Blog no sidebar

Background

obodo oyinbo

UN Beg World Pipo to Bring $296m To Help Venezuela Earthquake victims

By Oluwatosin Ibrahim Di United Nations like dis now don dey beg for 296 million dollars to support Venezuela based on di  deadly earthquake  wey go kpai l more than 3,600 people and leave thousands homeless and missing. UN humanitarian chief, Tom Fletcher, say although donors don already contribute about 300 million dollars, dem still need more  attention to help 1.3 million people within di next six months. Venezuela Foreign […]

todayJuly 9, 2026 11

Lagos

Lagos Lawmakers back state police creation law

By Oluwatosin Ibrahim Lagos State House of Assembly don throway dia full support behind plan to create state police. Speaker Mudashiru Obasa porporly dis mata on Wednesday for plenary, say di  move smart move against  kidnappers, terrorism, banditry and other security wahala for Nigeria. Di senior man speaker con sti  insist say state gornments suppose get full control over how dem go recruit officers, appoint Commissioners of Police and run […]

todayJuly 9, 2026 13

Articles

LAGOS POLICE ARREST 135 SUSPECTED CULTISTS, VEHICLES WITHOUT PLATE NUMBERS

Lagos State Police Command don send strong warning to youths wey still dey see cultism as achievement instead of shame after them arrest 135 suspected cultist for different part of lagos on Monday night wey dem believe say gather because of cult initiation. Police say all di suspects wey dem parade no be people wey dem carry from dia bedroom. According to dem, na during coordinated raids for different black […]

todayJuly 8, 2026 11

OBODO NAIJA

Tension Dey For Ojoo Area of Ibadan

Tension don rise for Ojoo area of Ibadan, Oyo State, after clash burst out between some groups of residents on Wednesday. According to reports, di fight involve people wey dem say come from Yoruba and Hausa communities, although authorities never officially konfamate wetin really happen as at di time of dis report. Officials of Operation Burst, di joint security outfit for Oyo State, don reportedly near di area to restore […]

todayJuly 8, 2026 10

Sports

Zeki Amdouni Fit Retire From Professional Football Dis Week

Switzerland star, Zeki Amdouni, don yarn say he fit retire from professional football once he face Lionel Messi for FIFA World Cup. He yarn dis one for him Snapchat on Tuesday after Switzerland beat Columbia. Amdouni joke say after di match, he go just end im football career. Argentina wey be defending champions go jam Switzerland for quarter-final later this week.  

todayJuly 8, 2026 24

OBODO NAIJA

 Naija Senate Clear Im State Assemblies Why Dem Need Pass State Police Law

By : Jolayemi Olajide Di National Assembly dontigthen every every as e take concern security for obodo Nigeria, say make all di 36 State Houses of Assembly to quick-quick approve di bill for state police. Dis move follow di efforts wey oga Presido Bola Ahmed Tinubu make to spread policing power to hellep fight jaguda boys Di lawmaker press yans, say true, true, Nigeria need state policing. Senate come commend […]

todayJuly 8, 2026 10

OBODO NAIJA

News House of Representatives scata as lawmakers clash to summon President Tinubu

By : Jolayemi Olajide Di House of Representatives bin turn to warzone on Wednesday after lawmakers quarrel sake of one motion wey dey ask make President Bola Ahmed Tinubu come explain him side for di Green Chamber. Benedict Etanabene wey be lawmaker for Delta State bin raise di issue because of one circular wey di Accountant-General Shamseldeen Ogunjimi send out on June 29. Etanabene argue say di matter too serious […]

todayJuly 8, 2026 9

Sports

Former Eagles captain Ekong confess say Watching World Cup for TV dey pain body

By Oluwatosin Ibrahim Former Super Eagles captain William Troost-Ekong don drop bumbshell  shame wear am agbada, and caftan as super eagles nor qualify for di world cup. Im yarn dis one during one media tuk, tuk on tuesday for social media post. Ekong explain say normally, Super Eagles na di akpormiemie of any international competition and, as dem nor go dis one, say di world cup nor too sweet.  

todayJuly 8, 2026 44 11

OBODO NAIJA

Wike Camp, Turaki Camp Wait as Court Shift PDP Case 

By Oluwatosin Ibrahim Federal high court judge, Justice Salim Ibrahim don shift judgment for di PDP leadership mata to July 10 to decide who be di authentic leaders of di party between Nyesom Wike camp and di interim National Working Committee wey Tanimu Turaki lead. Di court also move hearing for appeal wey ADC, Accord and three oda political parties file against dia deregistration go July 14. Senator Adolphus Wabara […]

todayJuly 8, 2026 12 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds