Blog masonry

Background

Lagos

Lagos Dey Bag 16% Share Of Nigeria Informal Economy

Lagos State dey lead for Nigeria informal business waka as e carry 16% of all di informal businesses wey dey for di country, di same number wey North-East and South-East combine get. Dem talk say Lagos pass Ogun, FCT and Delta wey each get only 6%, while Taraba, Yobe, Kebbi and Zamfara manage just 1% each. Most of di businesses na for retail and services level, buying and selling things for market, salon work, tailoring, repairs and di rest. Retail […]

todayOctober 21, 2025 14

Lagos

LASU Don Open Biggest University Library For West Africa

Governor Babajide Sanwo-Olu, wey be di Visitor to Lagos State University (LASU), go unveil di university’s new library complex on Tuesday, October 21, 2025. Di library, wey dem name Babajide Olusola Sanwo-Olu Library Complex, na 4-storey structure wey get 350-seater library with plenty different sections. According to Juril Gawat, wey be di governor’s Senior Special Assistant on New Media, di complex carry 24-hour reading rooms, seminar halls, conference halls, administrative offices and many more. LASU don hail di library as […]

todayOctober 21, 2025 14

National

Na Dollar To Naira Exchange Rate Today Be Dis

Naira waka up and down on Tuesday as e trade mixed for both official and black market levels. For Central Bank of Nigeria (CBN) official rate and di Nigerian foreign exchange market (NFEM), dollar dey hover near ₦1,470 per $1. But for Lagos black market, dem dey buy dollar around ₦1,480 and sell am close to ₦1,495. For official window, mid-market USD/NGN dey between ₦1,468 and ₦1,470 based on recent data. But street rate still high, as demand no gree […]

todayOctober 21, 2025 12

National

Over 3,400 Don Die For Doad Crash In 2025 – FRSC

No less than 3,400 people don kpai for road accidents across Nigeria from January reach September 2025, na di Federal Road Safety Corps (FRSC) yarn dis one. According to Corps Marshal Shehu Mohammed, wey talk dis one for Abuja during di official launch of 2025 Ember Months Public Enlightenment Campaign, 3,433 people die and 22,162 people injure inside 6,858 reported crashes. Dem say driver wahala, like fatigue, overloading, carrying people for trailer, and travelling with fuel inside plastic container  na […]

todayOctober 21, 2025 8

International

Ex-French President Sarkozy Don Land For Jail Over Corrupt Waka

Ex-French president Nicolas Sarkozy don become di first former head of European Union country to enter jail, as dem carry am go La Santé prison for Paris on Tuesday. Sarkozy, wey rule France from 2007 to 2012, don dey face serious wahala since court find am guilty last month say he try collect campaign money from late Libyan dictator Muammar Gaddafi. Even as dem carry am enter prison, di 70-year-old still dey claim say him hands clean. For social media, […]

todayOctober 21, 2025 9

Sports

Nottingham Forest Don Name Sean Dyche As Third Coach 2025-26

Di Aussie coach chop sack just few minutes afta Chelsea knack Forest 3–0 on Saturday afternoon. Di club no waste time as dem sharply bring in Dyche to try rescue di season wey don dey scatter. Postecoglou own short and bitter 39-day stay no produce single win inside eight matches for all competitions. Na serious wahala as di poor results drag Forest go relegation zone and make dia fans vex well-well. Dem no smile at all as di team dey […]

todayOctober 21, 2025 7

Lagos

Lagos Pikin Dem Dey Compete For Inter-School Challenge

Pikin dem from different public primary schools for Lagos West jam for Methodist Primary School Hall, Oshodi, to compete for second stage of Sweet Thinkers Top 200 Academic Excellence Competition. Di contest test dem for Mathematics, English Language, and General Knowledge as part of plan wey wan promote better school work and make pikin dem like quality education again. Di organisers talk say di project dey follow Sustainable Development Goal 4 (Quality Education) and na way to improve how public […]

todayOctober 21, 2025 9

Lagos

Sanwo-Olu Don Open UNILAG Medical Research Centre

Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu, on Monday, open Sir Kensington Adebutu Medical Research Centre for College of Medicine, University of Lagos to boost medical innovation and improve health for Nigeria and beyond. Sanwo-Olu call am “intellectual investment” and true philanthropy wey go help human capital development. The new centre go be global hub for medical research, make university fit solve serious health problems. The governor praise donor Sir Kensington Adebutu for im generosity, and encourage other rich Nigerians to follow […]

todayOctober 21, 2025 7

Lagos

LASG Scatter N1bn Pension To 463 Retirees

Lagos State Government don scatter over N1bn pension to 463 retirees wey work for state civil service. N1,006,057,173.45 na di money wey dem put inside Retirement Savings Accounts for workers wey retire from civil service, local government, local council development areas, SUBEB, Teaching Service Commission, plus other state parastatals. For the 111th Retirement Bond Certificate Presentation for NECA Auditorium, Ikeja, Head of Service, Bode Agoro talk say dis show how Governor Babajide Sanwo-Olu dey serious about welfare of workers wey […]

todayOctober 21, 2025 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app