National

Akwa Ibom Assembly Spoil Report, Say Dem Nor Get Plans To Jail Married Men

By: Esther Ayoola Akwa Ibom State House of Assembly don clear mata, say di social media report wey dey waka up and down, dat dem wan make law wey go jail women wey dey sleep with married men, na fat lie wey dey smell. Di Assembly tuk tuk put for statement on Monday, say di story wey come from one Facebook post by Obiavel Albert Abigo na fake news. Dem also clarify say di report wey claim Deputy Governor Senator […]

todayJanuary 13, 2026 14 1

National

President Tinubu Put Bodi For Climate Change Submit In Abu Dhabi

By: Esther Ayoola Say like dis wi oga Presido, Bola Tinubu don arrange bodi to tuk Naija mata for climate change and sustainability for Sustainability Summit wey dey sup for Abu Dhabi, UAE. Untop yanings with tori pipo, Minister of Foreign Affairs, Yusuf Tuggar tuk say Tinubu go yan with other world leaders about Nigeria climate plan and how we fit develop. Tuggar also tuk say, Oga presido go use di chance show say sustainability gats follow hand with climate […]

todayJanuary 13, 2026 15

Lagos

Lagos Court Kramp Man For Yahooing N60m Naira

By: Esther Ayoola Police for Zone 2 Lagos, don do jaki chan for one man wey dem name Israel Onen for Federal High Court over N60 million visa yahoo wey im do. Onen face four charges wey include conspiracy, fraud, money laundering, and stealing. Court hear say between 2024 and 2025, Onen joinbodi with some pipo wey sti dey on di run  collect N60 million from one innocent  Ayodele Emmanuel. Police tuk say Onen go leak Ayo ear,  pretend say […]

todayJanuary 13, 2026 7 4

Lagos

Akran Of Badagry, Oba De Wheno Menu-Toyi, Die For Age 89

By: Esther Ayoola Say nor be small badness sup for Badagry, dat De Akran of Badagry Kingdom, Oba De Wheno Menu-Toyi, don die for age 89 afta short sickness on Monday. Di respected king wey rule Badagry for almost 49 years na strong voice for Lagos State Council of Obas and Chiefs. Untop yanings with tori pipo, Lagos govo, Babajide Sanwo-Olu, tuk say im death na big loss to Badagry people, Lagos State and Nigeria because of di beta impact […]

todayJanuary 12, 2026 17 1029

National

Police Mehn Guide Kano State Gorment House

By: Esther Ayoola Say Security tie wrappa for Kano State Gornment House dat, oga govo,  Abba Yusuf dey make move to  defect go other party. Na so security mehn block di gate, combined security force  from di Nigeria Police Force and di Department of State Services (DSS) all of dem joinbodi for di location. According to report, if u must enter di gorment house, u must identify yaself, show ID card. Dis one sef dey follow speculation about a disagreement […]

todayJanuary 12, 2026 7

Lagos

Lagos Gorment Meet Doctors To End Strike

By: Esther Ayoola Di Lagos State Gornment say dem ma dey do everytin within dia power to resolve issues wey dey behind di ongoing strike by di Joint Health Sector Unions (JOHESU) in di state. Di Permanent Secretary, Lagos State Primary Healthcare Board, Ibrahim Mustafa, yarn dis one for interview on Sunday. Mustafa say, gornment sabi say problem dey for di health sector and dat, dem ma dey dialogue to restore normal operations across public health facilities. Im explain oh […]

todayJanuary 12, 2026 6

National

FG And ASUU Fix Date For Deal Signing, January 14

By: Esther Ayoola Federal Gornment and Academic Staff Union of Universities (ASUU) say dem go meet for conner on Wednesday, January 14, 2026, sign new agreement to improve university education and maintain stability across di obodo Nigeria. Ministry of Education tuk dis for statement released on Sunday, saying di ceremony go hold for TETFund Conference Hall, Maitama, Abuja. Di event go dey presided by Minister of Education, Dr. Maruf Alausa, and Minister of State for Education, Prof. Suwaiba Ahmad, and […]

todayJanuary 12, 2026 9

obodo oyinbo

Iran Tell Us: We Ready To Tuk, But No Go Accept Intimidation

By: Esther Ayoola Iran tuk say dem still dey communicate with America through Switzerland, even as protest and violence dey spread for di country. Iran foreign ministry tuk say dem ready for dialogue but no go accept any one-sided tuk or foreign interference. Untop yaning for us, President Trump confamate say, Iran call am to negotiate nuclear matter, while e still dey threaten strong action. Meanwhile, gornment don shut internet, warn people make dem no protest, as other countries condemn […]

todayJanuary 12, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app