Blog masonry

Background

obodo oyinbo

China’s Zhejiang Province Call For Global Collabo To Boost Economy

By: Esther Ayoola Department of Foreign Affairs of China’s Zhejiang Provincial People’s Gornment, Prof Gu Jianxin say countries need to work together for stable economy instead of competition, as e go hellep world economy grow. Gu tuk dis one as dem dey do reception for journalists for Hangzhou wey come from different countries. Di journalists come from Zhejiang afta dem attend sessions about China 15th Five-Year Plan, especially cooperation for AI, agriculture, infrastructure and people exchange. Gu sti explain how […]

todayMarch 17, 2026 20

obodo oyinbo

UN Boss António Guterres Beg World Pipo To Stop Anti-Muslim Hate

By: Esther Ayoola UN Secretary-General António Guterres tok say make all countries join hand stop di rise of anti-Muslim hate. E tuk say fear and exclusion no suppose dey, from di way im dey see Muslims. Guterres also yarn say plenty Muslims dey suffer discrimination, marginalization, and unfair profiling every day. As Ramadan dey end, e call on gornment make dem protect equality and stop malice.

todayMarch 17, 2026 8

Lagos

Arewa Community For Lagos Beg Presido Tinubu To Con Settle APC Crisis For Lagos

Arewa Community, Lagos branch,  don wire sms give wi oga presido Bola Ahmed Tinubu  say make e con intervene over wetin dem call attempt to weaken di Northern Lagos branch structure inside All Progressives Congress ahead of di 2027 elections. Di petition, wey dia oga, Musa Saleh sign, say di Arewa Community structure for Lagos bin dey officially inaugurated for 2021 by President Tinubu. Say more than 200 members of di group on Monday visit di party secretariat for Ikeja […]

todayMarch 17, 2026 15

Lagos

Customs Seize 3,398 Cartons Of Codeine Syrup Worth N3.39bn For Apapa Port

Di Nigeria Customs Service Apapa Command say, dem don seize 3,398 cartons of codeine syrup wey smugglers hide inside household utensils for Apapa Port, Lagos, worth about N3.39 billion. According to di command tuk, tuk, Isa Sulaiman, di interception hapun on Sunday, after customs officers carry out quick follow-up operation. Sulaiman quote di Customs Area Controller, Emmanuel Oshoba, say di operation na success through joint work with di National Drug Law Enforcement Agency. Oshoba say di seizure show di command […]

todayMarch 17, 2026 10

Sports

Ikorodu City Shock Rivers United, Win 1-0 for Lagos

By: Esther Ayoola Ikorodu City don shock everybody as dem beat Rivers United 1-0 for Mobolaji Johnson Arena, Lagos, on Monday. First half no  goal, but both teams try score sha. Rivers United wey everybody dey reason say dem go win di league no fit break Ikorodu defence. Na For di 52nd minute, substitute Folarin Temitope score from rebound wey goalkeeper Rashid Owolabi no fit hold after Salami Farouk try shot, ni settle di tie.

todayMarch 17, 2026 15

Sports

D’Tigress Finally Collect Dia Rewards Afta Afrobasket 2025 Win

By: Esther Ayoola Naija gornment don finally give D’Tigress wetin dem promise afta dem win FIBA Women’s AfroBasket 2025 for Côte d’Ivoire. Dem don collect dia national honour certificate and housing documents as reward. Di presentation hapun for Lyon, France, as dem dey play FIBA Women’s World Cup Qualifiers. Say Each player also carry $100,000 plus flat and the Order of di Niger (OON) wey Presido, Bola Tinubu promise since August 4, 2025.

todayMarch 17, 2026 9

Sports

Real Madrid & PSG Eye Victor Osimhen for Summer Transfer Move

By: Esther Ayoola Real Madrid and Paris Saint-Germain dey watch Victor Osimhen for possible transfer dis summer. Turkish journalist Ali Naci Küçük tuk dis one on Monday, say Real Madrid don put Osimhen and Erling Haaland for their transfer list. E sti press tuk say senior men from Real Madrid and PSG even enter Rams Park last Tuesday to watch Osimhen when Galatasaray play Liverpool for UEFA Champions League. Real Madrid don dey follow Osimhen, especially as some of dia […]

todayMarch 17, 2026 17

Sports

DR Congo Ready For 2026 World Cup Play-Off

By: Esther Ayoola Sébastien Desabre, coach of DR Congo national football team, say like dis im boys don dey jim bodi for dia 2026 FIFA World Cup intercontinental play-off. Say Dem go travel to Mexico, play for Guadalajara and Monterrey, join other five countries wey dey fight for di last two spots. DR Congo, wey beat Naija 4–3 on penalties for African play-off final, go face di winner between Jamaica and New Caledonia. Desabre hope be say im fit carry […]

todayMarch 17, 2026 17

Lagos

Deputy Governor Hamzat Tell Civil Servants To Learn Work Well

Lagos State Deputy Governor, Dr Obafemi Hamzat, don call on civil servants to show honesty, care, and professionalism. E tuk dis one on Monday for di 60th birthday and retirement thanksgiving service of Permanent Secretary for Office of Deputy Governor, Mobolaji Daba for Chapel of Christ the Light, Alausa-Ikeja. Hamzat say e important, make civil servants sabi dia work, responsibilities, system, protocols, and wetin e need to serve public well. Im advise dem to dey serious, follow rules, and understand […]

todayMarch 17, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds