Blog masonry

Background

National

Ogun Police Cut Chain For Tiktoker Say She Deceive Members Of Di Public

By: Esther Ayoola Ogun State Police command don plan to arrest one female TikTok user wey dem sabi as Mirabel afta investigation proof she lie say person rape her. Nor be amebo say, Mirabel tuk for one viral phone chat with social media influencer, VeryDarkMan (VDM) of how one man rape her. Say na only she implicate herself, tell VDM for audio call say, di claim na lie, For di audio wey VDM share online, she admit say some part […]

todayFebruary 20, 2026 4

Lagos

LAWMA to Recruit 300 Pipo To Make Lagos Streets Clean

By: Esther Ayoola Di Lagos State Waste Management Authority (LAWMA) don announce say dem go employ 300 pipo wey go dey make sure say Lagos streets dey clean. LAWMA MD, Dr Olumuyiwa Gbadegesin, tuk dis one during a visit to one ogbonge news house for Lagos. Gbadegesin sey, dem go sha train di people, den di LAWMA pipo, go con train Lagosians on how to handle waste, and anybodi wey no follow, go suffer am beta style.

todayFebruary 20, 2026 8

Lagos

Education Stakeholders Call Gorment To Arrange Lagos Future

By: Esther Ayoola Education pipo for Lagos on Thursday don clear gorment dia mind, say dem need sharp doings, inclusion, teacher training, correct data and beta action plans to build strong education system. Dem tuk dis one for 2026 Lagos State Education Stakeholders panel wey Ministry of Basic and Secondary Education package. Different partners like UNICEF, British Council, SKLD and New Globe show face for di programme, as dem press charge  say, teachers need beta training, and  recognition.

todayFebruary 20, 2026 6

Lagos

LASEMA Warn Drivers Afta Two Pipo Kpai For Trucks Askident

By: Esther Ayoola Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) like dis now, dey vex oh, dey, warn drivers to stop wawawa driving asap, afta two pipo kpai for askident wey hapun Thursday morning for Cele Bus Stop, Apapa-Oshodi Expressway. Untop yarnings with tori pipo, LASEMA Permanent Secretary, Dr Olufemi Oke-Osanyintolu, say, di  two 40-foot container trucks wey nor get  plate number,  collide, jam di other one wey park on im own. Oga Olufemi say, na beg im take dey beg […]

todayFebruary 20, 2026 5

Lagos

Babajide Sanwo-Olu Cleartruck Owners To Avoid Drunk Drivers

By: Esther Ayoola Oga govo, Babajide Sanwo-Olu don sama beta warning to truck and cargo motor owners, say make dem nor dey give dia motor to drunk drivers. Sanwo Olu, make am clear say, any driver wey dem catch on hard drugs go get am hot, hot from di state gorment. U sabi say, na About 1,000 officers of National Drug Law Enforcement Agency Lagos State Command, don benefit from di governor free eye care program to hellep dem stay […]

todayFebruary 20, 2026 5

obodo oyinbo

Underage Pikin Dem Full Instagram – Zuckerberg Yarn

Meta oga Mark Zuckerberg don bow head small, talk say dem slow well-well to fish out underage pikin wey full Instagram, as e stand trial for California. Families for America dey accuse Meta say dem knowingly hook children and no block those under 13 sharp sharp. Zuckerberg admit say dem don upgrade dia system, but confess say dem for move faster pass wetin dem do. Na im be di hottest witness for the case, as plenty parents drag social media […]

todayFebruary 19, 2026 5

OBODO NAIJA

Every Vote Go Count – Akpabio

Senate Presido, Godswill Akpabio don yarn say di new Amendment Electoral Act 2026 wey Presido Bola Tinubu sign go make every Nigerian vote matter. Akpabio talk say di law go stop di gbege wey dey happen when results dey waka from polling units go collation centres. E still yarn say e go fix di wahala wey Nigerians dey fear about election palava, make future elections clean and correct, say Nigerians go enjoy better election.

todayFebruary 19, 2026 9 4

Lagos

Sanwo-Olu Charge New LSSTF Board Make Dem Revive Sports

Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu don yarn make di new Lagos State Sports Trust Fund (LSSTF) board use all resources waka push grassroots, school sports, and other sporting waka for Lagos. Di board dey led by Enitan Oshodi wey be former Sports Commissioner and ITTF Africa oga, Olaposi Agunbiade na Executive Secretary/CEO. Others like Olabode Agoro, Adeniyi Adekoya, Gbolahan Onibuje and di rest go join body make sports shine. Sanwo-Olu talk say dem gats use their brain, contacts and experience […]

todayFebruary 19, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app